logo
#

Latest news with #Meranda

Lagos Speaker Meranda resign as Obasa return to power
Lagos Speaker Meranda resign as Obasa return to power

BBC News

time03-03-2025

  • Politics
  • BBC News

Lagos Speaker Meranda resign as Obasa return to power

Di Speaker of di Lagos State House of Assembly Mojisola Meranda don resign as di removed Speaker Mudashiru Obasa return to power. Meranda wey dey represent Apapa Constituency I bin announce her resignation on Monday as lawmakers re-elect her as di Deputy Speaker of di Lagos State House of Assembly. Dis dey come following di internal crisis wey shele for di House afta majority of di lawmakers remove Obasa on 13 January. Dem remove Obasa sake of allegations of gross misconduct, poor leadership, mismanagement of funds and corruption. Di majority of di lawmakers bin elect and swear-in Madam Mojisola Meranda as di new Speaker. Earlier, di impeached Speaker bin maintain say im removal no hold water and e dey illegal as lawmakers no follow constitution to remove am, and e declare say im remain di legitimate speaker of di house. "I don resume and I still remain di Speaker of di Assembly," Oga Obasa tell tori pipo for di Assembly complex on Thursday 27 February. "Nobody remove me. Impeachment or removal na democratic and constitutional, but if you wan do am, you gatz follow due process. We get rules for dis house and house rules wey all state assemblies for di south-west dey follow, but dem no follow am," e tok. Also, for one interview wit Channels TV on Thursday, Obasa claim say madam Meranda don agree to resign as di Speaker during one peace meeting wey leaders of di party for di state arrange. "One meeting hold for Marina wia we get in attendance all di party leaders and all di members [of Lagos Assembly] and openly Meranda hersef tok say she don step down and she don resign."

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store