
'I hide behind tree to escape di bandits wen my bullet finish'
Di attack kill two soldiers and two vigilantes.
Some bandits also die for di incident.
Pipo wey dey live for di area dey live in fear, say anoda attack fit hapun again.
One source from di village tok say di attack happun for di early hours of Tuesday morning, as di security team dey follow up tori wey dem hear say pipo sight gunmen for di area.
One of di vigilantes wey survive di ambush, Dauda Sallamu, don narrate to BBC News Pidgin how di mata hapun.
E say di incident hapun around 10:00am on Tuesday.
Sallamu tok say di bandits wey do di ambush na around 21 in number, while dem wey be security team no pass 11.
"We receive report for our camp say dem don see bandits for di area dat morning" Sallamu tok.
"From our camp, we quickly mobilise seven vigilantes wit four soldiers go wia dem see di bandits.
But we no know say di attackers don hide and lay ambush for us. Dem open fire, kill two soldiers and two of our vigilantes" im tok.
E also tok say dem burn three of dia motorcycles and carry di uniforms of di soldiers wey dem kill.
"Afta dem kill di two soldiers, dem remove dia uniforms and burn our three motorcycles. I even escape by luck afta I hide behind one tree wen my bullets finish." Sallamu yan.
But e add say dem later return wit reinforcement to carry dia colleagues bodies and dem realise say dem kill six of di bandits during di encounter.
"Wen we come back wit support, we see bodies of six of di bandits. But dem don spoil dia faces make pipo no fit recognize dem."
One traditional leader from di area, Abdullahi Yakubu, also confirm to BBC News Pidgin say di ambush really happun for di area. E also tok say pipo for di community dey live in fear and tension.
"We hear say bandits dey plan attack Dogon Ruwa, so soldiers and vigilantes quickly mobilise.
But dem no know say di bandits don lay ambush, dem open fire and kill two soldiers and two vigilantes" Yakubu tok.
Di traditional leader also tok say di attack don cause fear and tension for di area.
"As we dey tok now, di attack don cause serious fear for here. But dem don bring more soldiers come and tins dey try return to normal."
E still beg govment make dem do more to bring lasting peace to di area.
As of di time of writing dis report, spokesperson of Operation Safe Haven, Major Samson Zhakom, never reply to SMS wey our tori pesin send to am about di mata.
Communities for Wase and oda local govment areas for Plateau State don dey suffer attacks from bandits, wey don lead to killings and destruction of property.

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


The Independent
2 hours ago
- The Independent
Queen Elizabeth ‘snubbed airport terminal opening after relative stopped from taking guns on plane', royal cousin claims
Queen Elizabeth II allegedly refused to open an airport terminal after her cousin was stopped from bringing his guns onto a plane. Appearing on the Gyles Brandreth's Rosebud podcast on Tuesday (19 August), Lord Ivar Mountbatten said the late monarch became "irritated" when he told her that staff at Bristol Airport stopped him from bringing his shotguns for security reasons. Lord Ivar had been travelling to the Scottish Highlands for a weekend shooting with the monarch. When he arrived with no guns, the late Queen turned to equerry Simon Brailsford and told him to 'see to it' that the weapons were delivered. She then allegedly told her cousin: 'They want me to open their new terminal. I don't think I will now.' In 2015, Princess Anne opened the new terminal extension at Bristol Airport.


The Independent
5 hours ago
- The Independent
Gunmen kill at least 13 people in a mosque shooting in northwestern Nigeria
Gunmen attacked a mosque in northwestern Nigeria on Tuesday morning, killing at least 13 people during morning prayers, local authorities said. No one immediately claimed responsibility for the attack in the town of Unguwan Mantau, in the state of Katsina, but such attacks are common in Nigeria's northwestern and north-central regions where local herders and farmers often clash over limited access to land and water. The attacks have killed and injured scores — last month, an attack in north-central Nigeria killed 150 people. The prolonged conflict has become deadlier in recent years, with authorities and analysts warning that more herdsmen are taking up arms. The state's commissioner, Nasir Mu'azu, said the army and police have deployed in the area of Unguwan Mantau to prevent further attacks, adding that gunmen often hide among the crops out in farms during the rainy season to carry out assaults on communities. He added that the mosque attack was likely in retaliation for an action Unguwan Mantau townspeople who over the weekend ambushed and killed several of the gunmen in the area. Dozens of armed groups take also advantage of the limited security presence in Nigeria's mineral-rich regions, carrying out attacks on villages and along major roads. The farmers accuse the herders, mostly of Fulani origin, of grazing their livestock on their farms and destroying their produce. The herders insist that the lands are grazing routes that were first backed by law in 1965, five years after the country gained its independence. Separately from the conflict between farming and herding communities, Nigeria is battling to contain an insurgency against Boko Haram in the northeast, where some 35,000 civilians have been killed and more than 2 million displaced, according to the United Nations.


BBC News
6 hours ago
- BBC News
Resident tok how bandits kill plenti worshippers for Katsina mosque, beg govment for help
Bandits don attack mosque for Unguwan Mantau community, Malumfashi Local Govment Area for Katsina State, northern Nigeria, and kill plenti worshippers and injure odas. According to one resident wey follow BBC News Pidgin tok, na 25 worshippers di bandits kill and na five pipo dem injure. Di eyewitness wey no want make we mention im name say di attack happun around 6am for morning afta pipo finish dia Fijr prayer. "Around 5:45am, di gunmen meet pipo for mosque afta dem finish Fijr prayer, dem just open fire on dem. "Na immediately 25 pipo die, and more dan five odas injure, dem dey receive treatment for Katsina hospital now," e tok. E add say wen di attack dey happun, dem no get any help from security pipo. "Na afta di gunmen finish to kill pipo bifor security officers come. Dem snap picture and within two hours, dem don waka comot," e tok. E add say since afta di attack, pipo dey live for fear, and some don run comot from di community to save dia lives. "As I dey tok to you now, all my family no dey house again, dem don run comot for di community, pipo wey remain no plenti," e add. Di resident beg di state govment and security pipo make dem help bring peace for dia community. We dey update dis tori