logo
#

Latest news with #Kwara

Prime suspect for di murder of Hafsat Yetunde Lawal say im no get hand for her death
Prime suspect for di murder of Hafsat Yetunde Lawal say im no get hand for her death

BBC News

time21 hours ago

  • BBC News

Prime suspect for di murder of Hafsat Yetunde Lawal say im no get hand for her death

Di ongoing trial into di death of 23-year-old Hafsat Yetunde Lawal take anoda twist wen di prime suspect Abdulraheem Bello testify for court say no be im kill her. "No be me kill Hafsot Yetunde Lawal, di police accuse me say I dey lie and dem tok say na me kill am," e tok. On Wednesday, 11 June, di trial of Abdulkareem Bello plus four odas wey dey charged wit five counts wey include murder and conspiracy bin kontinu for di Kwara State High Court. Di late Hafsot, na final-year student for Kwara State College of Education for Ilorin wen she pass away suddenly for February 2025. One BBC reporter wey dey for di trial say di main suspect, Abdulrahman, tell di court that teaching children to read and write plus oda activities na im job. We dey update dis tori

'I cut off Yetunde Lawal hand for money'
'I cut off Yetunde Lawal hand for money'

BBC News

time21-05-2025

  • BBC News

'I cut off Yetunde Lawal hand for money'

Di trial of one Abdurahman Bello and four odas wey chop accuse for di murder case of 23-year-old female students of Kwara State College of Education for Ilorin, Nigeria, bin take place today. Today for Kwara State High Court, dem bring evidence wey include two hands, a table, a machete, an axe, phones, a knife and a rubber band wey dey stained wit blood. Di case of Yetunde Lawal bin happun for February 2025, wen police say dem receive report of a case of murder and rape against against one man, wey dem identify as Abdurahman Bello. Police inspector Ayodele Azeez of di Kwara State Police Command Criminal Investigation Department tok say during investigations, dem go di house of Abdurahman Bello and dem find some items for dia. Among di items wey dem find for im house na Yetunde earrings, shoes, documents, and phone. Di Police inspector wey serve as first witness for di case tok say for dia investigation, dem take di statement of di accused wit knowledge of im lawyers, and e sign di statement. Di court admit di statement as evidence for di case. Dem presented di evidence for court today wey include audio and video footage of di accused, Abdurahman Bello. For di statement, di accused tok say e and Yetunde bin meet online and dem begin tok love and marriage matter. "Hasfot don promise me for long say she go come my house." Di accused say di day wey di incident happun, di deceased come im house and wen she dey hungry e buy food give her. Na afta di food dem come have sex and she bin faint. "Na becos say I no fit carry her deadi bodi, na im make me nury her body for grave and cut off her two hands to make money" How dis matter take start For February 2025, police for Kwara state southwest Nigeria don confam say dem arrest one 29 years old man wey allegedly kill and pieces di body of one 23-year-old female student of Kwara State College of Education, Ilorin. Tok tok pesin for di state police, SP Adetoun Ejire-Adeyemi, tell BBC News Pidgin say di name of di victim na Yetunde Lawal, say dem don begin investigation to know wetin really happun wey lead to di murder. According to di tok-tok pesin, dem first receive alert of missing pesin from di victim papa. According to dem, security personnel find di dismembered bodi of Yetunde inside bowl for di suspect house. Tori for town be say dem both meet online and begin friend till di suspect invite her over. Police say di lady bin don dey miss since 10th February. Na four days later dem find her bodi for di suspect house. Late Yetunde na di first pikin of her family. Her papa and mama still dey alive. She bin dey final year for Kwara State College of Education, Ilorin, bifor di incident happun.

Nigeria: Kwara lawmaker's energy reform bill passes first reading
Nigeria: Kwara lawmaker's energy reform bill passes first reading

Zawya

time09-05-2025

  • Business
  • Zawya

Nigeria: Kwara lawmaker's energy reform bill passes first reading

The Kwara State House of Assembly has conducted the first reading of the Kwara State Electric Power Sector Bill, 2025, aimed at energy reform in the state. The bill is sponsored by Nigeria's youngest lawmaker, Hon. Rukayat Motunrayo Shittu. The bill, which passed its first reading during the House's plenary session, seeks to repeal the Electricity Board Laws of 1992 and 2006 and establish a progressive legal framework for electricity generation and distribution in Kwara State. Speaking on the development, Hon. Shittu, who represents the Owode/Onire state constituency, stated that the bill is a response to the persistent challenges of unreliable electricity supply across the state. She explained that the proposed legislation is designed to decentralise power supply, attract private investment, and stimulate economic development. 'This bill is about creating an enabling environment for reliable power and empowering our communities through decentralised electricity networks,' Hon. Shittu said during the session. The 27-year-old lawmaker noted that the bill aligns with recent constitutional amendments empowering state governments to regulate electricity within their jurisdictions—a move that opens new opportunities for subnational innovation and energy independence. Meanwhile, members of the House have commended the initiative, describing it as a forward-thinking measure that could pave the way for independent power projects (IPPs), private sector participation, and expanded energy access for both rural and urban communities. The bill now proceeds to its second reading, where lawmakers will deliberate on its principles and implications for Kwara's future energy landscape. Copyright © 2022 Nigerian Tribune Provided by SyndiGate Media Inc. (

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store