logo
#

Latest news with #IdaraMonday

Meet the troupe of Nigerian kids entertainers who play the xylophone
Meet the troupe of Nigerian kids entertainers who play the xylophone

BBC News

timea day ago

  • Entertainment
  • BBC News

Meet the troupe of Nigerian kids entertainers who play the xylophone

Ndito Uforo Akwa Ibom Cultural Troupe wey comprise of little children dey use dia skills of di xylophone to entertain pipo. Dem dey make waves wit dia ogbonge talent as dem dey blend traditional xylophone sounds wit Afrobeats and oda genres of music. Director of di cultural troupe say di idea of Utoro na to preserve di culture of Akwa Ibom and Nigeria. E say di music don impact di children well-well. E say di children bin no get idea of how to play di instrument, but e help dem develop interest and sabi how to play am. Di children say dem enjoy playing di xylophone, and e no dey affect dia academics, as na evening dem dey rehearse afta school. Na Idara Monday feem and edit am

Di little chef Khat wey dey totori pipo wit her cooking and baking skills
Di little chef Khat wey dey totori pipo wit her cooking and baking skills

BBC News

time28-02-2025

  • Entertainment
  • BBC News

Di little chef Khat wey dey totori pipo wit her cooking and baking skills

Little Chef Khat na eight-years-old wey start to learn how to bake and cook wen she be two-years-old. At dat time, she bin dey observe her mama many times for kitchen. Khatoumi Ndebugri Isa like to bake pizza, bread, cakes and make oda local meals. Little Chef Khat start her baking and cooking club two years ago wia she dey share her knowledge wit her friends. She dey hope to be ogbonge Chef, doctor and model for future. Her mama tok say she dey surprised and proud of her daughter just like evri oda mother sake of say her daughter dey do sometin positive for society. She tok how far little chef Khat don come wit her cooking and how she dey offer tutorials and share her cooking journey and recipes for social media (Tiktok and Instagram). Little Chef Khat don gain plenty of followers on dis platforms. Filmed and edited by Idara Monday

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store