
Ghana don become route to move drugs and money laundering?
Dis na afta one opposition lawmaker Rev Ntim Fordjour tok for press conference on 1 April, say im get intelligence report say di two flights bin carry "illicit" substances and dem dey carry go Gran Canaria islands for Spain.
Di opposition lawmaker bin tell tori pipo say "two flights AirMed flight N823AM and Cavok Air Antonov An-12B don land for di kontri from Gran Canaria, one location wey pipo sabi for drug trafficking and money laundering."
"Intelligence wey we get don show say dis two flights bin dey carry suspected cocaine and cash," Rev Ntim Fordjour announce for dat press conference.
E tok say di opposition lawmakers dey demand "full disclosure of di tins wey dey inside di cargo of dis flights, to assure di citizens of dia airspace security."
For dat press conference, di opposition party for parliament also say dem dey worried "about di rising threat of piracy, drug trafficking and money laundering under di John Mahama goment."
President Mahama respond to di allegations
In response to di press conference, President John Mahama don order investigation into di allegation of drug trafficking and money laundering wey di opposition lawmaker raise.
For one Facebook post, president Mahama order say make investigative agencies collaborate wit di lawmaker and get di MP to provide relevant informate to torchlight di mata.
"Goment dey take all allegations seriously, na why I dey direct all relevant agencies to immediately and fully collaborate wit di lawmaker, so im go provide di informate and take di necessary action to expose any drug deals."
Di president add say "My goment go ensure zero tolerance policy for using Ghana as transit or final destination for illegal drugs."
Goment dismiss di allegations
Di Minister for Goment Communication Felix Ofosu Kwakye respond to di allegations for one broadcast.
Inside di video, di minister provide timeline of events wey show wen di two aircrafts enta Ghana and show wia dem stay for di kontri for five days.
According to oga Ofosu Kwakye, di air ambulance bin get technical wahala, and dia crew gat to rest - na why e don stop for di kontri.
Di oda aircraft fly in engineers and tyres into di kontri to fix di one wey stop for Ghana.
E also release photos wey show say dem dey fix di aircraft for di airport.
"Dis photos dey show engineers as dem dey fix damaged tyres for di landing gear of di air med aircraft for di airport - di reason why di flight bin stay for di kontri for five days."
Di minister also release one video wey show as security officials dey inspect di Cavok flight wey enta di kontri afta di air ambulance.
"Di cargo plan arrive on 12 March wit landing permit for wetin sabi pipo call technical stop. Dis na cargo plane wey dey enta di European Union market."
Di minister add say "dis plane na aircraft from Luanda - Angola wit oil drill equipment and lubricant oil wey dey for jerrycans for di EU market."
"Luanda no get certification to carry out di requirements to enta di EU market; na so di flight enta Ghana wey get di facility to scan dis items for di EU market. As di flight bin enta Ghana, im get engine blade fault and oil leakage."
Di minister explain say "anoda aircraft bin enta di kontri to evacuate di cargo from di faulty aircraft; as di plane wey get fault stay for di kontri for 13 days."
"Afta di aircraft bin dey inspected by aviation security, di narcotics control commission and di national security, dem neva find any illicit goods for dis aircraft."
Di minister don conclude say "di claims wia di opposition lawmaker bin make na false."
Di opposition party hit back at goment
Security officials already bin bust drugs for di last one month
For 8 March, di national intelligence bureau bin intercept one consignment of cocaine wey dey weight 3.3 tonnes wey dey travel from di western region to Accra.
Laboratory tests by di narcotics control commission and di standards authority bin confam say di packages na high purity cocaine between 50% to 70%.
Di street value of di cocaine wia dem tok say enta di kontri thru sea vessel, according to national security na $350m.
Police don remand di two suspects Isaac Quiacir and Kenneth Cobinnah for custody for dis mata.
In February, di national security bin raid one warehouse for sapeiman for Accra wia dem seize twelve 20-foot shipping containers wia contain boxes of counterfeit dollar and cedi notes and fake gold bars.
Di national security coordinator wey dey in charge of operations tok say dem dey pursue di kingpin for dis syndicate.
Apart from di counterfeit dollar and cedi notes, and di fake gold bars, dem also seize military uniform and boots.
In response to pressure from di opposition for goment to provide update about di cocaine bust and di oda raid for di warehouse, di national security operations director explain say dem still dey investigate di mata.
"We neva touch di tins we seize for dat raid, we dey keep dem as we dey investigate dis mata. We still dey pursue di pipo behind di warehouse wia we still dey track two oda containers wia intelligence bin show say di pipo carry dem comot di warehouse bifor di security pipo reach dia."
Oga Richard Jakpa tok say "we gat solid evidence wey dey connect di crime to one ogbonge network wey dey do plenty illegal activities for di kontri; no only a matter of time bifor we gbab dem."
Sabi pipo bin tok say make goment pursue every mata way dey relate to drugs and money laundering for di kontri.
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


Scottish Sun
an hour ago
- Scottish Sun
JD Vance arrives in Scotland weeks after President Donald Trump's visit
Security measures are in place VP TOUCHDOWN JD Vance arrives in Scotland weeks after President Donald Trump's visit Click to share on X/Twitter (Opens in new window) Click to share on Facebook (Opens in new window) VICE President JD Vance has arrived in Scotland just weeks after Donald Trump's visit. His plane - Air Force Two - has landed at Prestwick Airport as he continues his UK holiday. Sign up for Scottish Sun newsletter Sign up 6 JD Vance has arrived in Scotland Credit: PA 6 Air Force Two landed at Prestwick Airport Credit: AFP 6 He is staying in Scotland as part of his UK Holiday Credit: PA 6 A fleet of SUVs from his motorcade were waiting on the tarmac Credit: AFP 6 Plane-spotters gathered to watch the jet carrying the VP come into land Credit: Getty Another one of the iconic US planes touched town as part of his visit. Plane-spotters gathered at the airport to get a glimpse of the blue-and-white jets coming in to land. A fleet of black SUVs from the VPs motorcade were pictured waiting near the plane. Vance exited the plane and was pictured waiting by the vehicles before setting off. The White House number two is set to stay at the Carnell Estate near Kilmarnock when in Scotland. He has arrived from England where he spoke with troops at RAF Fairford in Gloucestershire. The VP also stayed at Chevening House - the official residence of Foreign Secretary David Lammy - in Kent last week. JD Vance's visit comes just weeks after President Donald Trump visited his Scottish golf courses. Mr Trump visited his Turnberry course in Ayrshire and opened a new course at Trump International Golf Links in Aberdeenshire. Cops have ramped up security around the country estate for the Vance's visit. Britain must avoid 'very dark path' of silencing free speech, warns Trump's No2 JD Vance as he meets with David Lammy Airspace restrictions have been put in place around Carnell Estate, near Kilmarnock, between 9am yesterday and midnight on Sunday. More to follow... For the latest news on this story keep checking back at The Scottish Sun. is your go to destination for the best celebrity news, football news, real-life stories, jaw-dropping pictures and must-see video. Like us on Facebook at and follow us from our main Twitter account at @TheScottishSun.

South Wales Argus
an hour ago
- South Wales Argus
Gwent Police appeal to help find missing Cwmbran man
Shaw was last seen on the morning of Wednesday 6 August in Ventnor Road, Old Cwmbran. He is described as slim, around 5ft 8in tall, with short fair hair and a half sleeve tattoo. At the time, he was wearing navy blue Crocs and black clothing. He is known to have links to the wider Torfaen area. Anyone who has seen Shaw or knows of his whereabouts is urged to contact police on 101 or send a direct message via Facebook or X, quoting log reference 2500258064. Shaw himself is also urged to get in touch with the police to confirm he is safe and well.

Western Telegraph
2 hours ago
- Western Telegraph
St Davids man accused of dealing cocaine and cannabis
Rhys Copley, 31, of Noddfa Dewi in St Davids, appeared at Llanelli Magistrates' Court charged with six offences. Copley was alleged to have been in possession of 35.63 grams of cocaine and 391 grams of cannabis in St Davids on July 28 with the intent to supply them. He was also accused of possession of criminal property, relating to £815 in alleged criminal cash on that date. For the latest crime and court news for west Wales, you can join our Facebook group here. Copley was further charged with using threatening, abusive or insulting words or behaviour and racially aggravated harassment on July 28, and assault by beating following an alleged attack on another man the following day. The case came before the court on July 30 and was sent on to Swansea Crown Court. Copley will appear to enter his pleas on August 29, and was granted bail until that date.