logo
Wetin to expect as Nnamdi Kanu terrorism trial begin afresh today

Wetin to expect as Nnamdi Kanu terrorism trial begin afresh today

BBC News21-03-2025

Di trial of Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob) go start afresh dis Friday for di Federal High Court in Abuja, one of im lawyers don confam to BBC.
Na Justice James Omotosho go dey in charge of dis case now, afta Nnamdi Kanu ask Justice Binta Nyako to withdraw hersef from di matter wen Kanu accuse her of partiality.
Nigeria goment dey accuse Kanu of terrorism and attempts to bring down goment, sake of di activities of Ipob, a group wey dey agitate to break away from di south eastern region of Nigeria to become independent kontri wey im name go be Biafra.
Goment bin don declare di group as terrorist organisation in 2017.
Kanu chief defense counsel Aloy Ejimakor post on X last week say "we dey primed and ready" for di trial.
Wetin dey expected to happen in court
Wen a new judge take over a case wey bin din dey go on, e no matter how far di case bin don go, di matter go start again from di beginning.
And di beginning na di arraignment, wia dem go read out di charges for di person to plead guilty or not guilty.
So dis na wetin dey expected to happen today. For Nnamdi Kanu matter di charges against am now dey seven.
Di charges bin dey 15 but di former Judge, Binta Nyako, bin strike out eight of dem.
Dis na di remaining charges:
So, afta Kanu plead guilty or not guilty, di prosecution fit ask for di trial to resume but di defence team dey likely to apply for bail for Kanu bicos na wetin dem bin don dey try to achieve for a long time wen Binta Nyako dey in charge of di case.
Nyako bin insist say Kanu bin jump bail in 2017 afta e run from Nigeria wen she bin grant am bail on health grounds, but Kanu lawyers maintain say e no jump bail rather e run for im life.
Brief background
As di leader of di secessionist group Ipob, Kanu, wey bin base for London, dey always talk about how di south east region suppose pull out for Nigeria and be dia own kontri.
Im major platform na Radio Biafra wey also dey based for London, Britain, and im social media platforms.
For October 2015, men of di Department of State Services, DSS, bin first arrest am as e come into Nigeria. Dat time na wen Muhammadu Buhari be president of Nigeria.
Goment charge am to court for treason - togeda wit four oda pipo - ontop accuse say e dey use im Radio Biafra to dey talk tins wey fit destabilise Nigeria and bring down goment.
Kanu dey remanded for prison for Kuje, Abuja until April 2017 wen justice Binta Nyako grant am bail bicos say im health bin dey fail, but she attach conditions say make Kanu no address di press and make e no dey for gathering of pipo wey pass 10.
Di bail dey in di sum of N100 million wit three sureties, one of dem go be pesin wey im position high for goment; current Abia State senator Enyinnaya Abaribe na one of di pipo we stand surety for Kanu dat time.
Kanu go later disappear from di public afta e tok say soldiers bin attack im house to kill am during one security operation wey dem call Operation Python Dance.
Dat attack, according to Kanu, and di trauma wey follow am, na im lead to di death of im papa and mama wey bin die within two months of each oda - in October and December of 2019 respectively.
Kanu later reappear in October 2018 wen pictures and videos show wia e go pray for di Western Wall of Jerusalem wey be one of di holy sites for Judaism, di religion wey Kanu dey identify wit.
E later return to London and continue im agitation for Biafra, until June 2021 wen security forces bin seize am for Kenya and bring am back to Nigeria by force.
Im case continue again bifor Justice Binta Nyako wey bin don revoke di bail she bin grant Kanu for 2017.
Goment file amended 15-count charges against Kanu wey e plead not guilty to, but Nyako later comot eight of di charges say dem no get head.
Kanu lawyers, dat time wey dey led by Mike Ozekhome a senior advocate of Nigeria, carry di matter go Court of Appeal as dem claim say di lower court suppose strike out all di charges.
Di appeal court agree wit dem and strike out all di charges, but goment appeal to di Supreme Court wey overturn di judgement and say make di matter return to di High Court.

Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Court strike out video and written statement DSS obtain from Kanu under pressure
Court strike out video and written statement DSS obtain from Kanu under pressure

BBC News

time29-05-2025

  • BBC News

Court strike out video and written statement DSS obtain from Kanu under pressure

Justice James Omotosho of di Federal High Court Abuja don comot two video evidence and three written statements wey di Nigeria goment bin wan tender as evidence for di trial of Nnamdi Kanu. Kanu, di leader of Ipob, a secession group for Nigeria bin tell di court say im bin dey under duress wen e write di statements, and im lawyer bin no dey present. For di last hearing, Justice Omotosho bin order a trial within trial to establish weda or not to admit di evidences. Delivering im ruling for di proceeding on Thursday, Omotosho say di law provide say any accused pesin suppose get legal representation bifor e go make im statement. Omotosho first tok say di video show say di atmosphere bin dey cordial wen Kanu bin dey make di statement, and e no see any sign of coercion or force. "However, dis court no go close im eyes to di fact say di defendant bin complain regularly about di absence of im counsel," Omotosho tok. According to di trial judge, section 15 of di Administration of Criminal Justice Act (ACJA) provide say di statement of a suspect must to be obtained for di presence of im counsel, and wia di suspect no get counsel, an officer of di legal aid council of Nigeria or a member of di civil society suppose dey present. Omotosho say: "Even though di statement bin dey recorded on video, di fact say di lawyer of di defendant no dey present don make di statement inadmissible in evidence "Dis court dey empowered to also expunge di video recordings wey e bin don admit in evidence. As e don dey established say di statement no dey admissible, it holds to law say di video recordings also no dey admissible." "I hereby order as follows:

Nnamdi Kanu: FG go call dia third witness as trial continue today
Nnamdi Kanu: FG go call dia third witness as trial continue today

BBC News

time28-05-2025

  • BBC News

Nnamdi Kanu: FG go call dia third witness as trial continue today

Di trial of Nnamdi Kanu leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob) go continue dis Wednesday morning for di Federal High Court Abuja. For today hearing, e dey expected say di Nigeria goment go call dia witness number three. Also, e go be day one of di six days wey di trial judge James Omotosho bin give di prosecution team to call all dia witness and close dia case. Di hearing don start and BBC Pidgin dey on ground to give you di latest updates. Wetin bin don happen for di trial For di last adjourned date, Justice Omotosho bin give di prosecution team di following dates: May 28, 29, and June 6, 16, 18, 19, 2025 to finish dia case so dat di defence team go start dia defence. So far, di Nigeria goment don call two witnesses - Mr AAA and Mr BBB. Both of dem na DSS officers wey lead di first arrest of Nnamdi Kanu in 2017 and di investigation from 2021 afta Kanu rearrest respectively. Witness AAA bin tell di court how di DSS bin first arrest Kanu for one hotel close to di Lagos Airport in October 2017, wit one woman wey bin dey wit am, including plenty broadcasting materials wey dem recover from am. But during cross-examination, e admit say dem no recover any dangerous weapon or instrument of terrorism for im hand. Also Mr AAA say evidence dey, wey link Nnamdi Kanu wit di insecurity for di south east region. For im own witness, Mr BBB say na im lead investigation into allegations of terrorism against Kanu afta security officials re-arrest am for Kenya in 2021, even though e deny say na DSS pipo arrest am for Kenya. BBB say dia evidence bin establish say broadcasts wey Kanu bin dey make on top Radio Biafra and im social media handles, dey directly connected to violence and killings for Lagos State during di End SARS protest of 2020, and also for di southeast region. However, for cross-examination, Kanu lawyers present di report of di Lagos panel of enquiry into di End SARS protest, wey according to am no indict Kanu or Ipob for any violence. Also, Kanu lawyers bin play some videos to retired Army General T.Y Danjuma, di Director General of di Department of State Services, Adeola Ajayi, wia dem dey call on di public to rise up and defend diasef from terrorist and bandit attacks. Dem also play video of di guvnor of Imo State Hope Uzodinma, wia e tok say Ipob no dey responsible for di killings in Imo State, but rather na politicians dey behind am. We dey update dis tori.

Separatists' sit-at-home protests lead to 700 deaths in Nigeria's southeast, report says
Separatists' sit-at-home protests lead to 700 deaths in Nigeria's southeast, report says

Reuters

time26-05-2025

  • Reuters

Separatists' sit-at-home protests lead to 700 deaths in Nigeria's southeast, report says

LAGOS, May 26 (Reuters) - A sit-at-home order by banned separatist group Indigenous People of Biafra in Nigeria's southeast has led to the death of over 700 people in the region over the past four years, an intelligence consultancy said in a new report. The IPOB, campaigning for the secession of the southeast that is predominantly inhabited by the Igbo ethnic group, has been labelled a terrorist organisation by Nigerian authorities. SBM Intelligence reported that the fatalities resulted from the killing of civilians who defied the weekly stay-at-home order every Monday and on other specific days, as well as from clashes between the IPOB and Nigerian security forces. "IPOB's enforcement tactics, including arson, looting and targeted assassinations, have created a climate of fear," the SBM report said. "While there was a high rate of compliance with sit-at-home orders in 2021 (82.61%), surveys reveal that actual support is much lower (29%) now, with many complying under duress." An IPOB spokesperson denied the group was responsible for the deaths. "Those causing the killings are the kidnappers and criminals recruited by government to blackmail and demonize IPOB," the spokesperson said. The government did not respond to a request for comment. The IPOB launched the sit-at-home protest in August 2021 across the five states of Nigeria's southeast, using it as leverage to demand the release of its leader, Nnamdi Kanu, who is facing trial in the capital Abuja on terrorism charges. The group suspended the weekly protest days later, citing a "direct order" from Kanu, who has been in custody since 2021, and reinstated it only on days the IPOB leader would be appearing in court. However, other armed groups claiming allegiance to IPOB and factions within the group have persisted in enforcing the weekly protest, launching attacks on government facilities and perceived pro-government individuals. Despite IPOB's attempts to disassociate itself from the region's violence, the police have accused the group of involvement in several incidents, including a 2021 attack on a prison and the murder of over 30 travellers earlier this month. The IPOB denied responsibility for those two attacks. The SBM report added that beyond the deaths, the sit-at-home order, which suspends economic activities in the southeast every Monday and on days when Kanu appears in court, has resulted in economic losses surpassing 7.6 trillion naira ($4.79 billion). Civil war engulfed the restive Biafra region in the late 1960s, killing more than 1 million people. ($1 = 1,598.5100 naira)

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store