12-02-2025
Wizkid, Mohbad, Qing Madi and odas artistes wey make 2025 Headies nomination list
Di Headies don announce di nominees for di 2025 award, afta one year break.
Di list get names of local and international stars for di Nigeria entertainment industry.
Headies release di full list of nominees for di 17th award ceremony on 12 February for dia Twitter handle.
Di award go specially recognise di 'Rookie of di year' for dia excellence performance in di music industry in di past year.
Headies award dey happun evri year for Nigeria but e no happun for 2024 as dem postpone di event to February 2025.
Late Mohbad wey pipo sabi as Ilerioluwa Aloba bag three nominations dis year, almost two years afta im die for September 2023.
Headies neva announce wia di 17th award ceremony go hold and di official date.
Full nominations list for di 17th Headies awards
Dis na di categories wey dey Headies nomination list: Producer of di Year, Best Recording of di Year, Songwriter of di Year, Best R&B Singles, Rookie of di Year, Best Rap Single, Best Vocal Performance (female), Music Video of di Year, Best collaboration, Inspirational Singles, Lyricist on di Roll, Afrobeats Single of di Year, among odas.
NOMINEES FOR DI 17TH HEADIES ROOKIE OF DI YEAR
ZERRY DL
TAVES
KAESTYLE
LLONA
NOMINEES FOR DI 17TH HEADIES BEST INSPIRATIONAL SINGLE
GRATITUDE – ANENDLESSOCEAN
WORTHY OF MY PRAISE - DUNSIN OYEKAN FT. LAWRENCE OYOR
GOOD GOD 2 - LIMOBLAZE FT. NAOMI RAINE
PARTICULARLY - GAISE BABA FT. TOPE ALABI
YOU DO THIS ONE - MERCY CHINWO
NOMINEES FOR DI 17TH HEADIES LYRICIST ON DI ROLL
MOGADISHU - A-Q
CHOCOLATE CITY CYPHER - M.I ABAGA
CHOCOLATE CITY CYPHER – BLAQBONEZ
HALLELUJAH – LADIPOE
EFELEME - ALPHA OJINI
NOMINEES FOR DI 17TH HEADIES AFROBEATS SINGLE OF DI YEAR
BIG BIG THINGS - YOUNG JONN FT. KIZZ DANIEL AND SEYI VIBEZ
TWE TWE REMIX - KIZZ DANIEL
EGWU FEAT. MOHBAD – CHIKE
REMEMBER – ASAKE
OGECHI REMIX - HYCE, BOYPEE AND BROWN JOEL FT. DAVIDO
BIG BALLER – FLAVOR
NOMINEES FOR DI 17TH HEADIES BEST STREET-HOP ARTISTE
SEYI VIBEZ – "DIFFERENT PATTERNS"
AYO MAFF – DEALER (FT. FIREBOY DML)
SHALLIPOPI – CAST (FT. ODUMODUBLVCK)
ZHUS JDO – JOHNBULL
MOHBAD – ASK ABOUT ME