logo
#

Latest news with #BayelsaQueens

'Why I honour Falcons call-up just afta my husband death'
'Why I honour Falcons call-up just afta my husband death'

BBC News

time6 days ago

  • Health
  • BBC News

'Why I honour Falcons call-up just afta my husband death'

Nigeria Super Falcons player, Blessing Illivieda still dey mourn di death of her husband wen she gatz join di training camp. Just few days afta di news of her husband death, she ansa di call to join di national camp. For exclusive wit di BBC News Pidgin, she tok why she go national camp few days afta her husband die. Some pipo bin dey drag di Bayelsa Queens captain as dem question her decision to go camp to play football wen she suppose dey mourn her husband. But di defender say going to national camp na di highest honour she give her late husband. Blessing marry her husband Ibrahim Abiola on 21 January, 2023. Her husband die afta a brief illness on 23 May, 2025. "Dis camp wey I come so na im be di uttermost respect wey I wan give my husband. I dey expect am to come watch our friendly match as im promise wen we tok for phone." "Dem just call me say im no well, within two days di God wey create am tell am say time don reach, make e dey come." Blessing join di Super Falcons training camp days afta her husband die, and she say one of di way to take honour her late husband na to accept di call up. She say her husband just sick bifor, but im dey happy as she get di call up but sadly, e no dey alive to witness her play for di Falcons. "Di call up don come bifor dem call me say my husband sick, im even happy for di call up becos na wetin im dey pray for, say I go wear dis badge." "If I no come, dat mean say I no even love my husband, or I no appreciate di prayers wey im dey pray for me." For Blessing, to honour her late husband na to ansa di call up and fulfil di prayers wey her husband don pray bifor e die. No be say she just wan accept di call up from di national team, but she do am for her husband to dey proud. "Wetin dey keep me like dis na di promise wey I make to am, say di world go hear my name." "I do am for di man wey tell me say I marry you, I wan see you climb to di top. Plenti pipo wey dey dis situation, e dey hard for dem to come out." Blessing say e no easy for her but she gatz come of di situation and make her late husband proud even wen evribodi no expect am Meanwhile, Nigeria beat Cameroon 2-0 for di International friendly match on Tuesday for Abeokuta, Ogun State, southwest Nigeria. Producer: Tamara Ebiwei, Edited by: Mobolaji Olatunde

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store