logo
#

Latest news with #AishaAchimugu

Aisha Achimugu dey answer kwesions for EFCC custody
Aisha Achimugu dey answer kwesions for EFCC custody

BBC News

time29-04-2025

  • Politics
  • BBC News

Aisha Achimugu dey answer kwesions for EFCC custody

Nigeria corruption police di Economic and Financial Crimes Commission don confam say Aisha Achimugu dey dia office. Tori be say Aisha land Abuja on Tuesday morning from London to appear bifor di EFCC sake of fraud allegations and Court order. While anoda tori pipo say EFCC bin arrest Aisha Achimugu as she land for Abuja Airport. Dem say na her lawyer give dem di tori. According to local media na inside statement on Tuesday wey her legal team tok say EFCC arrest her afta she voluntarily come Nigeria from London. Reports say na early mor-mor on Tuesday EFCC gbab her. Di anti-corruption agency neva tok if she waka go dia office by hersef or if na dia officials arrest her. Local media dey report say di Federal High Court Abuja, bin give order on Monday say make she showface for EFCC office on Tuesday for interrogations. Di Federal High Court also say she must showface for court on Wednesday, 30 April 2025, so dat dem fit continue to hear di mata. Dr Mrs Aisha Sulaiman Achimugu, na Nigerian-born industrialist and humanitarian. She also be business woman. We go dey update dis tori

Who be di industrialist Aisha Achimugu wey EFCC declare wanted
Who be di industrialist Aisha Achimugu wey EFCC declare wanted

BBC News

time28-03-2025

  • Politics
  • BBC News

Who be di industrialist Aisha Achimugu wey EFCC declare wanted

Di Economic Financial Crimes Commission (EFCC) don declare one popular socialite and managing director/CEO of Felak Concept Group, Aisha Achimugu wanted. For one circular on dia social media accounts on Friday, 28 March, di commission say Achimugu dey wanted for alleged criminal conspiracy and money laundering. According to di circular wey EFCC tok-tok pesin Dele Olawale sign, e say; "Di public dey hereby notified say Aisha Sulaiman Achimugu, wey im photograph appear above dey wanted by di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) for one alleged case of criminal conspiracy and money laundering." Di circular add say make anybody wey get useful information on di whereabouts of 51-year-old Madam Achimugu contact di commission for dia offices or go report for di nearest police station or oda security agencies. Atiku deny say e collect funds from Lagos state Di anti-graft agency announcement dey come afta di presidential candidate of di PDP Atiku Abubakar for di 2023 election reject one report say dem receive campaign funds for di election from di Lagos state govnor through Madam Aisha Achimugu. Di Abubakar Media Office for one statement on Thursday, 27 March tok say di former vice-president no ever meet Sanwo-Olu, talk less of collecting money from im hand. "We for Atiku Media Office don take note of reports for one section of di media say di govnor of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu through Ms Aisha Achimugu bin give Atiku Abubakar, Vice President of Nigeria, 1999-2007 money wey allegedly belong to Lagos State. Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) dey investigate di mata." Bifor di circular wey declare Madam Achimugu wanted, tori be say EFCC bin first don invite Madam Achimugu come dia office to provide clarification on one corruption case wey involve her wey dem dey investigate. "Di commission currently dey investigate one case and di need to obtain certain clarification from you don become important," In view of di above, you are kindly requested to attend one interview wit di undersigned through di Head of Investigation on Wednesday, 5th March 2025, by 10:00 hours prompt," di letter read. Who be Aisha Achimugu? Aisha Achimugu bin make media headlines for January 2024 wen she throw one lavish seven-day party to mark her 50th birthday anniversary. Di seven-day extravaganza wey quickly become di tok of town bin hold for Calivigny Island and Silversands for Grenada; also for Abuja, Nigeria capital. Plenty ogbonge Nigerians and politicians, including Lagos state Govnor Babajide Sanwo-Olu bin attend di celebration wey hold for di Caribbean Island of Grenada. For her website, Dr Aisha Achimugu describe herself as ogbonge businesswoman and industrialist, she be di Group Managing Director and Chief Executive Officer, FELAK CONCEPT GROUP; one technical and professional consortium wey consist of about eight active companies in various sectors and industries like Engineering, Maritime, Oil and Gas, ICT Learning and Development, and various other leading sectors. She also be di Chairman, Bluewave Exploration and Production Limited. According to her website, Madam Achimugu OFR don receive plenty recognition and awards for her business acumen and humanitarian services from several esteemed organisations, wey include, FORBES Best of Africa Innovative Leadership Awards- September 2022, Winner, Africa Best Quality Oil & Gas Exploration and Production Company of the year (Oceangate Engineering Oil & Gas Limited) 2023, National Honors Award- Officer of di Order of di Federal Republic 2023, Di Youth Ambassador for Peace Award, among many odas. Dem born Madam Achimugu for 22 January, 1974.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store