logo
#

Latest news with #JuliusJuma

Why di death of 26-year-old Albert Ojwang wey die for police custody dey spark protest for Kenya
Why di death of 26-year-old Albert Ojwang wey die for police custody dey spark protest for Kenya

BBC News

time9 hours ago

  • BBC News

Why di death of 26-year-old Albert Ojwang wey die for police custody dey spark protest for Kenya

Dozens of activists don stage protest outside one mortuary for Kenya capital, Nairobi. Dis dey come afta di one 26-year-old man die for police custody. Albert Omondi Ojwang death spark outrage for Kenya. Dem arrest am afta one complaint by di deputy police chief, wey accuse am say e tarnish im name on social media. for one initial statement, police tok say Ojwang "bin sustain head injuries afta e hit im head against one cell wall" for custody. However, Ojwang family lawyer, Julius Juma, tok say di body show signs of severe physical trauma, wey include swelling on di head, nose and ears. Oga Juma also say im see bruises on Ojwang shoulders and hands - injuries wey e say no dey consistent wit one single impact against a wall. Kenya Independent Policing Oversight Authority (IPOA) don launch inquiry into im death. Protesters hold placards and dey chant "Stop killing us", dem protest for Nairobi City mortuary, wia dem keep Ojwang body. Di crowd later march go di Central Police Station wia dem hold Ojwang bifor di time of im death. Why Police arrest Albert Ojwang wey later die for custody Police arrest Oga Ojwang for Homa Bay, one town for western Kenya, on Friday, 7 June, sake of one post e put on X wey allegedly criticise di Deputy Inspector General of Police, Eliud Lagat. Dem later transfer am go Nairobi, wey dey ova over 350 km (220 miles) from wia dem arrest am and book am into Central Police Station on Saturday, 8 June. According to Oga Kanja, dem arrest Mr Ojwang afta Oga Lagat file one complain say e dey "tarnish" im name. "Na on dat basis dem carry out investigations," Oga Kanja tok for one press conference. Responding to mounting public pressure, Oga Kanja announce say dem don take actions against senior officers for Nairobi Central Police Station. Police tok-tok pesin Michael Muchiri, tell BBC say dis one mean say di officers no go fit perform dia duties, and dem go receive half dia salaries, pending di outcome of di investigation by IPOA. Speaking at a press conference, Inspector General Kanja tok say di police go give di investigators all "necessary support" to solve di case. Dem find Mr Ojwang unconscious during one routine inspection of di cells and dem "rush am go hospital, wia dem pronounce am dead on arrival", police tok. Di director of Amnesty International Kenya branch, Irungu Houghton, tell BBC say Mr Ojwang death dey "very suspicious". Oga Houghton tok say e dey "quite shocking" say dem no book Ojwang for di local police station afta dem detain am, but instead dem carry am on long journey. On Sunday, 8 June, e call on independent investigators to secure wetin e describe as "di crime scene" for di police station for Nairobi. Oga Ojwang death for detention dey come at a time of rising concern on top how dem dey treat some goment critics. Last week, software developer Rose Njeri, wey create one tool to help pipo oppose one goment finance bill, dey charged wit accuse say she violate a cybercrime law. She deny di charge.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store