27-01-2025
Afcon 2025 groups: Nigeria go face Tunisia, odas for Group C
Nigeria dey for Group C for di 2025 Africa Cup of Nations wey go happun for Morocco later dis year.
Nigeria Super Eagles go face Tunisia, Uganda and Tanzania.
Cameroon dey for Group F and dem go face defending champions Côte d'Ivoire, Gabon and Mozambique.
All di 24 teams (kontris) wey qualify for di biggest football tournament don know who dem go face.
Morocco go host di 2025 Afcon for di first time since 1988. Di tournament go start from 21 December 2025 to 18 January 2026.
See di full groups below.
Di Afcon 2025 Groups
Group A: Morocco, Mali, Zambia, Comoros
Group B: Egypt, South Africa, Angola, Zimbabwe
Group C: Nigeria, Tunisia, Uganda, Tanzania
Group D: Senegal, DR Congo, Benin Republic, Botswana
Group E: Algeria, Burkina Faso, Equatorial Guinea, Sudan
Group F: Cote d'Ivoire, Cameroon, Gabon, Mozambique
How CAF classify di teams
See di 24 teams wey qualify for di tournament and di pots wey dem dey ahead of di draws.
Pot 1: Morocco (hosts), Senegal, Egypt, Algeria, Nigeria, Côte d'Ivoire
Pot 2: Cameroon, Mali, Tunisia, South Africa, DR Congo, Burkina Faso
Pot 3: Gabon, Angola, Zambia, Uganda, Equatorial Guinea, Benin
Pot 4: Mozambique, Comoros, Tanzania, Sudan, Zimbabwe, Botswana
African legends Mustapha Hadji, Serge Aurier, Aliou Cisse and Joseph Yobo assist wit di draws.
Cote d'Ivoire na di defending champions as dem host di 2023 edition wey happun for early 2024.