logo
#

Latest news with #HectorEkakita

Viral video catch wia pipo dey beat Rivers LGA Sole administrator, police take action
Viral video catch wia pipo dey beat Rivers LGA Sole administrator, police take action

BBC News

time12 hours ago

  • Politics
  • BBC News

Viral video catch wia pipo dey beat Rivers LGA Sole administrator, police take action

Rivers state police don condemn di attack on di sole administrator of Ahoada-East Local goment area, Goodluck Iheanachor and invite im chief of staff to come answer kwesion on di matter. Police claim say Hector Ekakita, wey be di chief security officer and di Chief of staff to di sole administrator allegedly storm di council secretariat wit 30 jaguda pipo, wey attack oga Iheanacho. Di attack happun on Friday 20 June for di council secretariat according to police. During di attack, di jaguda pipo beat di Sole Administrator, tiff im mobile phones, force am to sign im letter of resignation, den go away vital documents, including official and personal documents from im office, police tok. Dis incident dey happun few months afta im appointment by Vice Admiral Ibot-Ete Ibas di Sole Administrator of Rivers State. Police say Iheanacho dey hospital wia im dey currently collect medical treatment sake of di injuries wey e get during di violent attack. Im dey stable condition. Meanwhile di commissioner of Police, Olugbenga Adepoju, visit di scene of attack wit heads of oda sister security agency for di state and vow to take action. Viral video For di viral video, Honourable Iheanacho wear grey native sitdom for ground surrounded by di Jagudu pipo. Di jaguda pipo flog di sole administrator of Ahoada and shout on am to sign di document wey dem give am. Rivers state emergency rule Na March 18, 2025, President Bola Tinubu declare state of emergency for Rivers state and suspend di governor, im deputy and all lawmakers for di state parliament for six months. For one nationwide broadcast on Tuesday evening Tinubu say im receive "disturbing security reports wia im detail incidents of vandalization of pipelines by some militants without di govnor taking any action to curtail them". Im add say im no allow di "grave situation" to kotinu. But lawyers and opposition politicians dey kwesion di legality of di president decision. Tinubu bin make di announcement afta one of di kontri highest producing crude oil pipelines, di Trans-Niger Pipeline, bin suffer significant damage sake of blast. In di past criminal gang or militant don carry out attack on pipelines wey, halt production and exports. At current prices, the oil flowing through the affected pipeline fetches around $14m (£11m) a day, according to the online publication Africa Report. But against the backdrop of the blast, there has been a political rift in Rivers state that has reached boiling point. Govnor Siminalayi Fubara na member of di People Democratic Party wey dey face serious wahala. PDP na di main opposition party to di president's All Progressives Congress. Tinubu say politicians no bin fit work togeda effectively sake of di wahala. Im allege say Fubara allies bin threaten "fire and brimstone" against di govnor enemies and dem no "disown" dis comments. Rivers state lawmakers bin threaten to impeach di govnor and im deputy. Tinubu say dis political crisis don leave Rivers state im "standstill" im add say dis im move dey based on di need to restore peace and order for di state. Fubara react to di state of emergency, im say na "political disagreements, but good governance dey kotinu". "Rivers state dey safe, secure and peaceful under our watch," im tok. Di state of emergency allow di goment to run di state in di interim and dem go send security forces if needed.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store