Latest news with #KogiCentral


BBC News
23-05-2025
- Politics
- BBC News
Wetin be di charges goment file against Natasha Akpoti-Uduaghan
Di office of di Attorney General of di Federation don sama anoda lawsuit on top Natasha Akpoti-Uduaghan, di female lawmaker wey dey represent Kogi Central Senatorial District for di Nigeria Senate. Dis new lawsuit na sake of allegations wey Mrs Akpoti Uduaghan bin make for one TV interview on April 3, 2025, wia she tok say di Senate President Godswill Akpabio and former guvnor of Kogi State Yahaya Bello, bin dey plan to kpai her. According to di charge sheet wey our tori pesin see, di allegation say Akpoti-Uduaghan bin make comments wey she know or she suppose know say di comments go harm somebody reputation . Di offences dey contrary to section 391 of di penal code laws of di federation and also punishable under section 392 of di same law. Charges against Natasha Akpoti-Uduaghan Di three-count charges na majorly about libel, two counts against Akpabio and one count against Yahaya Bello. According to di charges, Akpoti-Uduaghan allege for di interview say Akpabio and Yahaya Bello bin meet for a hotel on March 14, 2025, wia dem emphasis say dem go kill her, but e no go be for Abuja rather e go be for her state Kogi. "Dat na one of di reason why I bin no go home on time. I bin delay to go home bicos I gatz put some measures on ground," di charge sheet quote Akpoti-Uduaghan. Also, di senator allege, according to di charge sheet, say Akpabio and Yahaya Bello bin hold three discussions day day. "Di first one na my recall, di second one na to eliminate me, and di third one na to put somebody wey go take di ticket from me if I wan contest for 2027." According to di AGF, Mrs Akpoti-Uduaghan know or she get reason to believe say "dis imputations go harm di reputation of Senator Godswill Akpabio, President of di 10th senate of di Federal Republic of Nigeria", and di reputation of Yahaya Adoza Bello, former guvnor of Kogi State. Di third allegation for di charge sheet na during a two-way phone interview wey Natasha Akpoti-Uduaghan allegedly do with one Sandra Duru for Abuja, wia di senator bin claim say Akpabio bin use di internal organs of one girl wey her name na Umoren Iniubong, for im wife who bin dey sick for three years. Akpabio, Yahaya Bello follow for witnesses Our tori pesin also see a list wey contain a total of six witnesses wey di Nigeria goment say dem go call wen di trial start. Di witnesses list include: Di last two witnesses na officers from di Inspector General of Police (IGP) Monitoring Unit of di Nigeria Police Force, and na dem be di pipo wey investigate di allegation. Wen di matter go start According to di charge sheet, di office of di AGF file di matter on May 15, 2025, but di case neva dey assigned to any judge. So no exact date don dey wen di trial go start. But remember say Natasha Akpoti-Uduaghan don already file one case bifor Justice Binta Nyako of di federal high court, sake of her suspension from di senate for six months. Di matter na against di senate president Akpabio, di Nigeria senate, di senate committee on ethics, privileges and public petitions, and chairman of di committee Neda Imasuen. Justice Nyako don fix June 27, 2025 to deliver judgment for di case. Brief background Dis gbas gbos betwin Natasha Akpoti-Uduaghan and Senate President Godswill Akpabio start for early March dis year afta dem change di sitting arrangement for some lawmakers for di senate chambers. Mrs Akpoti-Uduagha bin vex and para for Uduaghan wen she find out say dem change her own sitting position, and she no dey happy wit di new place wia dem assign to her. But senators bin explain say changing of sitting positions na normal tin wey di senate president get power to do from time to time, and e no need to inform pesin or ask pesin opinion bifor e go reassign di pesin position. Also say, according to di senate standing rule, pesin must to stay for di seat wey dem assign to am bifor di pesin go dey recognised to tok or contribute during plenary. Na dis rules dem allege say Akpoti-Uduaghan bin break, and na why di senate punish her wit six months suspension. However, Mrs Akpoti-Uduaghan later start to dey accuse Akpabio of sexual harassment, saying na bicos she refuse di advances of di senate president na why im dey persecute her. Akpabio don deny di allegation.


BBC News
01-03-2025
- Politics
- BBC News
Why Godswill Akpabio wife drag senator Natasha Akpoti-Uduaghan go court
Di wife of Nigeria Senate President Unoma Akpabio don file multiple lawsuits against di senator wey dey represent Kogi Central for di National Assembly, senator Natasha Akpoti-Uduaghan. Madam Akpabio dey accuse di senator for violation of her fundamental rights and defamation, wey come from statements wey di senator make on di floor of di senate and during one televised interview on Arise News. She also dey demand for N250 billion as damages and anoda N1 billion charges. Di legal actions wey she file bifor di Federal Capital Territory High Court for Abuja, dey come afta senator Natasha accuse di senate president Godswill Akpabio of sexual harassment during one interview wit Arise News on Friday, 28 February. For di interview, senator Nastaha bin claim say di senate president dey victimise her bicos she no gree im sexual advances. Madam Akpabio wey react to senator Natasha claims for one press conference, tok say she dey lie and just dey create contents for her personal gains, as she threaten legal actions against senator Akpoti-Uduaghan. Wetin dey di lawsuits Di suits wey BBC Pidgin see, show say Madam Akpabio file two lawsuits against senator Akpoti-Uduaghan. For di first suit on fundamental rights violation (Suit No: CV/814/25), Madam Akpabio argue say di senator statement on 2 February, and during di television interview na "flagrant violation" of her fundamental human rights as guaranteed by di Nigerian constitution plus di Charter of Human and Peoples Rights. She cite Section 34(1)(a) of di 1999 Constitution (as amended), di wife of di senate president dey seek multiple legal remedies, wey include: "A declaration say di senator remarks violate her fundamental rights and subject she and her children to emotional and psychological distress. Madam Akpabio want "N250 billion in damages for wetin she describe as exemplary, punitive, aggravated, and general damages she suffer sake of di senator statement. For a separate defamation Suit No: CV/816/25, Madam Akpabio challenge di senator claim say her husband make sexual advances towards her. She describe di allegations as false, malicious, and damaging. She add say di accusation don bring her family into disrepute and public shame. She want make di court order di defendant to issue a formal written retraction of di defamatory words plus tender unconditional apology to di claimant and her family. She go publish di apology for two nationally-read newspaper. Di senate president wife also want make di court order senator Natasha - Di court neva fix any date for di hearing of di two suits. Wetin cause di recent disagreement Di recent gbasgbos between di senate president Godswill Akpabio and senator Akpoti-Uduagan start afta di Kogi central senator discover say dem don change her seating for di Senate chamber without her knowledge. She protest di action for di floor of di house, wey cause small kasala during one plenary session. Di Senate later refer her case to di Committee on Ethics, Privileges, and Public Petitions, wey Senator Neda Imaseun from Edo South, dey lead for investigation. Di senate give di committee two weeks to submit dia report. In response, senator Akpoti-Uduaghan bin file ₦100 billion lawsuit against senate president Akpabio and im senior legislative aide, Mfon Patrick, for defamation. Her lawyer, Victor Giwa, tok say Oga Patrick publish di alleged defamation on im Facebook page wit di title, 'Is Local Content Committee of di Senate Natasha Birthright?' Di post accuse Akpoti-Uduaghan say she dey think say to be senator na all about wearing makeup and transparent outfits come di chamber. Senator Akpoti-Uduaghan lawyer describe di statement as provocative and damaging, Giwa tok say e don lower im client reputation among her colleagues and di public. On Friday, 28 February, di mata escalate wem Akpoti-Uduaghan show on Arise Television Morning Show and accuse Akpabio of sexual harassment. She bin claim for di interview she grant di televion station say some of her colleagues bin warn her to accept di seat change "bicos na part of one plot against her." Meanwhile, Akpabio wife don deny di di allegations, she describe dem as "false and baseless".