logo
#

Latest news with #JusticeOmotosho

Nnamdi Kanu: FG go call dia third witness as trial continue today
Nnamdi Kanu: FG go call dia third witness as trial continue today

BBC News

time28-05-2025

  • General
  • BBC News

Nnamdi Kanu: FG go call dia third witness as trial continue today

Di trial of Nnamdi Kanu leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob) go continue dis Wednesday morning for di Federal High Court Abuja. For today hearing, e dey expected say di Nigeria goment go call dia witness number three. Also, e go be day one of di six days wey di trial judge James Omotosho bin give di prosecution team to call all dia witness and close dia case. Di hearing don start and BBC Pidgin dey on ground to give you di latest updates. Wetin bin don happen for di trial For di last adjourned date, Justice Omotosho bin give di prosecution team di following dates: May 28, 29, and June 6, 16, 18, 19, 2025 to finish dia case so dat di defence team go start dia defence. So far, di Nigeria goment don call two witnesses - Mr AAA and Mr BBB. Both of dem na DSS officers wey lead di first arrest of Nnamdi Kanu in 2017 and di investigation from 2021 afta Kanu rearrest respectively. Witness AAA bin tell di court how di DSS bin first arrest Kanu for one hotel close to di Lagos Airport in October 2017, wit one woman wey bin dey wit am, including plenty broadcasting materials wey dem recover from am. But during cross-examination, e admit say dem no recover any dangerous weapon or instrument of terrorism for im hand. Also Mr AAA say evidence dey, wey link Nnamdi Kanu wit di insecurity for di south east region. For im own witness, Mr BBB say na im lead investigation into allegations of terrorism against Kanu afta security officials re-arrest am for Kenya in 2021, even though e deny say na DSS pipo arrest am for Kenya. BBB say dia evidence bin establish say broadcasts wey Kanu bin dey make on top Radio Biafra and im social media handles, dey directly connected to violence and killings for Lagos State during di End SARS protest of 2020, and also for di southeast region. However, for cross-examination, Kanu lawyers present di report of di Lagos panel of enquiry into di End SARS protest, wey according to am no indict Kanu or Ipob for any violence. Also, Kanu lawyers bin play some videos to retired Army General T.Y Danjuma, di Director General of di Department of State Services, Adeola Ajayi, wia dem dey call on di public to rise up and defend diasef from terrorist and bandit attacks. Dem also play video of di guvnor of Imo State Hope Uzodinma, wia e tok say Ipob no dey responsible for di killings in Imo State, but rather na politicians dey behind am. We dey update dis tori.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store