logo
#

Latest news with #GOODGOD2

Wizkid, Mohbad, Qing Madi and odas artistes wey make 2025 Headies nomination list
Wizkid, Mohbad, Qing Madi and odas artistes wey make 2025 Headies nomination list

BBC News

time12-02-2025

  • Entertainment
  • BBC News

Wizkid, Mohbad, Qing Madi and odas artistes wey make 2025 Headies nomination list

Di Headies don announce di nominees for di 2025 award, afta one year break. Di list get names of local and international stars for di Nigeria entertainment industry. Headies release di full list of nominees for di 17th award ceremony on 12 February for dia Twitter handle. Di award go specially recognise di 'Rookie of di year' for dia excellence performance in di music industry in di past year. Headies award dey happun evri year for Nigeria but e no happun for 2024 as dem postpone di event to February 2025. Late Mohbad wey pipo sabi as Ilerioluwa Aloba bag three nominations dis year, almost two years afta im die for September 2023. Headies neva announce wia di 17th award ceremony go hold and di official date. Full nominations list for di 17th Headies awards Dis na di categories wey dey Headies nomination list: Producer of di Year, Best Recording of di Year, Songwriter of di Year, Best R&B Singles, Rookie of di Year, Best Rap Single, Best Vocal Performance (female), Music Video of di Year, Best collaboration, Inspirational Singles, Lyricist on di Roll, Afrobeats Single of di Year, among odas. NOMINEES FOR DI 17TH HEADIES ROOKIE OF DI YEAR ZERRY DL TAVES KAESTYLE LLONA NOMINEES FOR DI 17TH HEADIES BEST INSPIRATIONAL SINGLE GRATITUDE – ANENDLESSOCEAN WORTHY OF MY PRAISE - DUNSIN OYEKAN FT. LAWRENCE OYOR GOOD GOD 2 - LIMOBLAZE FT. NAOMI RAINE PARTICULARLY - GAISE BABA FT. TOPE ALABI YOU DO THIS ONE - MERCY CHINWO NOMINEES FOR DI 17TH HEADIES LYRICIST ON DI ROLL MOGADISHU - A-Q CHOCOLATE CITY CYPHER - M.I ABAGA CHOCOLATE CITY CYPHER – BLAQBONEZ HALLELUJAH – LADIPOE EFELEME - ALPHA OJINI NOMINEES FOR DI 17TH HEADIES AFROBEATS SINGLE OF DI YEAR BIG BIG THINGS - YOUNG JONN FT. KIZZ DANIEL AND SEYI VIBEZ TWE TWE REMIX - KIZZ DANIEL EGWU FEAT. MOHBAD – CHIKE REMEMBER – ASAKE OGECHI REMIX - HYCE, BOYPEE AND BROWN JOEL FT. DAVIDO BIG BALLER – FLAVOR NOMINEES FOR DI 17TH HEADIES BEST STREET-HOP ARTISTE SEYI VIBEZ – "DIFFERENT PATTERNS" AYO MAFF – DEALER (FT. FIREBOY DML) SHALLIPOPI – CAST (FT. ODUMODUBLVCK) ZHUS JDO – JOHNBULL MOHBAD – ASK ABOUT ME

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store