2 days ago
Makafui Awuku dey use plastic waste make desk for school children for Ghana
Makafui na 42-year-old environmental activist wey dey deal wit Ghana plastic waste wahala by recycling di waste to produce many items like bags, slippers, room furniture, pillows and odas.
Since 2017, im dey try to reduce di plenty waste wey dey di capital – Accra.
Di world economic forum for 2023 tok say ova eight million tonnes of plastic waste dey leak inside di ocean every year, wey Ghana bin dey produce more dan 840,000 tonnes of dis waste.
Na only 9.5% dem dey collect for recycling. Oga Makafui Awuku begin to explore how to collect more waste to protect di environment.
Im now dey create classroom furniture wit di plastic waste for schools wey no get desks.
Makafui and im group for McKingtorch Africa dey use dis innovation to address di problem of lack of desk for plenti schools for di kontri.
Sabi group - Eduwatch Ghana don find say ova 2.3 million children across di kontri no get desks for dia school.