18-03-2025
Nigeria House of Representatives pass Tinubu tax reform bills
Di House of Representatives don pass di tax reform bills wey President Bola Tinubu send to di National Assembly for October 2024.
Di bills wey di lawmakers pass on Tuesday na Nigeria Tax Bill, Nigeria Tax Administration Bill, Nigeria Revenue Service Establishment Bill, and Joint Revenue Board Establishment Bill.
Dem pass di bills afta dem read am for di third time at plenary, wey Speaker Abbas Tajudeen preside ova.
Last week, di lower chamber bin approve ogbonge amendments to di proposed legislation afta a clause-by-clause consideration of di bills, as presented by the Chairman, Committee on Finance, James Abiodun Faleke.
E dey expected say di Senate go also pass di bills, and di proposed tax reform bills go dey transmitted to President Tinubu to assent to am.
We dey update dis tori.