20-04-2025
Leaders use Easter call Tinubu attention to Nigeria problems
As Nigeria join pipo for all over di world to celebrate Easter, prominent pipo for di kontri don use dis opportunity to appeal to dia leaders make dem embrace di principles of charity, sacrifice and love for pipo wey dem dey lead.
For im Vigil Mass preaching, di Bishop of di Catholic Diocese of Sokoto, Bishop Matthew Hassan Kukah, beg Nigeria President Bola Tinubu make im bring im kontri pipo from di cross of suffering wey dem dey face.
Di Bishop wey use metaphor of di cross to describe di suffer wey Nigerians don carry dia eyes see in recent years, say di kain suffer wey dey ground now, "dey marked by culture of brutality and wickedness wey eye neva see for di history of our dear kontri."
Di man of God say situation dey reach breaking point as Nigerians dey dangle and bleed on dis cross of suffering for too long.
Nigerians need proper end to insecurity especially food insecurity, an giving dem "mere palliative" dey "diminish di dignity of citizens, im add.
For im own message to Nigerian Christians dis year, di former Vice president of di kontri and di Peoples Democratic Party candidate for 2023 general elections, Atiku Abubakar, call for national unity.
"Our strength as a pipo dey for our togetherness. Kontri wey dey united go always fit endure flourish.
"Dey guided by di principles of sacrifice, love, and charity. Na only through sincere collabo we go fit heal our divisions and renew our national hope," im tok.