logo
#

Latest news with #innocentCitizens

Many die for fresh herdsmen attack for Benue state
Many die for fresh herdsmen attack for Benue state

BBC News

time17 hours ago

  • Politics
  • BBC News

Many die for fresh herdsmen attack for Benue state

Fresh violent attack don lead to di death of many villagers for Benue State, North central Nigeria. Di attack happun for Yelwata, a Benue border town with Nasarawa state wia suspected armed herdsmen attack di pipo on Friday night. Authorities don confam di incident. Benue state Govnor Hyacinth Alia condemn di attacks and killing of innocent citizens for Yelewata say ''nobody get right to take anoda pesin life'' Officials say at least 45 pipo die during di overnight attack for central Nigeria. Eyewitnesses say na armed cattle herdsmen carry out di attack and police say dem engage di attackers for gun battle. Dem burn down many houses for di raid on Yelewata town. On Sunday youths enta street to protest di killings wey no be like say e go stop. The protesters gather for di Wurukum area of Makurdi, the state capital wit placards to demand goment protection from di herdmen. Clashes between herders and settled farmers dey common for central Nigeria. Part of di reason for di fight-fight na sake of competition ova land. ''In di spirit of peace and unity, we dey call on religious, traditional, and political leaders across di state to sensitize and guide di youths wey dey under dia influence against unlawful gatherings or confrontations wey fit go out of control''. Govnor Alia tok Two days ago, 25 pipo bin die wen gunmen attack Makurdi di state capital. Two weeks ago, gunmen bin kill 25 pipo for two attacks, also for Benue state. Govnor Alia beg citizens to use of official communication channels to report any suspicious activities and to stay informed through credible sources. ''Benue State dey committed to justice, peace, and security for all''. Govnor Alia add.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store