logo
#

Latest news with #AsoRock

‘No more acrimony, peace don come' - Wike tok afta e meet wit Tinubu and Fubara
‘No more acrimony, peace don come' - Wike tok afta e meet wit Tinubu and Fubara

BBC News

time8 hours ago

  • Politics
  • BBC News

‘No more acrimony, peace don come' - Wike tok afta e meet wit Tinubu and Fubara

'No more acrimony. Peace don finally come to di state.' Na wetin FCT Minister Nyesom Wike tok at di end of a peace meeting between im and Rivers State Govnor Siminialayi Fubara wit President Bola Tinubu for Aso Rock. Photos of smiles and handshake between Govnor Fubara, di State Assembly members with Minister of FCT Nyesom Wike and President Tinubu don raise hopes of a possible end to di emergency rule for di state. Govnor Fubara alongside Wike and Martins Amaewhule, speaker of di Rivers State House of Assembly and oda Assembly members meet with President Tinubu to broker a peace deal wey dey expected to return democratic governance to di state. Dis meeting dey expected to be a crucial part of di peace building process since President Tinubu declare a state of emergency wey suspend elected state executives and di House of Assembly on 18 March 2025, over three months ago. Afta di meeting, di FCT minister and Govnor Fubara say peace don return as dem don finally reconcile. Wike say dem don agree to work togeda wit di govnor and di govnor too don agree to work with dem. E say dem be members of di same political family wey dey disagree sometimes but now, dem don settle and dem come togeda to inform Mr. president. Photos from di meeting suggest a breakthrough in efforts to resolve di political crisis for di state as one photo show di president with Govnor Fubara and FCT minister all dey smile and shake hands. Oda photos show di FCT Minister and di govnor dey waka side by side with di Speaker Amaewhule and oda state lawmakers dey follow dem. Govnor Fubara say e happy say dis day of reconciliation don come to be as e dey necessary and important for di peace and progress of Rivers State. 'With di help of di president and di agreement of di leaders of di state, peace don return to Rivers State. We go do evritin within our power to make sure say we sustain am dis time around.' Govnor Fubara tok. How we reach here? All dis crises arise from disagreement between Govnor Fubara and di FCT Minister Wike with many reactions wey include: Many pipo don criticise di emergency rule wey see di appointment of a Sole administrator, Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas Rtd, from Cross River State to oversee affairs for di state. E lead to many court cases wey dey challenge am for Federal High Courts both for Port Harcourt and Abuja as dem insist say a tsate of emergency no require di president to suspend di elected govnor and Assembly members and impose a non-indigene on di state to oversee affairs. Even di appointment of sole administrators for di 23 LGAs for di State na anoda issue wey many criticize as dem say e no dey known to law and e only favour one party for di crises. Odas also criticise di dissolution of boards and agencies for di state and even di one wey National Assembly don approve, over N1trillion 2025 state budget as well as clearing some officials for some boards. Di approval of anoda Cross River State indigene, Michael Ekpai, to head di Rivers State Independent Electoral Commission RSIEC wey dey expected to conduct local goment elections also spark criticism. But di main questions na weda dis reconciliation moves go bring an end to di emergency rule soon? Wetin go happen to di court cases wey challenge di emergency rule wey di Federal High Courts never begin proper hearing for most of dem? Wetin go happen to di recent appointments wey di Nigerian Senate approve, dem go still hold or dem go dey suspended? All dis na wetin pipo dey wait to see how e go all play out.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store