09-02-2025
To settle my papa and Govnor Uba Sani no be my job – Bello El-Rufai
From di time wey signs begin dey show say di fight between Kaduna State Govnor, Uba Sani, and former govnor of di state, Malam Nasir El-Rufai, dey increase, El-Rufai son bin don dey tok im own on di mata.
Bello El-Rufai, di member of di House of Representatives wey dey represent Kaduna North constituency, tok for di BBC Hausa Madina Maishanu, for Mahangar Zamani program, say, im no happy wit how tins take dey between former govnor Nasir El-Rufa'i and di curent govnor of di state, Uba Sani, unto di positions wey di two men get for im life.
Misunderstandings catch fire between di former govnor and im successor less dan one year afta dem form new goment for Kaduna State.
Governor Uba Sani don first complain about di plenti debt wey di former govnor allegedly leave for am, as im say di state goment no fit even pay salaries of im workers wit di small funds dem dey receive.
Di state House of Assembly later launch one investigation into El-Rufai goment over allege irregularities from borrow-borrow and diversion of N423 billion without any proper explanation .
However, di former govnor deny all di accuse, come open one court case to challenge di state Assembly.
Bello El-Rufai tok say: "E no dey pleasant for us, even if someone na my enemy, I no like to see am dey fight anoda enemy, I want peace."
Bello bin also link di situation to how life fit change at any time, "marriages dey break up, friends stop to be friends, na just say friendships no suppose end no mata di kain of conflict dey get into."
Wetin unite dem?
Bello tok say im no really know wetin join im papa wit im former boss, and im no tink say dem dey fight each oda sake of say e never hear any of dem come out and insult di oda in front of am.
According to am, e no even know if di alleged fight dey real as pipo dey report am.
"None of dem tell me anytin about di conflict, I just realize say e dey over now."
Bello also yarn say pipo dey make di conflict worse pass wetin actually dey happun wit di mind to turn am into one major conflict.
"Pipo wan am to be like Dramendra and Amitabh Bachchan [from one Indian film] fight, and some pipo dey call to hear more about wetin bin happun."
Many pipo for long don dey wan hear from Bello about im closeness to di state governor.
For years wey don pass, Bello bin serve as im deputy and na im bin advise am to run for parliament, according to wetin im bin tell BBC.
However, opposite to Bello claim say di two no dey tok bad tin about di oda for im presence, dis week, Mallam Nasir El-Rufai bin respond strongly to Uba Sani on social media over some of di govrnor comments wey im bin no like.
Di two men, wey bin be each oda political support, don dey fight demsef since di change of goment and di tensions bin rise afta Uba Sani become govnor.
Na dat time di tok to investigate El-Rufai goment and how im administration spend money during im tenure begin rise, situation wey show signs of conflict between dem.
Di incident surprise many pipo as political observers believe say El-Rufai dey get hand for Uba Sani victory for di governorship race.
Bello say for im opinion,dis no mean anytin becos to do research no be crime, but if dem do am without any purpose, na violation of God.
"Investigation no be for anyone, but if you dey investigate for injustice or to insult pesin or sake of say pesin don wrong you, den God go punish you. God go forgive you everytin but I no go infringe on anybody rights."
Dem fit dey divided?
Wen we ask if e think say e fit reconcile dem, Bello tok clearly, "By God, no be my job, my job na to focus on helping di pipo of Kaduna North constituency."
E bin show say im want peace and say e for like am between dem.
"I like peace and to maintain trust. If pesin touch me, we go argue wit dem, but no be outside, but dis na me."
Bello finally show say possibility dey to bring back peace between di two, as im emphasize di position of di two of dem and how im dey pray for peace between dem.
"For me, no one beta pass Mallam Nasiru politically. Im bin only put im work first and na so I wan be. Na my papa, papa na papa."
"And about Govnor Uba Sani, all di pipo wey dey wait for me to say sometin about am, dem go surprise."
For many states for Nigeria, similar situation kontinu to occur, wia tension dey for relationship between former govnors and di pipo wey dem bin support to succeed dem.
One wey catch fire pass na fr Rivers State between di current govnor, Siminalayi Fubara and di current Minister of di FCT, Nyesome Wike.