10-05-2025
Wetin to expect from di 2025 AMVCA
Di 11th edition of di African Magic Video Choice Awards dey happun dis on Saturday 10 May.
Dis na di awards wey pipo dey call di Oscars of Africa even though e get some categories wey moviegoers dey follow vote inside.
For dis year AMVCA, dem get 27 award categories, wit 18 non-voting while for nine categories, di audience follow vote inside.
Di voting categories na for Best Digital Content Creator, Best Indigenous Language (South, West and East Africa), Best Unscripted M-Net Original, Best Indigenous M-Net Original, Best Short Films, Best Scripted M-Net Original and Best Multichoice Talent Factory. E bin close for di 4th of May 2025.
Dem go also vote two achievement awards wey dem go give out - na Lifetime Achievement and Trailblazer awards.
For di non-voting categories, wey include all of di acting categories, na panel of judges wey di AMVCA arrange go run am. Dose judges dey headed by one ogbonge filmmaker wey dem dey call Femi Odugbemi.
One Netflix series wey dem dey call Seven Doors pack di most nomination of 11 wit im stars, Femi Adebayo and Chioma Chukwuka getting nominated for Best Actor and Best Actress categories.
Lisabi (The Uprising) na di film wey get di second most nomination for di night as e score a total of ten nominations including for inside di acting categories.
Many pipo dey look dis year edition, to see di fashion afta Tuesday Met Gala wey many pipo online bin no really feel wetin Nigerian stars bin wear, as dis na one of di awards wey dey popular for di fashion wey dey run for dia red carpet.
AMVCA don make am part of dia tradition to give award for di Best Dressed of di night bifor even di award ceremony start.
For 2024, one Ghanaian actress, Nana Akua Addo wey don win di AMVCA Best Dressed bifor tell BBC Pidgin say for her, AMVCA na her own Met Gala.
Dis na as for 2020, she be one of di first celebs wey go win di Indian luxury brand Guarav Gupta sotey pesin even wear dat kain design go di 2024 Met Gala.
Wetin to know about di 2025 AMVCA
Dis na di 11th edition of di AMVCA wey dey considered as one of di biggest Movie and TV award shows for Africa.
Di show dey expected to start by 7pm and di red carpet go start by 4pm.
Di host for di nght na Ik Osakioduwa and performances dey expected by Johnny Drille, Fido, Serotonin, Kunmie and odas.
2025 Nominees for di AMVCA
Best Movie
Best Lead Actor
Best Lead Actress
Best Supporting Actress
Best Supporting Actor
Best Director
Best Cinematography
Best Editing
Best Costume Design
Best Makeup
Best Digital Content Creator
Best Documentary
Best Series Scripted
Best Series Unscripted
Best Writing - Movie
Best Writing - TV Series
Best Art Direction
Best Sound Design
Best Music/Score
Best Short Film
Best Unscripted M-Net Original
Best Indigenous Language (West Africa)
Best Indigenous Language (East Africa)
Best Indigenous Language (South Africa)
Best Indigenous M-Net Original
Best Scripted M-Net Original
Best MultiChoice Talent Factory