2 days ago
Prime suspect for di murder of Hafsat Yetunde Lawal say im no get hand for her death
Di ongoing trial into di death of 23-year-old Hafsat Yetunde Lawal take anoda twist wen di prime suspect Abdulraheem Bello testify for court say no be im kill her.
"No be me kill Hafsot Yetunde Lawal, di police accuse me say I dey lie and dem tok say na me kill am," e tok.
On Wednesday, 11 June, di trial of Abdulkareem Bello plus four odas wey dey charged wit five counts wey include murder and conspiracy bin kontinu for di Kwara State High Court.
Di late Hafsot, na final-year student for Kwara State College of Education for Ilorin wen she pass away suddenly for February 2025.
One BBC reporter wey dey for di trial say di main suspect, Abdulrahman, tell di court that teaching children to read and write plus oda activities na im job.
We dey update dis tori