21 hours ago
UK ban South Africa tough politician Julius Malema from di kontri
United Kingdom don permanently ban South African politician Julius Malema entry into di UK.
Di UK Home Office tok say dem see di controversial politician 'non-conducive to di public good', as dem cite im support for Hamas and im past comments about white pipo for South Africa.
Dis na di second time in two months UK go deny South Africa opposition leader entry into di kontri - but dem tell BBC say dis decision dey 'valid'.
We still dey update dis tori!