14-04-2025
Di kasala between Portable and Fuji star Saheed Osupa as police gbab ZaZoo singer
Controversial Nigerian Afrobeat musician, Habeeb Okikiola wey pipo sabi as Portable don enta anoda stage of wahala again but dis time na wit ogbonge singer Okunola Saheed wey dem sabi as Saheed Osupa.
Dis no be di first time Portable go dey enta gbege for police hand but dis one come wit serious allegations wey dem sama am.
Kwara State Police Command say dem receive petition against Portable and dem no waste time to gbab am and put am for dia custody.
Wen oda celebrities dey sleep wit dia two eyes, police don gbab Portable put behind bars to come clear imsef for di petition wey ogbonge musician Saheed Osupa sama am.
Saheed Osupa na ogbonge Fuji musician for Nigeria and e dey well known for im songs and ways of passing information wit im music.
Recently, we see viral video of Portable wia e dey tok say make nobody use police carry am becos imsef na star and im no go run for anybody.
For di video wia e speak Yoruba language, e dey refer to one pesin for di video and dey warn say make nothing do am becos imsef get fans too.
Di Kwara State Police Command tell di public say dem receive a petition from Saheed Osupa against Portable and dem sharply take lawful steps 'in line wit due process to investigate di allegations.'
Wetin dey inside di petition?
According to police tok tok pesin SP Adetoun Ejire-Adeyemi, etok say di petition dey surround serious allegations wey even include threat to life.
Dem add say Portable also use insulting words and di pesin wey submit di petition bin submit
"Di petition border on serious allegations wey include criminal defamation, threat to life, incitement, character assassination, conduct likely to cause a breach of peace and di use of abusive and insulting words."
Howeva, bifor dem gba Portable, police say dem get a valid arrest warrant from a Magistrate court wey dey Ilorin.
"Acting on dis warrant, operatives from di Command proceed to Abeokuta, Ogun State, on Saturday, 13th April 2025, wia dem catch di suspect. We immediately bring am to Ilorin for further investigations," police tok.
Wia Portable dey?
From one video wey we see wey go viral, we see wia dem carry Portable for inside one car and e tok say na police from Kwara bin carry am.
As di police confam say dem carry Portable for investigation, dem add say e dey custody until dem charge am to court.
"Upon im arrival, dem take suspect statement for di presence of legal representatives from both parties. E dey currently for custody and wey dey make arrangements to charge am to court without delay."
Police add say dem go treat di matter wit fairness and make nobody spread fake information.
Bifor, Portable don tok say im get mental problem and e dey dey undergo treatment for Federal Neuropsychiatric Hospital, Aro, Abeokuta.
E beg Nigerians and govment of Ogun state for social media say make dem help am.
Dem don declare police wanted bifor sake of alleged assault on govment officials.
"I fear govment. I be federal govment liability. Den I be madman; I get medications wey I usually take. You fit confam from Aro Hospital. I get card wey certify me as one of dia patients, di singer tok dat time.
Now, Portable dey face anoda wahala and e dey clear say e go face court.
Oda times Portable name don trend
Around March, 2023 Nigeria Police Force bin condemn di actions of Portable for inside one video wey go viral. Police say Portable bin exhibit irrational behaviour and dey throw insults at police officers wey dey carry out dia legal duty.
For June last year, Ogun state police bin order Portable di 'Zazu' crooner to report to dia office or dem go declare am wanted.
Di reason na sake of one trending video wia Portable allegedly oda im boys to beat up one boy and give am injury.
For anoda video wey trend around dat time, pipo sight Portable wia e dey do hot argument and almost begin cry. Di short video be like incident wey go lead to fight.
Anoda one, be wen di Zazu crooner call out Grammy award winner Burna Boy say e dey copy some of im styles. For im Instagram handle, Portable tell Burna say make dem collabo, say e no go good for di Grammy award winner to rip am off.
Portable dey notorious for being outspoken and fit dey careless for some of im comments.