logo
#

Latest news with #Shallipoppi

Headies award 2025: Wetin to know as di ogbonge music event dey happun today
Headies award 2025: Wetin to know as di ogbonge music event dey happun today

BBC News

time27-04-2025

  • Entertainment
  • BBC News

Headies award 2025: Wetin to know as di ogbonge music event dey happun today

Di 17th edition of di Headies awards dey happun on di 27 of April, 2025. Dis na one of di top awards for Nigeria for music. Performers for di event include, Shallipoppi, Chike, Juma Jux, Yemi Alade and Qing Madi among odas. Dis go be di first in two years wey di award go happun for Nigeria afta e bin go America for two years. Di 2022 and 2023 bin hold for Atlanta, Georgia for di US. Na why dem dey call dis year edition 'Back To Base'. But di oga for di Headies, Ayo Animashaun tok say dem go do two episode dis year to arrange di award season back to normal again. Dis year award get thirty nominations categories. Di top nominees for di night na Ayra Starr and Odumodublvck wit eight nominations. Dem bin come bifor Tems and Asake wey carry six nominations and Shallipopi wey get five. Rema gbab wetin fit be im first producer nomination for im career as di producer of HEHEHE from im HEIS album wey im follow make wit Producer X, CUBEATZ, DEATZ and KLIMPERBOY. Odumodublvck wey dey part of those for di running to gbab di ogbonge 'Next Rated' tok bifor di awards say, "I belong here bicos na wia God put me. I no be guy wey dey run faster dan im shadow. I dey like take am step by step. Last year I be Rookie of di Year, dis year na next rated, maybe next year fit be artist for di year". Nominees for di 17th headies ROOKIE OF THE YEAR BEST RECORDING OF THE YEAR SONGWRITER OF THE YEAR BEST R&B SINGLE PRODUCER OF THE YEAR BEST RAP SINGLE BEST VOCAL PERFORMANCE (FEMALE) BEST VOCAL PERFORMANCE (MALE) MUSIC VIDEO OF THE YEAR BEST COLLABORATION BEST STREET-HOP ARTISTE AFROBEATS SINGLE OF THE YEAR LYRICIST ON THE ROLL BEST INSPIRATIONAL SINGLE HEADIES' VIEWERS' CHOICE BEST WEST AFRICAN ARTISTE OF THE YEAR BEST EAST AFRICAN ARTISTE OF THE YEAR BEST NORTH AFRICAN ARTISTE OF THE YEAR BEST SOUTH AFRICAN ARTISTE OF THE YEAR BEST CENTRAL AFRICAN ARTISTE OF THE YEAR INTERNATIONAL ARTISTE OF THE YEAR BEST RAP ALBUM SOUNDTRACK OF THE YEAR NEXT RATED AFROBEATS ALBUM OF THE YEAR BEST PERFORMER (LIVE) SPECIAL RECOGNITION DIGITAL ARTISTE OF THE YEAR SONG OF THE YEAR ALBUM OF THE YEAR ARTISTE OF THE YEAR

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store