logo
#

Latest news with #BBNaija

'I no be anybody seventh wife, no be Ned Nwoko get my belle' – Chika Ike clear rumour about her pregnancy
'I no be anybody seventh wife, no be Ned Nwoko get my belle' – Chika Ike clear rumour about her pregnancy

BBC News

time18-02-2025

  • Entertainment
  • BBC News

'I no be anybody seventh wife, no be Ned Nwoko get my belle' – Chika Ike clear rumour about her pregnancy

Nollywood actress Chika Ike don clear di air on di paternity of di belle wey she carry. Di actress for statement say no be Nigerian politican Ned Nwoko get di belle. Di 39-year-old actress tok say pipo no sabi anytin about her becos she dey "private" and Ned no be her pikin papa and polygamy no be for her. "Una fit come later wit your guessing games and like I don tok bifor. I no be anyone seventh wife! Polygamy no be for me," she tok for her Instagram page. "I don get belle for months now and no one even get clue about my pregnancy until I announce am and you all tink you go sabi, my pikin papa or anytin wey dey happun for my life? e dey very laughable and clueless!" She add say she no care about di rumour wey pipo don begin dey dig up becos of her career choice but she don come out to tok becos dis na about her pikin "My privacy na my peace and no one fit unsettle me. I dey happy becos of my pregnancy and na wetin matter to me now," she tok. "Dem don draw our attention to di recent false rumours wey dey allege say Senator Prince Ned Munir Nwoko dey plan to marry Nollywood actress Chika Ike as im seventh wife and say she dey pregnant (get belle) for him. "We categorically state say dis claims dey entirely baseless and na a product of malicious speculation," di Director of media tok for statement. E also react to tori wey bin fly upandan say di lawmaker bin chook mouth for di mata of Tuface. "Similarly, reports wey dey claim say im bin make statements about Tuface and polygamy dey completely untrue. " Di tok-tok pesin for di statement, explain say oga Ned Nwoko na public figure and as im wife Regina Daniel na actress, na normal tin for bloggers to use her to get attention, na why dem dey forge all dis tori dem. Im add say, Senator Nwoko wey currently dey on national assignment, dey focused to deliver im political mandate, and im no get time for distractions. "Dis office dey available to journalists for verification of information, and we dey remind media practitioners of di consequences of spreading fake news." Bloggers dey always link Senator Ned Nwoko to news wey concern polygamy - di latest one na dis link to popular actress Chika Ike. Some years ago tori bin fly say di lawmaker wey get six wives, wan marry teenage entertainers. For 2023 and 2024 tori bin fly again say im wan marry actress Chike Ike. Na dat tori wey start to spread again afta she post pregnancy fotos. Rumours by local tori pipo dey always wan link female entertainers to billionaire politicians or businessmen for Nigeria. E neva too tey wey BBNaija star Nengi Hampson name spread say she get belle for one govnor, but both she and di govnor tok say na lie. Who be Chika Ike Chika Ike na popular Nollywood actress, producer and businesswoman. According to her profile for social media, she be former model too. She study Human Kinetics and Health Education for di University Of Lagos, Nigeria. For 2014 she obtain a post graduate degree from di New York Film Academy in Los Angeles, California. She don feature for many movies and she don now get her own production company wey be Chika Ike Production. Ned Nwoko na politician wey dey represent Delta North Senatorial District, na former House of Representatives member. Di politician recently defect from opposition party, di Peoples Democratic Party (PDP) to di All Progressives Congress (APC). For recent interview wit BBC Pidgin Ned Nwoko wey tok say im focus na to work for im pipo explain say one of di reasons wey make am jump from PDP and APC na to get Anioma State wey im pipo don dey fight for since over 50 years. But for di recently proposed 'new states' wey di House of Representatives bin do, Anioma State no dey inside. Early, Ned Nwoko wife, Regina Daniels Nwoko, bin tok for one BBC Pidgin interview say, she and her husband and co -wives no get any issue at all. She also say dhe fit enta politics one day as she go kontinu to support her husband. Di mother of two, dey always hail her husband evritime for social media, but Nigeria begin tok say she no chook mouth for her husband defection and she also deactivate her Instagram account. Dis two tins na im follow make di tori wey dem tok say na fake new waka far.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store