05-05-2025
Di seven Capuchin Friars wey die for Obudu ranch accident for Cross River
Seven members of Capuchin Friars of Nigerian Custody don die while six wound for one fatal motor accident wey happun on Saturday 3 May.
According to statement from St Clare and St Francis Custody, di brodas bin comot from di Ridgeway Community, Enugu State, for Obudu, Cross River State, wen di 13 brodas bin get accident.
Dem don send di six odas to Enugu for medical treatment.
"Wit deep sorrow but in di hope of di resurrection, di Capuchin Friars of Nigerian Custody announce di death of some of our brothers for tragic incident wey take place on di evening of May 3rd, 2025," di statement tok.
"Thirteen of our brodas bin comot from di Ridgeway Community, Enugu State, for Obudu, Cross Rivers State, Nigeria, but unfortunately, dem get fatal accident.
Seven of di brothers die as a result of di accident while six of dem sustain various degrees of injuries," di statement tok.
"Di injured brodas don dey transferred to Enugu for proper treatment. We entrust dia souls to di merciful love of God and invite all make dem to join us to pray for di happy repose of dia souls."
According to tori pipo Channels, tok-tok pesin to di Govnor of Cross River State, Nsa Gill for statement bin tok say di incident bin happun for Ikwette community by Obudu Ranch Resort bottom hill.
Im add say di victims na seminarians wey bin go for a tour wit bus wey belong to di Enugu Catholic Diocese.
"Na Reverend Father bin lead dem on di tour. Dem bin don finish dia tour of di ranch bifor dem meet di unfortunate incident for di bottom hill community, outside di ranch premises," im tok.
Meanwhile, di Cross River State Goment say dem dey committed to make Obudu Ranch Resort and all parts of di state safe.
"Safety na our most important priority for di Ranch Resort and beyond, and we go dey review di safety measures wey dey in place for di Ranch Resort for evri visitor," di statement tok
"We dey beg all visitors to prioritize safety, including di how dia vehicles strong reach and to follow all guidelines wen dem dey come to our beautiful attractions and also comot from di Resort."
Di govnor also tell di families wey lose dia loved ones sorry.
Di Friars wey die
Br. Somadina Ibe-Ojuludu
nwachukwu
Br. Marcel Ezenwafor
Br Gerald Nwogueze
Br. Kingsley Nwosu
Br. Wilfred Aleke
Br. Chukwudi Obueze.
Wetin be Friars?
Friar come from di Norman French word frere wey mean broda from di Latin word frater wey also mean broda.
Dem dey use am refer to pipo for di Christian community. For Catholic, e mean pipo wey dey follow di Franciscan Order of Pope Francis wey dem born for 1182.
According to di Capuchins website, di Franciscan movement bin bring many novelties for di Church.
Friars suppose live a simple life and dey dedicated to preach and serve God till dem die.
Dem dey follow di path of St Francis wey give im life as Jesus bin do: to die as a martyr wen im dey preach di Gospel.