a day ago
Canada extend pathway pilot to support skilled refugees to get permanent residency
Canada don extend dia Economic Mobility Pathways Pilot (EMPP) wey go help refugees and oda vulnerable pipo to apply for permanent residency.
According to Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC), di EMPP na economic immigration pathway wey recognise di human and social capital of refugees.
E add say di pathway also cover oda displaced pipo wey get skills and qualifications wey meet di needs of Canadian employers.
Canada announce say di EMPP program for refugees and oda vulnerable pipo dey help fill di labour shortage for di kontri.
"To continue to dey meet labour market needs, di goment of Canada dey extend di federal stream of di EMPP until December 31, 2025."
Dis dey come afta Canada announce say dem go reduce permanent residency targets from 395,000 for 2025, 380,000 for 2026, and 365,000 for 2027, according to dia report for October 2024.
Wetin be EMPP for refugees and vulnerable
Di Economic Mobility Pathways Pilot (EMPP) na Canada first complementary pathway for refugee labour mobility.
According to Canada immigration ministry, dis na safe, legal immigration pathways for refugees and pesin wey get "similar protection needs outside of, and in addition to, traditional resettlement".
"Since di EMPP inception, candidates don fill labour market needs across di kontri for in-demand sectors, including health care wey get more dan 30% of total admissions, construction and food service.
"From 2019 to di end of March 2025, 970 pipo dey admitted into Canada through dis pathway.
Di EMPP na part of Canada broader immigration strategy to "promote economic growth, address labour market needs and help newcomers to settle for communities across di kontri".
Why di extension
According to IRCC, di extension of di EMPP na to allow more workers to benefit from di pathway program so dem go fit contribute to Canada economy.
However, di expected annual intake cap for di job offer stream for 2025 na 950 applications, and e go help di applicants to fit apply for permanent residency.
"Dis program dey help skilled refugees and vulnerable pipo to apply for permanent residence while dem go support employers for critical sectors wey dey face labour market shortages."
"Di extension go allow more workers for essential sectors such as health care to benefit from di pilot pathway to permanent residence and continue to contribute to our economy," di goment tok for statement.
Meanwhile, on di oda hand, IRCC dey reduce score of married pipo wey dey enta or wan stay for Canada but declare dia spouse as "non-accompanying".
Di "non- accompanying" option dey help married workers choose if dia spouse dey come wit dem or not, if dem wan apply for di permanent residency.
Canada opposition party call for immigration cut
Leader of di opposition Conservative Party Pierre Poilievre say Canada goment gatz impose wetin im call "severe limits" on population growth.
Poilievre say im dey concerned about di uncontrolled immigration, strained public services, and rising crime.
Wen di Conservative Party leader dey follow journalists tok, e say di Liberal Party goment dey allow population increase wey dey put pressure ontop Canada infrastructure and borders.
According to Statistics Canada, population for Canada bin grow by nearly 9% between 2021 and 2024, wey make am reach a milestone of 41 million pipo for March 2024.
Meanwhile under former Prime Minister Justin Trudeau, Canada bin welcome about 500,000 permanent residents annually, but e later release a policy wey im wan use reduce dat number.
"We dey reduce from 500,000 permanent residents to 395,000 for 2025; reduce from 500,000 permanent residents to 380,000 for 2026 and set a target of 365,000 permanent residents for 2027," di new plan under former PM Trudeau show.
Wen PM Mark Carney enta office, e also get plan to reduce di number of pipo wey dey enta Canada.
However, Conservative leader Poilievre say Carney dey follow di steps of im predecessor, and allege say e no dey control di immigration policy.
"Carney dey continue wit Trudeau disastrous immigration policy of uncontrolled population growth."
"We need lower levels and end to di abuse of di refugee, international student and foreign worker programs," Poilievre tok.