logo
Goment deny scrapping of JSS and SSS – but wetin be 12-year basic education dem dey propose?

Goment deny scrapping of JSS and SSS – but wetin be 12-year basic education dem dey propose?

BBC News07-02-2025

Nigeria goment say no be true say dem wan scrap di Junior Secondary School (JSS) and di Senior Secondary School (SSS).
Dis dey come afta Nigeria goment through di Minister of Education, Tunji Alausa bin propose twelve years of basic education on Thursday for di Extraordinary National Council of Education (NCE) meeting for Abuja, Nigeria capital.
For statement wey di tok-tok pesin for di Federal Ministry of Education, Folashade Boriowo bring out on Friday, di ministry tok say dem just present di proposal for discussion, no be say e go happun sharp-sharp.
Di ministry describe di tori say Nigeria goment don scrap JSS and SSS as misleading.
"Tori wey suggest say di Federal Goment don scrap Junior Secondary School (JSS) and Senior Secondary School (SSS) and replace dem wit a new 12-year uninterrupted basic education model no be true. We wish to categorically tok say dis no be true,"
Di statement add say "Di proposal dey seek to move to 12 years of compulsory education but we go still keep di current 6-3-3 structure,"
According to di tok-tok pesin for di ministry, di aim of di proposal na to remove di barriers wey dey between JSS and SSS.
Dem tok say e go allow "a smooth transition of students witout di challenge of any external assessment at any stage. Howeva, e still be subject of consultation and deliberation".
Di ministry say dem go still do tok-tok wit stakeholders bifor dem go make final decision on di proposal.
"Di final decision on weda to adopt dis reform or not go happun for October 2025 National Council on Education Meeting." di statement conclude.
For August 2024, di former Minister of Education for Nigeria Tahir Mamman bin bring a similar policy.
Im bin announce say dem no go allow underage candidates write di Senior Secondary School Certificate Examinations (SSCE).
E bin mean say if any pikin age no reach di approved age limit dem no go qualify to write di West African Examinations Council (Waec) and di National Examinations Council (Neco).
Dis two regional and national exams na one of di basic requirements students need to enta higher institutions.
Dem must present results and certificates to show say dem graduate true-true from secondary school.
Im bin also add say di age limit for any candidate to write di Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) wey di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) dey organise na still 18 years.
"Na 18 years. Wetin we do for di meeting wey we bin get wit Jamb na to allow dis year and for am to serve as a kind of notice for parents say dis year, Jamb go admit students wey dey below di age but from next year, Jamb go insist say anybodi wey dey apply to go university for Nigeria go meet di required age wey be 18."
But dis policy no even start to work before dem comot am from office.
Howeva, some education experts say na beta policy e be to allow di children mature, even though parents bin no agree wit di policy.
Experts tok say di 9-3-4 system of education dey good to prepare students ahead of tertiary institution.
Nigeria goment still get time till October to do dia tok-tok and explain wetin di 12 years of uninterrupted basic educational system really mean.
Dis becos in reality even di Junior Secondary School Examination wey di West Africa Examination Council dey organise no dey strong like bifor.

Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

WAEC explain why students write exam for night, toI sorry as parents react
WAEC explain why students write exam for night, toI sorry as parents react

BBC News

time29-05-2025

  • BBC News

WAEC explain why students write exam for night, toI sorry as parents react

Parents of students wey write di English Language paper 2 essay exam for di ongoing West Africa Examination Council WAEC examination late into di night on Wednesday 28 May, 2025 say dem no happy with dis development. Some of di ones wey tok to BBC Pidgin say dem dey sad say di children suffer like dat to write exam of an important paper like English language so late at night, for exam dem suppose don finish since afternoon. Joshua Rogers wey im daughter dey write di WAEC exam tell BBC Pidgin say na around 9:00pm late Wednesday night, e go pick her after she finish her paper. E say she tell am say na since 2pm in di afternoon dem finish di first paper wey be English Languahe paper 1 objective and dem come dey wait for di second paper but e no come till around 5:00pm in di evening. 'Di school wia she dey write di exam also try to give us parents information say dem dey wait for dI second paper but wen night reach na im me and my wife go her school go wait for her to finish so we go bring her back. No be good experience for a young pesin like dat. E dey too stressful," e tok. Rogers add say coming from di drama around di just concluded JAMB exams wey make di authorities organise anoda exam for some candidates to rewrite di exams, e feel say dis incident fit negatively affect di performance of di students for di exams as many of dem write di exam with tension so dem fit write am quick-quick so dem go go house as night don fall. "I get serious concern for di performance of di students for dis particular exams becos dem write am under tension, especially as you know say English paper na compulsory subject. You can imagine di stress wey students dey go through for exam time, kon be di one wey dem get to wait a very long time, way into di night. So some of dem write quick quick so dem fit go house and e fit affect dia results at di end." E also express concern for di safety of di children especially for di ones wey live very far from school. "E get one boy wey me and my wife get to carry go house becos e dey live very far from di school. My daughter school dey Ozuoba and dis boy dey live for Port Harcourt airport side, so you can imagine di distance, and e bin dey fear to go house by dat time of di night becos of how di area be. Thank God say e speak out. Wat of di children wey no get anybody to help dem and dem must go house dat late in di night? Goment must chook eye and ask question why dis one happen and take steps make e no happen again." 'Our students finish di exams 1:00am dis morning' For students wey write di WAEC exam for some of di riverine communities for Rivers State, di exam papers get to dem by 10:00pm. Andrew Peter wey im pikin write di WAEC exam for Community Secondary School CSS Ebukuma, Andoni LGA, say di exam paper reach dem by 10:00pm and di students finish di exams by 1:00am early morning of Thursday 29 May, 2025. "We really no know wetin happen. Na WAEC go explain but di exam paper reach here by 10pm last night. We get to go buy candles for di students to take write di exam becos for di whole of Ebukuma community, we no get light. Na around 1:00am dis morning na im dem finish di exam and dem get to come back again dis morning to write anoda paper. So e dey stressful for di students. Dem no suppose suffer like dat." E tok. WAEC explain why di English language paper 2 essay exam happen like dat Di West African Examinations Council (WAEC) for statement don apologise to students for di delay in di exams. Dem acknowledge say dem get some challenges during di conduct of WASSCE for School Candidate, 2025 wey include delay in di timely conduct of English Language Paper 2 dem write on Wednesday 28 May, 2025. For statement wey Moyosola Adesina, Acting Head of Public Affairs WAEC sign, dem say while dem maintain di integrity and security of di examination, dem face some challenges primarily due to dia major aim of preventing leakage of any paper. 'While we successfully achieve our objective, e impact di timeliness and seamless conduct of di examination. Despite our best efforts, we encounter logistical hurdles, security concerns and sociocultural factors wey negatively influence our operations.' In order to forestall future occurrences of dis nature, di Council say dem currently dey collaborate with security agencies as dem recognise di importance of timely conduct of examinations and di impact of dis decision on di candidates, dia schools and parents, and dem sincerely apologise for any inconvenience wey e cause.

Nigerian students dey find Universities wey dey accept low cut-off mark
Nigerian students dey find Universities wey dey accept low cut-off mark

BBC News

time20-05-2025

  • BBC News

Nigerian students dey find Universities wey dey accept low cut-off mark

Secondary school leavers for Nigeria dey search for universities wey fit accept low Jamb cutoff marks for dis year admission, sake of wetin Jamb take students eye see for dia 2025 University Tertiary Matriculation Examination (UTME). Jamb na di Joint Admissions and Matriculation Board - di exam body wey dey in charge of organising exams for young school leavers for Nigeria wey dem go take enter university, polytechnic, college of education and oda tertiary institutions. Dis 2025 Jamb exam bin record very low marks across di board according to one analysis of di results wey di exam body bin release. Almost two million students bin write di exam dis year, but na about 12,400 of dem score 300 marks. However, Jamb later agree say dia system bin get problem and dat na di reason for di mass failure. Dia oga kpatakpata, Ishaq Oloyede even cry for national TV as e dey apologise to Nigerians for di error. Dem also organise anoda exam for di affected students and di exam resits go conclude dis Tuesday as tori be say di result fit come out on Wednesday. Normally, if pesin get up to 200 for Jamb, dem dey consider am as pass mark, though some universities fit admit pipo wey score 180 for some courses. But recently, sake of di increasing poor performance by students, some universities don bring dia requirement down to 150 Jamb and rumours dey fly say di score go even dey lower dis year. One staff of Abia State University, for southeast Nigeria tell BBC Pidgin say di school neva announce wetin dia cutoff mark go be bicos Jamb exam still dey go on, "but I no expect say e go dey lower dan 140", she tok. Another staff of Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu University, wey im former name na Anambra State University tell our tori pesin say "di university no go accept any jamb score below 150 for courses wey no relate to medicine and law". Similarly, one staff of Sokoto State University, Malam Muazu, tok say "e dey too early for di university do decide wetin dis year cutoff mark go be, especially since Jamb neva even conclude di exams". Di oga wey plead anonymity say di university go get dia policy meeting for August to decide, and by dat time Jamb go don also brief dem officially on wetin to do, but for last year, dia cut off mark na 140. Brief background on JAMB result for recent years For 2022 UTME, Jamb announce say, 378,639 candidates score above 200, 520,596 score 190 and above, while 704,991 score 180 and above. Also, 934,103 score 170 and above and 1,192,057 score 160 and above. For 2024, a total of 1,904,189 candidates sit down for UTME. 1,989,668 register for di exam, wey be 24.7% higher dan di figure for 2023. According to Jamb, out of di 1,842,464 results wey dem release, only 0.4 percent score above 300, while 24 percent score 50 percent (200/400) and above. As dem see dis kain low scores since for 2019 UTME, Jamb and institutions come conclude say make dem reduce and approve national minimum cut-off mark of 160 for university admission for Nigeria. Again for 2022/2023 admission session, Jamb come set di general cut-off mark for universities at 140 and above, as dem see say candidates underperform dat year again. And for dis year data, Jamb show say out of 1.5 million candidates wey write di exam, over 50 percent score below 200 for this year exam. Some universities wey fit accept low jamb scores Based on wetin bin don happen bifor and interview wit staff and students of some tertiary institutions for Nigeria, here na schools wey fit accept low jamb scores, Abia State University (ABSU) Uturu - 140 Ebonyi State University - 140 Ekiti State University - 140 Delta State University - 140 Federal University Gashua - Yobe State - 140 Kingsley Ozumba Mbadiwe University, Imo State - 140 Chukwuemeka Odumegwu Ojukwu University, Anambra State - 150 Sokoto State University - 140 Usmanu Danfodiyo University Sokoto - 140 Benue State University Makurdi - 150 For Polytechnics: Akanu Ibiam Federal Polytechnic - Ebonyi State - 100 Delta State Polytechnic - 100 Kano State Polytechnic - 100 Federal Polytechnic Ede - Osun State - 120 Federal Polytechnic Ayede - Oyo State - 120

Five tins wey happun for di 2025 UTME Jamb exam
Five tins wey happun for di 2025 UTME Jamb exam

BBC News

time15-05-2025

  • BBC News

Five tins wey happun for di 2025 UTME Jamb exam

Since di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) confam say true-true errors bin happun for di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME), pipo still dey ask wetin really happun? Candidates bin write di examination across di kontri between Friday 25 April and end on 5 May. Wen Jamb release breakdown of how di 2025 results be, di examination body say dem record di lowest performance in di history of di Computer Based Test [CBT]. According to Jamb, na about 1,955,069 candidates bin write di 2025 UTME examination. Out of dat candidates, ova 50 per cent score below 200. Na only 4,756 candidates score 320 and above, while 12,414 candidates score 300 and above, according to Jamb analysis. "As part of di results, 40,247 underage candidates dey permitted to demonstrate dia exceptional abilities. Howeva, only 467 of dis candidates (1.16%) bin achieve scores wey meet di point for exceptional ability as defined for di UTME, wit dia performance for di subsequent three stages still pending," Jamb tok. Dis results bin no sweet di belle of candidates, dia parents and guardians, plus oda pipo wey dey concerned about education for Nigeria. Dem begin drag Jamb for social media, sotay pipo begin ask kwesions about why students dey underperform wey force di body to do dia review sharp-sharp. Jamb make promise say if dem chook eye for dis complaints and find out say errors bin dey, di candidates wey dey involved go rewrite di exam. Wetin be di technical errors wey happun According to Jamb some errors bin happun for some centres wey affect di performance of candidates during di exam. Jamb Registrar, Prof Ishaq Oloyede tok for media briefing for Abuja on Wednesday say "Wetin suppose be moment of joy don change due to one or two errors." Di Registrar announce say di technical error affect about 379,997 candidates. "We apologise and assure you say dis incident represent a significant setback for… we remain committed to emerge stronger in our core values of transparency, fairness and equity", Oloyede tok as e cry wen e address tori pipo. E add say na di function of di exam bodi to admit error sake of say dem sabi say inspite of dia efforts dem no dey perfect. Some of di errors wey happun include: According to one post wey di Educare Tech Team - di team wey chook eye for Jamb core system to check wetin bin happun during di exams share for social media, breakdown di errors. Dem say one of di "most critical discoveries" wey dem bin make during di session dey around three major systemic changes wey dem introduce for di 2025 UTME. Shift from traditional count based analysis: Jamb change from di traditional count-based analysis to a more robust source-based analysis of results. Dem explain say before-before, Jamb dey evaluate di integrity of examination sessions primarily by counting di number of responses wey dem submit per session. If di majority of candidates in a session of 250 bin submit a near-complete set of answers, di session dey valid. Any significant deviation go lead to disqualification of results from dat centre. However, for 2025, dem use a more advanced model—wey go focus on di actual source and logic of di answers dem provide, instead of just di quantity. Full-scale shuffling of both kwesions and answer options: Dis process na to make sure say if two candidates dey siddon for di same session dem no go get identical questions and answers. Dis na to improve di security of di test. Systemic improvements: Jamb do plenti systemic improvements wey go improve performance and reducing lag (dragging) during exam sessions. According to di document, dis na a major policy change wey bring di best and highest UTME score in 15 years. Dem say na dis technological improvements wey dey really good on paper, cause di major wahala during di implementation phase. "Di system patch necessary to support both shuffling and source-based validation bin dey fully deployed on di server cluster wey dey support di KAD (Kaduna) zone, but dem bin no apply am to di LAG (Lagos) cluster, wey dey service centres for Lagos and di South-East. Dis omission happun across all sessions until di 17th session, na later dem discover and korect di error." na wetin engineer James Nnanyelugo submit to di Educare team. Jamb also assure Nigerians say dis kain tin no go happun again as dem reschedule di exam for Friday 16th and Saturday 17th May, 2025 'Anoda pesin profile and kwesions appear for my screen' - Jamb candidate Some candidates wey be victims of dis technical errors share dia experience wit di BBC. Dem tell BBC wetin happun for di examination centres. "I bin log into almost three computers, but dem kontinu to reject my login, wen I finally get di chance to log in, before I go even read di questions, time don finish. For my centre na me be di only pesin wit dis issue. Wen I bin start to try ansa di questions, di computer just start to dey go on and off due to technical issues. I bin complain but dem tell me to manage am like dat, afta somtime my profile just disappear from di system and anoda pesin profile appear." Di candidate add say di questions of di oda pesin show for di screen too, afta somtime e kon go off completely. "Wen my computer go off, e no affect only me, e bin affect majority of di students dia. E bin take somtime before dey solve all di issues and evritin come dey stable again. At di end I no fit answer all di question wen dem tell us say our time don finish becos I waste plenti time sake of di technical difficulties wey I face." Di story no different from anoda female candidate wey tok say her computer begin go off and on wen she start to write di exam. "My computer go off like 3 times, den I realise say oda students bin dey also face di same issue. Di result of di exams shock us, some of us pass on an average, but we no get wetin we bin hope for. We bin study veri hard but den di technical issues from di computers affect our results." She tok. Hastags of #thisisnotmyresult bin dey trend as candidates use am express dia frustrations. We no go quantify di impact wey dis technical glitch get on candidates but we fit report say one candidate take her life afta she see har Jamb result.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store