logo
#

Latest news with #FabianBenjamin

Jamb release rescheduled UTME results
Jamb release rescheduled UTME results

BBC News

time25-05-2025

  • General
  • BBC News

Jamb release rescheduled UTME results

Di Joint Admission and Matriculation Board (Jamb) don release di results of di rescheduled 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME). Fabian Benjamin wey be tok-tok pesin for Jamb yarn dis one for one statement on Sunday 25 May. Di rescheduled exam na for 379,997 candidates wey dia results get comma sake of error wey bin affect 157 centres for Lagos state and di south-east. Jamb say dem release di results afta one professor of educational measurement and evaluation, Boniface Nworgu, review dem. Dem say afta Professor Nworgu review di results, Jamb Chief Examiner also review dem. How to check Jamb results Candidates fit check dia score through dis method. SMS method: Send "RESULT" to 55019 or 66019 wit di phone number you use to register. You go receive SMS wit your score details. Candidates no need to go any CBT centre or cybercafé to check results. Di results wey dem still dey process and di ones wey dey absent go receive message like "under processing" and "absent" respectively. Those wey dey under investigation go receive:

Jamb order review of 2025 UTME results, wetin be di fate of di candidates?
Jamb order review of 2025 UTME results, wetin be di fate of di candidates?

BBC News

time12-05-2025

  • Politics
  • BBC News

Jamb order review of 2025 UTME results, wetin be di fate of di candidates?

Di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) don announce say dem dey review di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) results wey dem release recently. Di exam bodi for statement wey dia tok-tok pesin, Fabian Benjamin sign say di board dey fast forward dia annual system review. Di review na comprehensive post-mortem of di examination process, Fabian tok. Dis na sake of di high number of complaints wey follow di release of dis 2025 UTME results last Friday. "If e dey determined say indeed glitches dey, we go implement appropriate remedial measures promptly, as we dey do in case of di examinations demsefs," e add. Di statement add say di board dey particularly worry about di unusual complaints wey dey come out from some states within di Federation. Nigerians including some candidates bin enta social media to complain about di low scores wey dey recorded by some candidates wey don score highr for dia previous Jamb. Wit di use of #thisisnotmyresult, social media bin full of how dem express worry and call for review of di results. Jamb wen dem release di results bin tok say about 1.5 million candidates perform below 200 dis figures na one of di lowest in recent times. Wetin dis mean be say dis year, na about 80 per cent of candidates wey bin siddon write dis 2025 UTME score less dan 200 points out of 400 points wey be di maximum wey a candidate fit get Each candidate bin take four subjects, wit each one carrying grade of 100 points. We dey update dis tori

Jamb registration 2025 postponed - Exam body give new date and reasons
Jamb registration 2025 postponed - Exam body give new date and reasons

BBC News

time31-01-2025

  • Politics
  • BBC News

Jamb registration 2025 postponed - Exam body give new date and reasons

Registration for di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) go now Start on Monday 3 February, 2025, instead of Friday 31 January, 2025. Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) tok dis one for statement by dia tok-tok pesin, Fabian Benjamin, on Friday. Di exam join-bodi say di change dey necessary to allow di board carry out key adjustments to im registration templates. Oga Fabian further tok say di change dey necessary partly as di board bin discover say some Computer-Based Test (CBT) centres use mago-mago facilities to get approval and dat na why dem need to further check and corrections and disapprove those kind centres. Also, di statement add say, "dis adjustments come in light of di recent suspension of certain law programmes for selected universities, as e dey submitted to di Board by di Council for Legal Education. "Di board acknowledge say di disruption wey dis fit cause to candidates and oda stakeholders and sincerely apologize for any inconvenience," di statement tok. Dem add say dem go use di additional time to make to make sure say dem do all necessary so registration process go dey easy. Suspension of Law for selected universities Earlier Jamb bin announce say dem no go conduct admissions for di Bachelor of Laws (LL.B) programme for eight universities for di 2025/2026 academic session. Di exam bodi say di decision to not register law programmes for those schools na afta dat of di institutions by di Council of Legal Education (CLE), di highest decision making bodi for legal education in Nigeria. Di schools wey dey affected na Kwara State University, Malete, Ilorin, Kwara State; Bingham University, Karu, Nasarawa State; Redeemers University, Ede, Osun State; Western Delta University, Oghara, Delta State; and Taraba State University, Jalingo, Taraba State. Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) bin earlier announce di start of registration for di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME). Bifor, Jamb bin say na 31 January candidates fit begin register and e go end for 8 March. JAMB, bin further tok for di statement on dia X handle say na for all JAMB accredited Computer-Based Test (CBT) nationwide registration go happun. For Direct Entry (DE) candidates, JAMB say di application documents and e-PIN vending registration go start from 10 March till Monday, 7 April. However, di exam join-bodi say make di DE candidates know say di registration dey restricted to only di Board State & Zonal Offices. Oga of JAMB, Is-haq Oloyede for one presentation wit tori pipo bin say di exam bodi don introduce UTME Mock Trial for underage students wey never fit register for UTME. Di Mock Trial na to help dem prepare ahead of real UTME afta dem for don they reach age 16. Breakdown amount wey candidate go pay for di 2025 UTME/DE Registration 1. UTME wit Mock-₦8,700 2. UTME without Mock-₦7, 200. 3. Mock Trial Testing for Future Candidates-₦3, 500. 4. DE-₦5, 700. Dis na di breakdown: UTME/DE application fee- ₦3,500 Reading Text,- ₦1,000 CBT centre registration service charge- ₦700 CBT Centre UTME service charge-₦1,500 CBT Mock service charge- ₦1,500 Bank charges- ₦500 CBT Mock-UTME centre service charge- ₦1,500.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store