logo
'E disappear without a word': Women wey UN peacekeepers give belle and abandon

'E disappear without a word': Women wey UN peacekeepers give belle and abandon

BBC News16-07-2025
Despite di scorching sun and stifling air, twelve-year-old Dimitri, no be im real name, hide inside im mother modest iron-sheet home for Birere, for informal settlement in Goma, for eastern Democratic Republic of di Congo.
"E no wan face di teasing of oda children over im curly hair and lighter skin," say im mama, Kamate Bibiche, tok to di BBC bifor Goma fall to di M23 rebels in January.
"E (Dimitri) na Russian, yet fit neva live to im true heritage," she tok.
Dimitri na reminder of one painful legacy of di United Nations Organization Stabilization Mission in di Democratic Republic of Congo (MONUSCO).
Since im deployment for di end of 1999, di mission don face widespread allegations of sexual exploitation and abuse wey involve women and young girls.
Kamate hesitate bifor e pull out one dusty box wey dem hide deep under her bed.
Inside na her only reminders of Yuriy, di man she say na Dimitri father. E contain one worn military hat and one old photograph of di two of dem togeda.
Kamate bin meet Yuriy on one night out and say she become attracted to im calm persona. Di pair get three month relationship.
"'E no be like oda men. E bin love and treat me really well. E be di best three months I ever get," Kamate recall.
Yuriy, like many peacekeepers dey interact wit local communities, bin reveal little about im actual background or true credentials.
"E be UN peacekeeper," Kamate tok.
"E no say I dey pregnant and promise to take care of us. But den e disappear without one word, as if we mean nothing to am," Kamate tok.
She tok say she no get way to reach her Russian partner, as di phone number wey e dey use don dey disconnected.
Abuse of power
Although Kamate bin enta into di relationship willingly, under one United Nations resolution adopted by di general assembly in 2005, e still dey considered exploitative.
Dis policy recognises di power imbalance between UN personnel and vulnerable local populations, wey fit make any sexual relationships exploitative, even if dey appear consensual.
Di resolution dey urge member states to provide justice for victims by holding perpetrators accountable once dem send dem back to dia home kontries.
Wen ask about di whereabouts of Kamate boyfriend, MONUSCO spokesperson Ndeye Lo tell BBC Russian say dem no get contingent troops in di mission, say "only a few police officers and staff officers dey work for di headquarters".
She say di mission no fit give access to di records of specific Russian officers wey bin serve in 2012 "for legal reasons".
Di BBC bin attempt to track down Yuriy, including on Russian language social media, but no fit find am.
Serious allegations
Eastern DR Congo don experience decades of conflict as govment forces fight off rebel groups wey wan control di mineral rich region.
In January, Goma bin fall to Rwanda-backed M23 rebels. About 7,000 pipo die in di fight as di militants take over di city, according to DR Congo prime minister.
Di United Nations estimate say over eight million pipo dey currently displaced, wey make am one of di world largest internal displacement crises.
Many pipo dey struggle wit extreme poverty and lack of access to basic needs such as food, water, and shelter, dey expose women and girls particularly vulnerable to exploitation.
Wen di BBC bin tok to Maria Masika (no be her real name), she bin just arrive in Goma from di embattled town of Sake, north of di city.
Di goment soldiers bin don dey battle rebel fighters but don eventually overrun. Maria dey visibly shake - still in shock from di intense gunfire wey she bin witness.
'E bin know say I be minor'
Masika bin don travel to Goma to see her 8-year-old daughter Queen, wey dey live wit her grandmother in di city for safety.
At just 17, Masika don involve wit a South African peacekeeper wey dey stationed near di Minugugi base.
"E sabi say I be minor," she tok.
"E bin rent one house near di base and visit me whenever d dey off duty."
Afta Queen birth, di peacekeeper become unreachable, leave Masika to fend for herself.
Desperate to provide for her daughter, she tok say she now dey risk her life to make a living as sex worker in Sake.
Wen dem dey asked about relationships between UN peacekeepers and locals, di South African National Defence Force say dem take di allegations seriously.
"On-site military court sessions bin hold in di mission area where credible evidence of sexual exploitation and abuse dey, including oda disciplinary infractions," di force tok-tok pesin Siphiwe Dlamini tok.
For di Congolese Family for Joy, wey be safe house for abandoned and orphaned children, at least five children dey reported to don dey fathered by MONUSCO troops and later abandon by dia mothers.
"Wit our partners, we dey provide support to around 200 women and young girls wey don suffer sexual exploitation by MONUSCO personnel," Nelly Kyeya, di centre director tok.
"Many of dem dey face severe stigma from dia communities sake of dem settle for survival prostitution. Diis ostracization often dey drive dem to abandon dia children," she tok
Sandrine Lusamaba, di national coordinator of Sofepadi, one women's rights group in di DRC, tell di BBC say di lack of direct authority by di UN to prosecute sexual exploitation perpetrators mean say many dey waka free.
She tok say many member states no dey cooperate to prosecute dia soldiers.
One UN report wey dey released in March 2024 indicate rise in allegations of sexual abuse and exploitation wey link to dia peacekeeping and special political missions.
One hundred allegations dey reported in peacekeeping and special political missions in 2023, increase from di 79 wey dey reported in 2022. Dis incidents involve 143 victims, including115 adults and 28 children according to di United Nations.
Notably, MONUSCO - including di former United Nations Organization Mission in di Democratic Republic of di Congo (MONUC) - account for 66 of di 100 allegations, wey highlight concerns about accountability within di mission.
Zero-tolerance policy
"Wen information about possible allegations of sexual exploitation and abuse dey received, di information dey assessed and concrete action dey taken," MONUSCO tok-tok pesin Ndeye Lo tok.
"Any personnel against wey one allegation dey substantiated go dey red flagged in our system barred from further employment (civilian) or deployment (uniformed)."
Di mission say dem dey empower alleged victims and dia children through di Victim Assistance Trust Fund by providing skills training and education.
But many women and young girls like Kamate and Maria say dem no know about available support while odas remain too traumatised to seek justice.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Nigeria Wafcon: Victorious players promised $100,000 cash award and apartment
Nigeria Wafcon: Victorious players promised $100,000 cash award and apartment

BBC News

time4 hours ago

  • BBC News

Nigeria Wafcon: Victorious players promised $100,000 cash award and apartment

Nigerian President Bola Tinubu hailed the women's national football team for their victory at the 2024 Women's Africa Cup of Nations (Wafcon) at a grand celebratory reception where he promised them gifts and cash them at Aso Rock, the presidential residence, on Monday, Tinubu announced each player would get a $100,000 (£75,000) plus a three-bedroom 24-woman squad cheered when they heard the news, but there have been criticism in the past that prizes promised by Nigerian governments have not Super Falcons - as the team is known - defeated hosts Morocco 3-2 on Saturday in a stunning second-half comeback, clinching their 10th Wafcon title. Tinubu said the victory was a "triumph of courage, determination and consistency" adding that at some point "didn't want to watch the match" because of the stress."Today, you returned home as champions of Africa," he said. "We could not be prouder."On their arrival at the main airport in the capital, Abuja, the team had been welcomed by traditional dancers, drummers, journalists and government officials. They were then escorted to the presidential residence in a conferred national honours, the Officer of the Order of the Niger, to all the players and staff, saying this was "on behalf of a grateful nation".Captain Rasheedat Ajibade said that her team's victory was for "every young girl in our villages, towns and cities who dares to dream".She also outlined her vision for the Super Falcons to become the best team in the world but said this can only happen with continued support from the football federation and Super Falcons have won 10 of the 13 editions of Wafcon since it began in1998. The president described the latest win as a "milestone in the history of sport".While the players celebrated the extra gifts from the president, in the past, both the men's and women's national football teams in Nigeria have had repeated issues with the authorities over delayed payment of bonuses and government has only just honoured its three-decade promise of new homes for the victorious men's team, the Super Eagles, which won the 1994 Africa Cup of Super Falcons have several times been involved in sit-in protests during major tournaments over pay issues, including after their 2023 Women's World Cup has also been concerns over pay disparities, and in recent years, fans have called for them to be paid the same as the Supee of their final match on Saturday, Tinubu reportedly approved players' match allowances and bonuses, including backdated payments, adding that this would the standard practice in the future. You may also be interested in: What we learned from Women's Africa Cup of Nations 2024Wafcon winner will stay in my heart forever - EcheginiWatch: The Wafcon star who is also a doctor Go to for more news from the African us on Twitter @BBCAfrica, on Facebook at BBC Africa or on Instagram at bbcafrica

You fit sell your NIN?
You fit sell your NIN?

BBC News

time4 hours ago

  • BBC News

You fit sell your NIN?

Di National Identity Management Commission don comot statement afta di tori say some pipo dey sell dia National Identification Number (NIN) among oda personal information give FInTech companies. For di statement, NIMC draw ear give Nigerians say dem no get hand for anytin wey spoil bicos of dis exchange of personal informate. Dem remind kontri pipo say dem don warn dem plenti times say make dem no tell dia NIN give any unauthorized pesin or joinbodi. All dis infromate for dia statement come afta Nigeria anti-corruption body drop informate on one "fraud scheme wey na young Nigerians dey carry am for head, dey carry small money between 1500 and 2000 naira ($1.31) give dia victims wey go give dem copy of dia personal information details bifor dem come carry di same informate give some FinTech companies dem for like 5000 naira ($3.27)". NIMC say di mata na serious security concern and also get ogbonge consequences for di NIN holders. But pesin fit carry dia full Idenitiy number sell give anoda pesin just like dat? NIMC ansa dat kwesion for di statement wey di Head of Corporate Communications, Dr Kayode Adegoke share wit tori pipo. Dem tok say anytime pesin present di NIN to fit get access to services, di NIN go dey "duly verified" bifor dem go allow any pesin make e use am. Dem dey use NIN match pesin wit dia biometric data and oda details wey dey di National Identity Databases. E also dey used to: Wetin dey linked wit your NIN Accoridng to NIMC, di National Identification Number dey link to pesin biometrics wit any oda informate wey dey di national database. But e dey also linked wit oda tins. For December 2020, di Nigerian Communications Commission [NCC] announce di compulsory update of NIN to dia SIM registration to fit improve di integrity and transparency of di process for Nigeria For 1 December 2023, di CBN bin announce to all Nigerians for one statement wey dem release give all banks say any bank accounts wey no get both NIN and BVN no go fit withdraw money for dia account. Sabi pipo say na to make am easier to monitor transactions and detect fraud. Tori dey say, two years ago FCT Minister Nyesom WIke make am compulsory say any pesin wey wan register C of O for dia property must to run am wit dia NIN and BVN togeda. According to di 2017 Mandatory Use of di NIN regulations, all transactions wey involve di purchase use or transfer of land or landed properties fall inside. Di NIN also get Biometic data of pesin dat one include pesin face and fingerprint information.

Angola protests: Dozens of arrests during fuel-price-rise demonstrations
Angola protests: Dozens of arrests during fuel-price-rise demonstrations

BBC News

time5 hours ago

  • BBC News

Angola protests: Dozens of arrests during fuel-price-rise demonstrations

What began as a three-day strike by taxi drivers in Luanda against rising petrol prices has escalated into one of the most widespread and disruptive waves of protest Angola has seen in recent of people joined demonstrations in the Angolan capital on Monday that saw roads blocked, shops looted and clashes between demonstrators and police."The fuel price issue is just the last straw that has reignited widespread public discontent... People are fed up. Hunger is rife, and the poor are becoming miserable," a prominent local activist, Laura Macedo, told the have arrested more than 100 people and condemned "acts of urban terror" including the destruction of 20 buses. One local newspaper said least three people had been killed in the protests, including a police officer, but there has been no official confirmation of any strike was called by taxi operators in response to the government's decision to raise the price of diesel by over 33%, a measure introduced in early July as part of plans to remove fuel subsidies in the oil-rich only has this resulted in higher fares for urban Angolans who rely on the taxis, but it has also driven up the price of staple foods and other basics - as suppliers who transport those goods by road are passing on their additional costs to President João Lourenço has dismissed such concerns, saying that protesters are using petrol prices as a pretext to undermine the government. "Even after the increase, the price of diesel in Angola remains around 40 US cents [per litre], and there are not many countries in the world with prices this low," he told CNN Portugal in a recent average monthly wage in Angola is just 70,000 kwanzas ($75; £56), and a promise by the presidency to increase this to 100,000 kwanzas has not frustrations spilled over on Monday, groups of protesters took to the streets in various parts of Luanda, chanting against fuel price increases, nearly five decades of rule by the governing MPLA party and expressing their frustration with the country's current state of affairs. State-run media in Angola came under heavy criticism on social media for continuing with its regular programming and failing to cover the Monday evening, the MPLA warned young people not to join the protests and said that these "acts of vandalism are deliberately intended to tarnish and hinder the joyful celebration" of Angola's 50th anniversary of authorities in Luanda on Monday also issued a public statement expressing "deep concern" over the events, which they described as "disturbances and acts of vandalism associated with the forced halting of taxi services".According to the statement, the strike originally announced by taxi organisations had been called off following negotiations with authorities. However, it said, "groups of unidentified individuals, without any legitimate representation of the taxi sector, resumed the call for strike actions, promoting intimidation and violence, including attacks on vehicles circulating on public roads, even those not providing taxi services". Much of these protests have been spontaneous in nature, and it is not yet clear whether they will continue in coming of Tuesday morning, major shops, banks and other businesses closed their doors. Some civil servants have returned to work, but many people who work for private companies have stayed at home on the advice of their employers. More BBC stories on Angola: Largest pink diamond in 300 years found in AngolaRediscovering the African roots of Brazil's martial art capoeiraEx-Trafigura boss convicted of bribery in landmark caseIsabel dos Santos hits out over UK's 'dirty money' sanctions Go to for more news from the African us on Twitter @BBCAfrica, on Facebook at BBC Africa or on Instagram at bbcafrica

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store