12-05-2025
Who be Sammy Gyamfi wey Ghana president dey under pressure to punish and why?
One goment official - Sammy Gyamfi dey face pressure for Ghana afta one viral video ova di weekend show how im dey count plenty dollar notes from im car wey im dash one controversial woman preacher.
Inside di video wey bin dey trend, di CEO of di gold board and di popular preacher Nana Agradaa from one event bin dey chat wen dem take pictures near di goment official im car.
Na so afta dem take di picture, she ask for money wia Sammy Gyamfi enta di car to count di dollar notes for her.
Nana Agradaa bin dey shout say make di CEO give am all di dollar notes; afta she show di moni wey im collect from Sammy Gyamfi to di cameras.
Many pipo don tok say wetin Sammy Gyamfi do dey "inappropriate" for pesin wey be goment official under President John Mahama wey tok say im no go tolerate opulence and luxury lifestyle from im appointees.
Tori be say di kontri Chief of Staff Julius Debrah don summon Sammy Gyamfi to di seat of goment to answer questions about dis mata.
Wetin dey inside di code of conduct
Only last week, di president bin launch code of conduct for im public officers wey go regulate how dem dey behave for public office.
Among oda tins, di president tok say "dis code na bold declaration of di standards we get to uphold as servants of di public."
President Mahama also tok say "all political appointees get to avoid opulence wia dem get to be accountable for di use of public funds.
"Dem for show humility and respect di citizens," di president tok during di launch of di document.
Goment officials wey no comply wit di code of conduct fit face sanctions from public apology to dismissal.
Sammy Gyamfi issue apology
Afta pipo don put pressure on top di gold board CEO, im write apology on top im social media page.
Sammy Gyamfi write say, "dis na kind gesture to fellow human being; like how I bin dey lend helping hand to di needy."
"I tink say I just dey show kindness for private, I no sabi say dis tin go enta di public space. Dis na unfortunate and regrettable tin."
Sammy Gyamfi add say, "I see how dis tin don vex party members, I dey apologise for dis unfortunate act of indiscretion."
Despite dis, pipo still tok say make di president sanction am.
Anoda reason dis tin dey vex most pipo na sake of di woman preacher (Nana Agradaa) wia Sammy Gyamfi dash di moni be controversial pesin wey bin tok say she repent from being fetish priestess to become woman of God.
Pipo and ogbonge civil society groups wan make di president take action
Na so many pipo dey tok say wetin di CEO of Gold Board Sammy Gyamfi do na wrong tin.
Di Ghana integrity initiative (GII) tok say President Mahama need to take serious action for dis mata.
Executive director Mary Adda say, "dis na opportunity for di president to show say im mean business. Im get to use dis mata to show say im dey committed to ethical governance."
Oga for di IMANI center for policy and governance Franklin Cudjoe say, "dis na difficult tin. E dey clear say di moni dey above GHc 20k ($1,500). Sammy get to answer questions to us and di president."
Members of im own party don dey tok say im no try for dis mata.
Former NDC MP for Kumbungu Ras Mubarak bin write on top im social media say "you no fit justify dis mata, as public officer dey dash forex (dollars) especially at di time di cedi don dey do well, even if im earn di money, dis fit to affect di local currency and di economy."
"Sammy Gyamfi im error of judgement fit cause lack of confidence for di cedi; such tins fit affect di value of di cedi," Ras Mubarak write.
Pipo dey wait wetin di president go do about dis mata, sake of Sammy Gyamfi na ogbonge pesin wey help di goment win election.
Sammy Gyamfi profile
Oga Sammy Gyamfi na lawyer wey be national tok-tok pesin for di national democratic congress (NDC).
During di campaign, im lead di party to fire di goment well well on top media platforms and oda places.
Im criticize di former Akufo-Addo goment say dem spend di kontri moni on lavish lifestyles and oda tins.
For di party, im na wetin sabi pipo describe as "darling boy".
Afta di party win elections, di president bin appoint am as di CEO of di gold board.
Since im become oga for di gold board, dem ban foreigners and oda pipo from trading for di local gold market for Ghana.
Di only body wey fit deal for di trading of gold na dis gold board, wey dis na to "strengthen industry laws and for national benefits."