28-02-2025
Di little chef Khat wey dey totori pipo wit her cooking and baking skills
Little Chef Khat na eight-years-old wey start to learn how to bake and cook wen she be two-years-old.
At dat time, she bin dey observe her mama many times for kitchen.
Khatoumi Ndebugri Isa like to bake pizza, bread, cakes and make oda local meals.
Little Chef Khat start her baking and cooking club two years ago wia she dey share her knowledge wit her friends.
She dey hope to be ogbonge Chef, doctor and model for future.
Her mama tok say she dey surprised and proud of her daughter just like evri oda mother sake of say her daughter dey do sometin positive for society.
She tok how far little chef Khat don come wit her cooking and how she dey offer tutorials and share her cooking journey and recipes for social media (Tiktok and Instagram).
Little Chef Khat don gain plenty of followers on dis platforms.
Filmed and edited by Idara Monday