Latest news with #AbdulmalikIbrahim


BBC News
25-05-2025
- Health
- BBC News
Experts explain benefits of garri and wetin too much consumption fit cause
Garri na one kain flour wey dem dey make from cassava tubers, and pipo for Nigeria and oda parts of West Africa dey chop am well-well. Some pipo dey use am make eba or soak am inside water join am wit milk, sugar, and groundnut. E get pipo wey believe say too much of garri fit affect pesin eye and dem believe say e also get oda health implications. Na dis kain tok-tok wey dey go round from pipo make BBC News Pidgin sidon wit health experts like Dietitian Sa'adatu Sulaiman and Dr Abdulmalik Ibrahim wey dey work for Gwarzo General Hospital for Kano, to know about di benefits and health implications of too much consumption of garri. Dietician Dr Sa'adatu Sulaiman tell BBC News Pidgin say "Pesin wey dey chop garri as balanced diet, e fit give im body plenty beta tins." On di oda hand, Dr Abdulmalik tok say garri fit get implications but only if dem no process cyanide wey dey inside well. E tok say, "Garri get one chemical wey dem dey call cyanogenic wey be dangerous poison for health." Some implications wey garri get Dis na some implications wey Dr Abdulmalik tok say dey inside garri wey fit affect health especially for pipo wey dey too exposed am. Health benefits of garri Dietician Sulaiman tok say If pesin chop garri as part of balanced diet, e fit give di body plenty beta tins:


BBC News
09-03-2025
- Health
- BBC News
Wetin pipo wit ulcer, diabetes, hypertension fit chop and no fit chop during Ramadan
Ramadan na holy month wey Muslims all ova di world dey observe by fasting from sunrise to sunset. But if you get diabetes, high blood pressure (hypertension), or ulcer, fasting fit dey hard for you. Despite di health challenges, pipo wit dis kain condition always still dey try to fast during Ramadan. Technically, dis kain pipo dey exempted from fasting until dem get beta, even though fasting dey among di five pillars of Islam and e dey veri important to di faith. Di Qur'an tok clearly for verse 185 of chapter one Surah Al-Baqarah say pipo wey dey sick or dey on a journey during Ramadan fit make up di fast for anoda time - but wit proper planning, advice from doctor, and correct eating habits. Dr Abdulmalik Ibrahim wey dey work for Gwarzo general hospital for Kano tell BBC Pidgin say pesin fit still fast and enjoy di spiritual blessings of Ramadan even say some risk dey. Ulcer and fasting Dr Ibrahim tok say ulcers dey happun wen too much acid or one infection (H. pylori) dey wound di stomach lining. If pesin dey fast, di stomach go still dey produce acid even wen food no dey, and e fit make ulcer pain worse. Dr Ibrahim say di possible risks wit fasting wit ulcer include: Who fit fast? Who no suppose fast? Dr Sa'adatu Sulaiman wey be dietitian and also dey work for Kano State Primary Healthcare Management Board tok about food wey good and bad for pipo wit health issues. Foods wey pesin wit ulcer fit chop for Ramadan Foods wey pesin wit ulcer no fit chop for Ramadan Hypertension and fasting Hypertension (high blood pressure) fit dey affected by di food wey pesin chop, water level, and stress. Fasting fit get good or bad effect, depending on di pesin condition. Possible risks Who fit fast? Who no suppose fast? Foods wey pesin wit hypertension fit chop for Ramadan Foods wey pesin wit hypertension no fit chop for Ramadan Diabetes and fasting Diabetes na one medical condition wey mean say too much sugar dey inside blood. Fasting fit come wit some risk like hypoglycemia, hyperglycemia, dehydration, or even serious wahala like hyperosmolar hyperglycemic state or diabetic ketoacidosis for pipo wey get diabetes. Who fit fast? Bifor pesin wey get diabetes go fast, e must first tok wit doctor. Di pipo wey fit fast na: Who no suppose fast? How you fit manage diabetes during Ramadan fasting If you get diabetes, fasting fit dey tricky, but you fit manage am well: Both Dr Ibrahim and Dr Sulaiman don give advice and some guidance wey fit help pipo wit dis kain sickness wahala for Ramadan. Below na di advice wey dem give; General ddvice for safe fasting Always dey monitor: Consult your doctor Final verdict: who fit fast?