10-02-2025
'I no fit poo-poo from di normal place again after my colostomy surgery sake of cancer'
"Di first time di doctor tell me say, I go dey poopoo from my stomach, e no really explain wetin e mean to me".
Na so 21-year-old Oluwasina Tobiloba Elizabeth wey be Rectal Cancer Signet Ring Adenocarcinoma survivor tell BBC Pidgin.
She share her tori for one interview wia she dey emotional, cry as she remember her journey to survive di cancer.
Dem diagnose Tobiloba wit Rectal Cancer, Adenocarcinoma for March 2022.
Di first tin her doctors bin do den na surgery. "E just tell me say I go dey pass out waste product from my stomach.
I look myself and I tok to myself say, e don over, bicos how pesin go dey poopoo from stomach?"
Tobiloba say di cancer bin bring serious stagnation, wey dey life threatening.
"E get time wey I bin wan commit suicide, I bin don buy rope. Sake of say my mates don enta school already and me I dey house. She tok as she cover her face dey cry".
During di first surgery, doctors no dey able to remove di tumour for Tobiloba bodi sake of di size.
"Di tumor big sotey, e attach imsef to plenti organ for my bodi, so e go cost me my life to penetrate."
She say doctors den bring out machine to do colostomy for her.
Colostomy na surgery to create opening for di colon (large intestine) through di belle. According to John Hopkins medecine, colostomy fit be short-term (temporary) or long-term (permanent).
Tobiloba colostomy na permanent one.
Chemotherapy and more surgery
Tobiloba bin start her Chemotherapy around April 2022 afta di first surgery. She say she bin do di first six courses but improvement no dey.
Improvement no still dey afta she do anoda six course. Dat na wen she come arrange for her third surgery for February 2024.
Dis time around, doctors bin dey able to comot di tumor during di third surgery but dem no dey able to reverse di colostomy for Tobiloba bodi.
E mean say her colostomy na permanent one,- "I go dey poopoo from my stomach for di rest of my life," di doctors seal her anus.
"Wen dem tell me say I no go dey fit defecate from my anus again, e bin dey heart breaking".
Tobiloba further explain say doctors bin don seal her anus and rectum wen dem dey do her di colostomy.
"Di nerves wey pesin dey feel say I wan poopoo, dem don remove everitin.
My daily life wit Colostomy na say, If I wake up for morning, I go poopoo, I go go toilet go comot di poopoo from di bag and seal up di bag."
She say if she no poopoo, she go fart, sake of say she dey fart through di colostomy too.
Di condition don make Tobiloba separate from pipo.- She say she no wan mingle wit pipo sake of say she no wan make pipo sabi say somtin dey her bag.
"I see say dat na di stigma wey colostomy put for my bodi."
Tobiloba say now, she don dey try mix wit pipo.
Wetin be Rectal adenocarcinoma
Rectal adenocarcinoma na di most common type of rectal cancer and na one type of colorectal cancer. E dey start form cell wey dey produce mucus of di rectum lining, according to Cancer centre.
How e dey develop
Rectal cancer dey usually begin as polyp, wey be small growth for di rectum lining.
Some polyps be adenomas, wey be pre-cancerous growths. As time dey go, adenoma fit develop into adenocarcinoma.
Symptoms
Symptoms of Rectal adenocarcinoma include:
Risk factors
Di risk factors include: