logo
#

Latest news with #KanoStatePrimaryHealthcareManagementBoard

Wetin pipo wit ulcer, diabetes, hypertension fit chop and no fit chop during Ramadan
Wetin pipo wit ulcer, diabetes, hypertension fit chop and no fit chop during Ramadan

BBC News

time09-03-2025

  • Health
  • BBC News

Wetin pipo wit ulcer, diabetes, hypertension fit chop and no fit chop during Ramadan

Ramadan na holy month wey Muslims all ova di world dey observe by fasting from sunrise to sunset. But if you get diabetes, high blood pressure (hypertension), or ulcer, fasting fit dey hard for you. Despite di health challenges, pipo wit dis kain condition always still dey try to fast during Ramadan. Technically, dis kain pipo dey exempted from fasting until dem get beta, even though fasting dey among di five pillars of Islam and e dey veri important to di faith. Di Qur'an tok clearly for verse 185 of chapter one Surah Al-Baqarah say pipo wey dey sick or dey on a journey during Ramadan fit make up di fast for anoda time - but wit proper planning, advice from doctor, and correct eating habits. Dr Abdulmalik Ibrahim wey dey work for Gwarzo general hospital for Kano tell BBC Pidgin say pesin fit still fast and enjoy di spiritual blessings of Ramadan even say some risk dey. Ulcer and fasting Dr Ibrahim tok say ulcers dey happun wen too much acid or one infection (H. pylori) dey wound di stomach lining. If pesin dey fast, di stomach go still dey produce acid even wen food no dey, and e fit make ulcer pain worse. Dr Ibrahim say di possible risks wit fasting wit ulcer include: Who fit fast? Who no suppose fast? Dr Sa'adatu Sulaiman wey be dietitian and also dey work for Kano State Primary Healthcare Management Board tok about food wey good and bad for pipo wit health issues. Foods wey pesin wit ulcer fit chop for Ramadan Foods wey pesin wit ulcer no fit chop for Ramadan Hypertension and fasting Hypertension (high blood pressure) fit dey affected by di food wey pesin chop, water level, and stress. Fasting fit get good or bad effect, depending on di pesin condition. Possible risks Who fit fast? Who no suppose fast? Foods wey pesin wit hypertension fit chop for Ramadan Foods wey pesin wit hypertension no fit chop for Ramadan Diabetes and fasting Diabetes na one medical condition wey mean say too much sugar dey inside blood. Fasting fit come wit some risk like hypoglycemia, hyperglycemia, dehydration, or even serious wahala like hyperosmolar hyperglycemic state or diabetic ketoacidosis for pipo wey get diabetes. Who fit fast? Bifor pesin wey get diabetes go fast, e must first tok wit doctor. Di pipo wey fit fast na: Who no suppose fast? How you fit manage diabetes during Ramadan fasting If you get diabetes, fasting fit dey tricky, but you fit manage am well: Both Dr Ibrahim and Dr Sulaiman don give advice and some guidance wey fit help pipo wit dis kain sickness wahala for Ramadan. Below na di advice wey dem give; General ddvice for safe fasting Always dey monitor: Consult your doctor Final verdict: who fit fast?

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store