logo
#

Latest news with #TOGO

Timeline of di wahala of Nigerian pastor wey dem deport from South Africa
Timeline of di wahala of Nigerian pastor wey dem deport from South Africa

BBC News

time19-05-2025

  • BBC News

Timeline of di wahala of Nigerian pastor wey dem deport from South Africa

Televangelist pastor Timothy Omotoso don come back to Nigeria afta dem deport am from South Africa wia di kontri Interior Ministry bin declare am undesirable pesin. Omotoso bin don spend eight days for prison for South Africa awaiting trial, sake of accuse of human trafficking, rape, and racketeering wey dem sama am. According to SABC news, Omotoso suppose land for di Lagos Internationa Airport by 8.30pm of Sunday, May 18, 2025. Di pastor na di founder of Tim Omotoso Global Outreach (TOGO), and for dia website dem say dem be "apostolic and prophetic ministry" wey dey "propagate di gospel of Jesus Christ to dis generation wit signs following". Omotoso na also di senior pastor of Jesus Dominion International (JDI) wey get three branches across South Africa. However, since 2017, di charismatic pastor don dey accused of plenty offences, including grooming and raping im church pipo, some wey dey as young as 14. Here na a timeline of Omotoso plenty wahala: April 20, 2017: South Africa Police - di Hawks - arrest Omotoso for di Port Elizabeth airport afta im flight touch down, on top accuse say e bin dey sexually molest young girls. Robert Netshiunda, di tok-tok pesin of di police bin tell SABC News say dem find am for di women toilet for di arrival section wia e bin hide. Di accuse inluce say Omotoso bin traffick more dan 30 girls and women from di three branches of im churchl, to one house for Umhlanga community in KwaZulu-Natal, wia im allegedly dey abuse dem sexually. May 2017: Court remand Omotoso for prison pending wen im trial go start. October 2018: Di trial of Omotoso and two oda pesin - Lusanda Solani and Zukiswa Sitho - start for di high court for Port Elizabeth. October 21, 2018: 22-year-old Cheryl Zondi bear witness for court and tok how Omotoso start to dey sexually abuse her from wen she dey 14. She narrate how di pastor bin force her to perform sex acts on him, and afta dat e go recite Psalm 51 wey start wit "Have mercy on me O God". Zanda also tell di court say she bin dey get death threats as she agree to testify against di pastor. One strange caller tell am say: "You dey go against a man of God and God go kill you". October 22, 2018: Omotoso lawyer, Peter Daubermann, accuse di trial judge, Justice Mandela Makaula of bias and say make e comot hand for di trial. February 6, 2019: Judge Mandela Makula finally gree to wash im hand comot for Omotoso matter. April 2 2025: Court find Omotoso not guilty and discharge im and di two oda accused pesins. Di Judge say di prosecutors bin mishandle di case. Plenty pipo for South Africa bin vex wit di judgement and some bin express dia anger on top social media. May 4, 2025: Just a month afta e regain im freedom, Omotoso and im church organise ogbonge crusade wey dem call "New Dawn", but di Mayor of Buffalo City, Princess Faku, later ban di church from using any public facility for dia event. Major event centres wia di church bin wan use also cancel dia booking. However, di seven-day crusade still go ahead, but security pipo arrest di Pastor on di sixth day. May 10, 2025: Di Home Affairs Department for South Africa arrest Omotoso again as dem bin don declare am prohibited pesin. Dem say di pastor go appear in court on Monday, 12 May 2025, on top accuse say e contravene di Immigration Act. May 18, 2025: South Africa authorities deport Pastor Timothy Omotoso to Nigeria afta dem declare am 'undesirable pesin' and ban am from entering di kontri again for five years. Who be Timothy Omotoso Dem born oga Omotoso on 14 July, 1958 Bifor e start im ministry, e bin dey play music with popular Nigerian high life musician Ebenezer Obey. E claim say God teach am how to play piano, guitar, drums and oda musical instruments wen e dey only 10 years, according to di website of Tim Omotoso Global Outreach (TOGO). Im church, Jesus Dominion International get branches for di UK, France and across South Africa, and in 2013, e launch one 24-hour Satellite TV station wey im name na Ancient of Days Broadcasting Network (ADBN). Omotoso dey married wit three children.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store