a day ago
Meet the troupe of Nigerian kids entertainers who play the xylophone
Ndito Uforo Akwa Ibom Cultural Troupe wey comprise of little children dey use dia skills of di xylophone to entertain pipo.
Dem dey make waves wit dia ogbonge talent as dem dey blend traditional xylophone sounds wit Afrobeats and oda genres of music.
Director of di cultural troupe say di idea of Utoro na to preserve di culture of Akwa Ibom and Nigeria.
E say di music don impact di children well-well. E say di children bin no get idea of how to play di instrument, but e help dem develop interest and sabi how to play am.
Di children say dem enjoy playing di xylophone, and e no dey affect dia academics, as na evening dem dey rehearse afta school.
Na Idara Monday feem and edit am