2 days ago
Court sentence doctor to 21 years in prison for raping im patients
One court for Norway don sentence one doctor to 21 years in prison on top accuse say e rape and sexually abuse dozens of women, for one case wey shake di Scandinavian kontri.
Di court find di former doctor guilty of 70 counts of rape and sexual assault. Court also convict am of 82 counts of abuse of im position as a doctor, Norwegian media report.
Almost all di offences happun during medical examinations wey Oga Bye carry out on im patients wen e dey work as physician for di small town of Frosta - one very small community of fewer dan 3,000 residents, near Trondheim for di west coast of Norway.
Court also ban Oga Bye from practising medicine and order am to pay compensation.
Warning: dis tori contain details wey fit turn some pipo belle.
Di court work on di long indictment, wey include allegations wey cover nearly two decades relating to 94 women, according to Norwegian media.
Oga Bye plead guilty to some of di crimes, and dem free am on some of di charges.
Addressing di court for Trondheim on Friday, Judge Espen Haug tok say di case dey "very serious" and dem describe Bye actions as "absolutely unacceptable".
"Di defendant actions happun for place and setting wia pipo suppose feel safe," Judge Haug tok. "Im actions don undermine public trust for di health service and for doctors in general."
Di 55-year-old defendant stand on im feet, and e appear calm and unmoved as dem hand down di maximum sentence.
Di judge later ask di courtroom to sit as e take more dan one hour for am to read di judgement out.
Health authorities bin first alert di police to concerns about Bye for August 2022, and dem charge am a year later.
Bye bin secretly install one camera for im office, Norwegian media report. Police discover di scale of im offences afta dem review hundreds of hours of footage.
Dozens of women, reportedly between di age of 14 and 67, from di small, rural community bin come forward. Di earliest complaint bin date back to 2004, di most recent from 2022.
Central to di case na di methods Bye dey use for medical examinations.
Ova four months, di court hear details of non-consensual touching plus inappropriate pelvic examinations wey Bye conduct.
Dis acts constitute rape under Norwegian law, wey differentiate between penetrative and non-penetrative rape.
Di court also see say Bye use non-medical equipment, like deodorant, during dis exams, wit no justification for doing so.
Di defence attorneys bin ask for lower sentence of around 17-18 years as Bye plead guilty to di rape of 21 victims.
Prosecutors tell public broadcaster NRK say dem dey okay wit di verdict and go review di outcome bifor dem consider any appeals.
Bye lawyer also say dem go take some time to read di verdict properly bifor dem decide weda to appeal.