logo
#

Latest news with #KenyanBlogger

Di death of Albert Ojwang for di hands of police dey unacceptable
Di death of Albert Ojwang for di hands of police dey unacceptable

BBC News

time2 days ago

  • Politics
  • BBC News

Di death of Albert Ojwang for di hands of police dey unacceptable

Kenya President Williams Ruto dey mourn di death of one 31-year-old Kenyan blogger Albert Ojwang wey die for police custody. For one statement wey di president personally issue, e say, "di tragic occurrence for di hands of di police dey heart-breaking and unacceptable." "I strongly condemn di actions and omissions, wey include any negligence or outright criminality wey fit contribute to im untimely death," President Ruto tok. Di kontri leader call on di National Police Service to fully cooperate wit di Independent Policing Oversight Authority wey dey torchlight di mata, and make dem ensure transparent, and credible investigation into di death of Oga Ojwang. Im death don spark widespread outrage for Kenya, as rights groups dey demand say make authorities hold police accountable. Police bin detain Ojwang afta one complaint by di deputy police chief, wey accuse am say e tarnish im name on social media. However, President Ruto don assure say di truth about wetin really happun to Ojwang go come out soon, and justice go dey served. E also caution di public against making "premature judgments or drawing conclusions wey fit scata di process and its outcome". Autopsy report reveal say dem beat and assault Ojwang to death On Tuesday, 10 June, Post-mortem bin reveal say dem hit di Kenyan blogger wey die for police custody for head and di cause of im death go likely be from beating. Dis report different from police claims wey say Albert Ojwang "sustain head injuries afta e hit im head against one cell wall". "Di cause of death dey very clear; head injury, neck compression and oda injuries spread all ova di body and dat dey point towards assault," state pathologist Bernard Midia tok. Police neva comment on di findings. Di autopsy, wey five pathologists carry out and dem release agreed report, reveal say Ojwang get severe head injuries and e suffer neck compression and multiple soft tissue trauma. Dr Midia, wey lead di team of pathologists, tok say Mr Ojwang no hit himself on di wall, as police bin tok for statement on Sunday. E say if Ojwang bin wunjure imsef, di pattern of injuries for dey different, and dem go see frontal bleeding on im head. "But di bleeds wey we see on di scalp… for di skin of di head no dey togeda, including on di face, sides of di head and for di back of di head," Dr Midia tok for one press conference. "Multiple soft tissue injuries also dey wey spread all ova di body, including for di head, neck, upper limbs plus di trunk and lower limbs... these na injuries from attack," e add. Di injuries dey consistent wit "external assault" and signs of struggle also dey, according to di pathologists. Timeline of wetin we know happun to Kenya blogger Albert Ojwang Friday, 6 June - Police arrest Oga Ojwang for Homa Bay, one town for western Kenya, sake of one post e make on X wey allegedly dey critical of Deputy Inspector General of Police Eliud Lagat. Saturday, 7 June - Police transfer am go di capital, Nairobi, wey dey ova 350km (220 miles) from wia dem arrest am and book am for di Central Police Station. Sunday, 8 June - Policetok say Ojwang "sustain head injuries afta e hit im head against one cell wall" while in custody. Monday, 9 June - Plenty activists bin stage protest outside one mortuary for Kenya capital, Nairobi. Plenty pipo gada hold placards and dey chant "Stop to dey kill us", di crowd bin protest outside Nairobi City mortuary, wia dem keep Ojwang body. Di crowd later march go di Central Police Station wia dem hold Ojwang at di time of im death. Tuesday, 10 June - One autopsy, wey five pathologists conduct and release unanimous report, reveal say Oga Ojwang get severe head injuries and suffer neck compression and multiple soft tissue trauma. Kenya Independent Policing Oversight Authority (IPOA) don launch inquiry into im death. IPOA don also rule out di possibility say Mr Ojwang kill himself. Di agency add say dia premilitary findings show say pesin don interfere wit di CCTV systems for di Central Police Station. How Kenya blogger die for police custody Police arrest Ojwang for Homa Bay, one town for western Kenya, on Friday, 7 June, sake of one post e put on X wey allegedly criticise di Deputy Inspector General of Police, Eliud Lagat. Dem later transfer am go Nairobi, wey dey ova over 350 km (220 miles) from wia dem arrest am and book am into Central Police Station on Saturday, 8 June. According to oga Kanja, dem arrest Mr Ojwang afta oga Lagat file one complain say e dey "tarnish" im name. "Na on dat basis dem carry out investigations," Kanja tok for one press conference. For dia response to heavy public pressure, Kanja announce say dem don take actions against senior officers for Nairobi Central Police Station. Police tok-tok pesin Michael Muchiri, tell BBC say dis one mean say di officers no go fit perform dia duties, and dem go receive half of dia salaries, pending di outcome of di investigation by IPOA. Speaking at a press conference, Inspector General Kanja tok say di police go give di investigators all "necessary support" to solve di case. Dem find Ojwang unconscious during one routine inspection of di cells and dem "rush am go hospital, wia dem pronounce am dead on arrival", police tok. 'Help me get justice for my son' - Meshack Ojwang Oga Ojwang father, Meshack Ojwang, don beg President William Ruto to help am get justice for im son. "Help me as a taxpayer. Di officers wey pick my son see say our home dey humble and assume say we no matter," di father tok. Di Digital Content Creators Association of Kenya don pay tribute to Mr Ojwang, dem say: "Albert no be just ordinary content creator - e be di voice of di youth, symbol of resilience, plus pesin wey embody di dreams and hopes of a generation wey dey use digital platforms to inspire change. Im legacy no go dey silenced." Faith Odhiambo, president of di Law Society of Kenya (LSK), tok say di autopsy report clearly show say dem "torture" and "brutally murder" Ojwang for police custody. "We go continue to put pressure until dem hold every single officer wey get hand for dis mata personally liable. We no go accept more excuses," Ms Odhiambo tok. Veteran opposition leader Raila Odinga condemn Oga Ojwang "horrifying" death, e say e don add to long list of "young and defenceless Kenyans wey dem take dia lives too soon, in brutal and senseless circumstances, for di hands of di police". Inspector-General of Police Douglas Kanja earlier suspend plenty officers wey bin dey on duty at di time of Oga Ojwang death. But human rights groups don demand more action, dem say di death of di blogger na attempt to silence di digital community through intimidation and fear. Kenya Independent Policing Oversight Authority (IPOA) don open investigation into im death

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store