04-08-2025
US govment list wetin foreign students go do to make dem lose dia visa and future eligibility
Di govment of di United States of America don cut warning give international students say dem fit cancel dia students visa if dem leave dia program of study and dem no tell dia school.
US govment say any student wey dey study for dia kontri and dem miss class witout informing dia school, dem go cancel dia future visa eligibility.
Dis na according to di new announcement by di US Mission for Nigeria on Monday 4 August 2025.
Dis dey come as di US say dia reduction in validity na part of ongoing global review of di use of US visas by oda kontris.
"If you drop out, skip classes, or comot your program of study wey you no inform your school, your student visa fit dey cancelled.
"You fit lose eligibility for future U.S. visas," US Mission for Nigeria tok for dia X post.
Dem warn students make dem obey di terms of visa and maintain dia student status so dem no go get any issues.
Recently di United States Mission for Nigeria for one statement bin announce sweeping changes to dia non-immigrant visa policy for Nigeria, wey reduce di duration and conditions under wey most Nigerian travellers go fit enta America.
For years, di US dey issue Nigerians wit 5-year visitor visas and 2-year student visas, even though Nigeria dey only offer single-entry visas valid for three months only for those wey dey plan to visit di kontri from US.
Also, di US don previously tok say Nigerians and oda foreigners wey dey plan or already dey U.S, make dem no overstay dia visa ro dem go face serious wahal.
"If you remain for di United States beyond your authorized period of stay, you fit be deported and fit face a permanent ban on traveling to di United States for di future" di Embassy take tok.
Meanwhile, di Nigeria Immigration Service (NIS) tell Nigerians make dem use dia U.S. visas responsibly and make dem no pass dia boundary.
Di tok tok pesin for di Nigeria immigration, Akinsola Akinlabi, say Nigerians wey dey hold U.S. visas gatz obey di terms and conditions under wey dia visas dey granted.
"Make all visa holders dey advised to strictly keep to di purpose wey dey stated for dia visa applications."
"U.S. authorities dey conduct security screening beyond di initial point of entry into di kontri. Any breach of immigration or oda laws fit lead to visa revocation or deportation."
All dis warning na for anybodi wey dey plan go America weda na for school, business, waka, or any oda reason, to dey careful and obey wetin dey dia visa application.
Why US fit cancel your visa