logo
#

Latest news with #N15

Chidinma tell court how she see Super TV CEO Usifo Ataga deadi body
Chidinma tell court how she see Super TV CEO Usifo Ataga deadi body

BBC News

time17-04-2025

  • BBC News

Chidinma tell court how she see Super TV CEO Usifo Ataga deadi body

Di court case between Chidinma Ojukwu wey be di prime suspect for di murder of Super TV CEO, Michael Usifo Ataga, still dey go on for di Lagos High Court. Di mata kontinu on Thursday as Chidinma open her defence for di case. She tell di court wey dey siddon for di Tafawa Balewa Square how she discover say Usifo Ataga don die for di Lekki Apartment. She also tok how she take see Ataga lifeless inside di short-let apartment for Lekki, Lagos. Wen she dey testify bifor Justice Yetunde Adesanya, di 23-year-old and former Mass Communication student for di University of Lagos tok about di events of 15 June 2021, di day wey dem discover say Ataga don die. Wetin Chidinma tell court Chidinma tell court say afta she comot from di apartment to go buy food and juice, she bin comeback to di apartment, knock di door but she ni get any response. She push di door open, na wen she see a disturbing scene: blood stains for floor and Ataga dey lie down motionless in a pool of blood. "I drop evritin wey I bin dey hold, I rush go meet am," she testify. "Im eye dey half-open and im pulse bin no dey." Chidinma describe her relationship wit Ataga, she say na for November 2020 e start, afta dem bin introduce am to her by one mutual friend, Fiyin wey be di girlfriend of Ataga friend, James. She say Ataga dey supportive and generous, she claim say im bin don pay her school fees and give financial support for her cosmetics business. She tell court say Ataga bin contact her on 13 June, 2021, wen im inform her say im birthday dey come and im invite her to spend time wit am bifor im scheduled trip to Abuja for a family celebration. Sake of renovations for wia im dey stay for Victoria Garden City (VGC), she say Ataga bin suggest make dem book hotel or short-let apartment for Lekki, wia im bin get business meetings. She get one apartment for 19 Adewale Street, off Ologolo Road, Lekki, wey Ataga approve. For evening dat same day, dem bin meet for di apartment, dem go out togeda go eat for Ango Villa restaurant wia dem bin buy wine, dem later go back to spend di night togeda, drinking, eating, and smoking. She also tell di court say di following day wey be 14 June, Ataga bin ask her to help am buy loud (one type of Igbo) and rohypnol. Im send her N15,000 to buy am, im later send anoda N25,000 for food. On 15 June she tok say Ataga request for di loud again, im tell her to pay for am sake of say im bin no fit do bank transfer dat time. Im bin also give her money for food and juice. Wen she comeback to di apartment wen she finish her shopping, Chidinma narrate how she bin struggle to reach Ataga becos of di food order. Wen she eventually arrive, she see say di door dey slightly open, and as she enta inside, she see im deadibody. "I bin dey in shock, I wipe di blood off myself, change my clothes, and pack my belongings," she tok Among di items wey she agree say she bin take from di apartment na brown envelope wey dey contain Ataga bank statements, im ID cards, documents wey belong to one Mary Johnson, and some pieces of jewelry. Court adjourn di matter to 28 April 2025, for continue di trial.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store