03-03-2025
Waec obey court order as dem release all 2024 WASSCE results
Di West African Examinations Council (Waec) don officially release all di results from di 2024 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) wey dem bin hold.
Dem bin hold ova 10,000 results sake of suspected malpractices.
Di release of di results on Friday dey come afta di National Union of Ghana Students (NUGS) bin drag Waec to court and also threaten nationwide protest if dem no release di results.
Di head of Waec public affairs John Kapi tell tori pipo Citi FM say outstanding results no dey as dem don release evritin.
"As we bin promise, we keep to our word. By di close of 28th February, we bin don upload all di results of candidates wey we bin hold dia results. Di court bin order us to release dose results, and we don duly comply. So as far as dose examinations dey concerned, outstanding results no dey," e tok.
Oga Kapi say Waec bin anticipate say candidates go soon dey reach out for dis new week wit queries or complaints.
E say di results wey dem release accurately reflect di performance of candidates for di examination.