29-04-2025
Aisha Achimugu dey answer kwesions for EFCC custody
Nigeria corruption police di Economic and Financial Crimes Commission don confam say Aisha Achimugu dey dia office.
Tori be say Aisha land Abuja on Tuesday morning from London to appear bifor di EFCC sake of fraud allegations and Court order.
While anoda tori pipo say EFCC bin arrest Aisha Achimugu as she land for Abuja Airport. Dem say na her lawyer give dem di tori.
According to local media na inside statement on Tuesday wey her legal team tok say EFCC arrest her afta she voluntarily come Nigeria from London.
Reports say na early mor-mor on Tuesday EFCC gbab her. Di anti-corruption agency neva tok if she waka go dia office by hersef or if na dia officials arrest her.
Local media dey report say di Federal High Court Abuja, bin give order on Monday say make she showface for EFCC office on Tuesday for interrogations.
Di Federal High Court also say she must showface for court on Wednesday, 30 April 2025, so dat dem fit continue to hear di mata.
Dr Mrs Aisha Sulaiman Achimugu, na Nigerian-born industrialist and humanitarian. She also be business woman.
We go dey update dis tori