2 days ago
Straw Tyler Perry movie wey dey draw emotions from Nigerians
Straw, one new psychological crime thriller movie wey ogbonge American filmmaker Tyler Perry just release on Netflix currently dey totori feem lovers all ova di world.
Di feem wey dey rank number one on Netflix globally na movie wey get plenty emotional turmoil and e full of suspense.
Di Netflix thriller, wey dem release on 6 June, star Taraji P. Henson as Janiyah Wiltkinson, one single mother wey dey struggle to provide for her sick daughter, Aria (Gabby Jackson).
As di movie hit number one for di world on Netflix, Madam Henson for one post on Instagram tok say, "Dis one take me on a journey—deep, raw, real—and I dey so grateful say e dey land wit you, di way e land wit me."
"To everibody wey cry, reflect, and feel sometin… I see you. I feel you. Dat na why we do dis," Henson add.
Many pipo hail and relate to di feem as e capture di struggles of ordinary pipo we trap for these kind of situations.
Wetin Straw dey all about?
Di official synopsis for Straw show how one single mother world turn upside down one day, as her day bin go from bad to worse to catastrophic as she struggle to care for her sick daughter.
As di situation push am to di edge by di world wey no care about her existence, she dey forced to confront impossible choices for inside society wey no guarantee safety net.
As her day bin go out of control, na so she no fit do wetin dey right, wetin dey legal, and wetin even dey real. Di tori wey start from woman wey dey try to hold evritin togeda quickly take unexpected turns and leave pipo wey dey watch to kwesion evritin.
Oga Perry tear di tori down to raw moments of desperation, e explore wetin fit happun wen dem push pesin beyond dia limits. Why Janaiyah hold bank hostage? Wetin be di real tori behind her daughter? And wetin e mean wen pesin finally reach dia last straw.
Straw, na very heart-breaking, emotional story wey reveal di harsh reality of di world.
As e dey tok to Entertainment Weekly, di Oscar nominee say wetin draw her to di tori na how Straw highlight "how easy e dey for pipo wey dey for vulnerable position to dey disregarded or disenfranchised by di system wey suppose protect dem."
Straw focus on di financial struggles of single mother Janiyah, wey come across multiple setbacks throughout her day.
Di movie also feature two strong women Nicole (Sherri Shepherd) di bank manager and Detective Raymond (Teyana Taylor), wey show di lead character real support for di first time. Dem listen to her struggles and try to de-escalate di situation.
Di feem also get one shocking twist for di end, as e dey normal wit Tyler Perry feems, wey go leave fans wit plenty confusions and questions.
Casts of Straw
Oga Perry feature plenty ogbonge actors for dis movie and dem deliver dia role well. Part of dem na three women wey carry di movie, give di feem life and essence.
Taraji P Henson as Janiyah
Janiyah Wilkinson na di lead cast member of di movie. She be di helpless mother wey struggle to take care of her sick daughter, Aria. To provide for her basic needs, Janiyah bin work for one grocery store under one unsympathetic boss wey no dey miss opportunity to ridicule her. One day, wen authorities take her daughter, she make one decision wey make her life even more difficult.
Taraji P. Henson play di role of Janiyah Witkinson for Straw. She be famous American actress and she don feature for ogbonge movie like Hustle & Flow, The Curious Case of Benjamin Button, The Karate Kid, and Streetwise, among odas. She also don win plenty awards.
Sherri Shepherd as Nicole
Afta dem fire her from work, Janiyah bin try to cash her cheque for bank, but di cashier tell her say she must provide official ID and she no get. As she no get oda option, Janiyah take out gun to threaten di cashier. Nicole, na di bank manager, wey call di police and alert dem say Janiyah get gun and she carry bomb, she later become support system to Janiyah. Afta Janiyah allow all di hostages to leave di bank, Nicole bin stay back to ensure say she safely surrender herself to di police.
Sherri Shepherd na award-winning actress wey don feature for many movies like 30 Rock, The Sex Life of College Girls, and more.
Teyana Taylor as Detective Kay Raymond
Det. Key Raymond na one former negotiator for di army. She bin work as a detective for di main storyline. Even though she hear say Janiyah allegedly rob bank, Raymond still dey sympathetic towards her and also punish di officer threaten Janiyah earlier. Kay Raymond play incredible role for di feem, and her acting dey highly impactful
Teyana Taylor na multitalented public figure. She be actor, dancer, singer, and music video editor wey don show for plenty music videos.