logo
#

Latest news with #NIMC

Nigeria goment increase daily feeding money of prisoners by 50%
Nigeria goment increase daily feeding money of prisoners by 50%

BBC News

time28-01-2025

  • Health
  • BBC News

Nigeria goment increase daily feeding money of prisoners by 50%

Nigeria goment don increase di feeding money of prisoners by 50% daily. Pipo wey dey Correctional (Prison) facilities for Nigeria go now dey entitled to feeding rate N1,125 per day from N750 per day. Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo tell tori pipo for Abuja wen im bin dey do review of di agencies wey dey under am. Im say "difference go dey for di food wey inmates go dey chop now". Tori about di kain food wey inmates dey chop for prison na regular topic for di kontri. Di discussion begin draw serious attention for September 2024 wen local media bin report say di Controller General of di Nigeria Correctional Service, Haliru Nababa tok say na N750 goment bin allocate to feed each inmate per day while dem dey spend N800 evriday to feed each of di 900 dogs wey dey di service. E bad sotay pipo wey wan do charity work dey carry food items dey go donate for different Correctional centres across di kontri. Wit di high inflation wey Nigeria dey experience now and as food item mostly dey go up, e still dey hard to tell if dis N1,125 feeding money daily go fit give dem beta food to chop. Oda changes for Correctional Centres For di tok-tok oga Olubunmi do wit tori pipo for Abuja, e tok say one of di tins wey Correctional centres dey lack na medical personnel, and dem dey try to fix di problem sharp -sharp. "We realize say most of our Correctional centres no get doctors and medical officers, we approach Mr president wey don give approval say make we recruit 100 nurses and 50 medical officers to improve di wellbeing and situation of inmates for di correctional centres." Oga Olubunmi add say dem get low number of medical personnel for di correctional centres sake of say many of dem don retire and from now, dem go begin post medical officers to go do dia one year national service for Correction centres. "President Bola Tinubu also give approval for di National Youth Service Corps to dey post medical officers to correctional centres, so dat inmates fit get adequate medical care. Di interior Minister add say di National Identity Management Commission (NIMC) go also capture di biometrics of inmates. Inmate too go do biometrics and data capture for NIMC and na sake of security dem wan do am. E explain say in di last one year, no external attack or jail break happun for any correctional centre. "Suleja jail break happun sake of di old walls and Maiduguri prison own happun sake of di flood." Concerning oda commissions and agencies wey dey under di Ministry of Interior, many improvements go come, especially for di National Immigration Service wia dem go do contactless expansion wey go cover oda kontris. Electronic Visa (E-Visa), Passport personalisation centre, Passport centralisation.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store