logo
Fubara meeting wit Tinubu na sign say peace don dey near for Rivers politics?

Fubara meeting wit Tinubu na sign say peace don dey near for Rivers politics?

BBC News04-06-2025
President Bola Ahmed Tinubu meeting wit suspended Governor of Rivers State for im Lagos residence dey fuel speculations say di State of emergency declared for Rivers State and suspension of di fit dey lifted soon?
Dis meeting wey hold bypass di Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, for di political tok-tok, wey dey fuel speculations wey dey make many pipo dey feel say di suspended governor fit dey reinstated soon.
Di meeting, wey hold behind closed doors for di President private Bourdillon residence for Ikoyi, Lagos, mark di second known meeting between Tinubu and Fubara in recent times.
Di first meeting na a four-hour meeting wey happun for London. E hold while di President bin dey recover from medical treatment in Germany.
One tin wey dey noticeable from both meetings na di absence of Nyesom Wike, di political godfather and critic of Fubara, wey don also admit say e bin no dey aware of di President plan to declare a state of emergency for di State wey happen on 28 March 2025, more than two months ago.
Wike later confam for one media chat say e no bin dey consulted bifor di suspension of democratic institutions in Rivers State.
Di imposition of emergency rule for Rivers State, wey President Tinubu announce after prolonged political unrest, lead to suspension of all elected institutions and di appointment of Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas (rtd) as sole administrator—a move wey don draw sharp criticisms from civil society groups, legal scholars, and opposition politicians.
'Handshake no mean anytin until di State of emergency dey lifted' - Ann Kio Briggs'
One of such pesins wey don criticise dis imposition of di State of emergency and a elder for Rivers State na Ann Kio Briggs, a notable Niger Delta rights activist.
She tell BBC Pidgin say a handshake between Governor Fubara and President fit mean a lot of tins but until di State of emergency dey lifted and democratic rules reinstated for di State, e no make sense.
Ann Kio Briggs say di State of emergency for Rivers still no dey acceptable and wen she see di picture of di handshake between Fubara and Tinubu, e still no remove di reality of di impact of di state of emergency on di State and di pipo.
"No be about a handshake wit di President but na about weda di President understand wetin dey go on for Rivers State.
Na about di President listening to di pipo of Rivers State and more critically, na about wetin Governor Siminialayi Fubara dey prepared to do for di pipo of Rivers State and to realise say just becos pesin dey prepared to do somtin no mean say dat na di best tin for di pipo, if di pipo no agree wit am.
Foto dem wey di presidency release afta di meeting show Tinubu and Fubara dey smile, a gesture wey many pipo feel say fit signal say negotiations dey progress behind di scenes.
'Na good sign for Rivers State' - Henry Ekine
For Henry Ekine wey be lawyer and di National legal adviser, Committee for Human Rights, say di handshake between Fubara and Tinubu na good signal as govnor Fubara wey still be di elected govnor of Rivers State get right to visit and interact with di President.
E tell BBC Pidgin say e dey okay to speculate say such visit fit give an indication of a possible truce and lifting of di suspension on di Governor.
Ekine say Section 305 of di Constitution wey President Tinubu rely on to declare di State of emergency na to di effect say di State of emergency fit dey lifted at any time, even a day after di proclamation. So e no mean say e must complete di six months wey bin dey declared bifor di emergency fit dey lifted.
"E dey possible say about three months into di State of emergency di President fit exercise dat discretion or power again to even lift di State of emergency, but e dey important to note say di President fit lift a part of dat State of emergency e declare.
"Di possibility dey say di President fit lift di suspension of di Governor of Rivers State and di House of Assembly while di State of emergency go continue until di six months end.
"I bin don tok bifor say di State of emergency fit dey declared without suspending di governor or di House of Assembly. So e mean say di governor fit dey called back to office and di State of emergency continue for di remaining three months.
"Seeing di President and di govnor of Rivers State in dat very cordial posture for di picture na clear indication say peace fit dey very close, especially as di Governor sef don tok say discussions dey go on. Dat na di best for Rivers State." E tok.
Any end in sight?
Meanwhile, Vice Admiral Ibas Rtd still dey kontinu to act as usual, wey dey raise concerns say di emergency rule fit dey extended or institutionalized.
On Tuesday, e announce di appointment of 11 new permanent secretaries for Rivers State, wey e swear in on wednesday and dis action dey further deepen fears say di interim arrangement fit become permanent.
Despite public silence from both di presidency and di governor media teams regarding di meetings, political observers note say di timing, wey dey come just few days to Democracy Day, dey suggest a calculated effort to restore normalcy while managing di internal gbege within di PDP and di broader political implications for 2027.
Wetin Wike don tok so far?
For media chat on Monday, Wike say e no get any personal grudge against Fubara but insist say di govnor go align imself wit individuals e describe as "enemies of di State," wey include former PDP National Chairman Prince Uche Secondus, former Transportation Minister Dr. Abiye Sekibo, and former lawmakers Austin Opara, Lee Maeba, and Celestine Omehia—eey hin be former allies but now don turn rival.
Wike tok and contradictions don further shake di political waters for Rivers becos as e dey call for loyalty to President Tinubu leadership, e also dey lament say e dey sidelined from critical decisions regarding im home state.
Wetin Governor Fubara don tok so far?
Meanwhile, Governor Fubara dey mainly silent since all dis tins dey happun.
Wen e handover of state affairs to di sole administrator, Fubara urge im supporters to remain calm and avoid divisive actions.
During Late Pa Edwin Clark night of tributes, e lambast some of di pipo wey dey protest about di State of emergency and criticise to dey careful with wetin dem dey tok and to ask am weda eem don check with am to see if e gree with dem?
E say im spirit don comot for Goment House but e still dey committed to di peace process and to work in di best interest of di State but say e for good if pipo no use dia actions and toks to spoil di peace process Wey dey ongoing.
For im Democracy Day massage on 29 May, e praise Tinubu for intervening in di political crisis and tell di pipo of di State to keep hope alive.
As June 12 dey approach, all eyes dey on di presidency to see weda President Tinubu go lift di emergency rule and restore democratic governance in Rivers - or e go kontinu to play di long game for di political gameboard?
Na wetim di pipo dey wait to see.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

PDP react to reports say dem dey eye ex-president Goodluck Jonathan as dia 2027 candidate
PDP react to reports say dem dey eye ex-president Goodluck Jonathan as dia 2027 candidate

BBC News

time2 hours ago

  • BBC News

PDP react to reports say dem dey eye ex-president Goodluck Jonathan as dia 2027 candidate

Nigeria former president Goodluck Jonathan don dey mouth of pipo wey dey look weda di opposition party, Peoples Democratic Party (PDP), dey consider am ahead of 2027 election. Dis na afta different social media posts and comments dey mention Goodluck Jonathan name say e dey look to put head for di next election. Oga Jonathan wey be di president of Nigeria between 2010 and 2015 bifor Muhammadu Buhari defeat am for 2015 election wia e concede even bifor Inec announce di election result, na one big name for Nigeria political scene. Meanwhile, as di tok about 2027 election don dey spread for different political parties, eyes dey for who go be candidate for di leading opposition party, PDP, afta one coalition wen dem name African Democratic Congress (ADC) bin form dia party national committee. For August 2025, one verified Instagram account wit di handle @goodluck_ebelejonathan bin post one foto wey get di face of former President Jonathan. Di handle come add di caption "2027, we shall overcome bad luck and bring good luck." Dis post make Jonathan followers dey ask weda e dey consider to run for 2027. Den di handle reply for comment say "If I dey contest to be president, I no need to make promises, you sabi wetin I dey capable of." From dia, different social media posts begin dey attach di name of Oga Jonathan to 2027 election, say di PDP wey be im party dey look dat direction. But di rumour say di former Nigeria president dey eye 2027 candidacy under PDP na true? Jonathan dey contest for 2027? BBC News Pidgin reach out to di PDP to hear from dia side wetin di rumour of di former president Jonathan be for di party. Di party say dem neva hear or see dat kain rumour as wetin di party dey focus on now na how to elect dia national leaders. National Publicity Secretary of PDP, Hon. Debo Ologunagba tok say di party get dia process and if dat kain information dey say pesin dey wey dem dey consider ahead of 2027 election, dem go let di public know through di 'normal way'. We ask am if e don see di social media tok say PDP dey consider Oga Jonathan for 2027, Ologunagba say e dey hear dat for di first time, and if dat kain tin dey, e go follow di correct process. "Since you say na rumour, you no fit confam dat, Our party get way, we get our process and if dose information dey available we go push am out for di normal way. I dey hear dat for di first time," Ologunagba tok. PDP National Publicity Secretary say di party go follow due process and also follow dia constitution if any tin, but now dem dey focused on how dem go elect new party leaders. "If new development go dey, dis party go follow due process. We be party of order and process, we no be party of rumours, we get our constitution, we get our process and we get rules and guidelines. We get convention to elect national leaders of di party." Ologunagba add: "Na rumour and we no dey rely on rumour, I no even dey aware, e go remain for di realm of rumour. For clarity sake, we dey focused on di agenda of di party wey be di election of new leaders for di party. E go dey wrong to say I debunk am, I no dey aware, we get process." Goodluck Jonathan still dey PDP? Meanwhile, Oga Jonathan party make am clear say e neva comot from di party as dem no receive any letter of resignation from am. Ologunagba for im tok wit BBC News Pidgin for phone tok say di former president no go hide am if e no be member of PDP again. "Membership of di party na voluntary and if anybodi go comot di party, e get process to follow." "By resignation, Ebele Goodluck Jonathan neva indicate say im no be member of di party, as to my knowledge. E dey clear, if e no be member of di party again, e go tok am." According to wetin e know, former president Goodluck Jonathan neva comot from di party, but rumour say di party dey consider am for 2027 election no be true. Meanwhile, for December 2020, former leader Jonathan say im political opponents bin judge am wrongly bifor di 2015 election wey affect im election success under di PDP. E tok dat one for di presentation of book title " Dear President Goodluck Jonathan- wey Bonaventure Melah write your honor am. And since afta di 2015 election, Goodluck Jonathan don move on to hold different global positions, including mediator for West African regional bloc, ECOWAS. Bifor now, for 2021, rumour fly up and down say Oga Jonathan wan join di ruling All Progressives Congress (APC) but di PDP sharply debunk am say e no drop any resignation letter to comot di party. Goodluck Jonathan and im political career Dem born Goodluck Jonathan for November 20, 1957 for Otuoke Ogbia Local government area of Bayelsa state to di family of Lawrence Ebele Jonathan, canoe- maker and Eunice Ayi Ebele Jonathan, retired farmer. E attend St. Stephen's Primary School, Otuoke; St Michael's Primary School, Oloibiri and Mater Dei High School, lmiringi Ogbia. Jonathan later attend University of Port Harcourt, Rivers state wia e receive Bachelor of Science degree, Master's degree and Doctorate in Hydrobiology and Fisheries Biology. GEJ Political career Goodluck Jonathan political career start wen e become di Deputy Govnor of Bayelsa state to di den govnor Late Diepreye Alaimeyeseigha for 1999. Sake of some Political matter, dem swear Jonathan in as Govnor of Bayelsa state for December, 2005. Two years afta, during di governorship campaign for 2007 di Peoples Democratic Party [PDP] select GEJ as di Vice presidential candidate of Umaru Musa Yar'Adua. For 2010, Jonathan become Nigeria president afta Yar'Adua sake of bad health. Former President Jonathan for 2011 contest for presidency and e win. Im hold di office till 2015 wen im lose to late President Muhammadu Buhari. Today former President Goodluck Ebele Jonathan don become peace ambassador sake of how e take concede defeat to im opponent, di late President Buhari.

Breakdown of 2025 Waec results and why e be di worst in five years
Breakdown of 2025 Waec results and why e be di worst in five years

BBC News

time6 hours ago

  • BBC News

Breakdown of 2025 Waec results and why e be di worst in five years

Di West African Examination Council (Waec) on Monday 4 August release di results of di 2025 West African Senior School Certificate Examination. But in comparison to previous results, dis na di worst results in five years, local tori pipo Daily Trust report. "Di West African Examinations Council dey pleased to inform candidates wey sit WASSCE for School Candidates, 2025 say di result don officially dey released today, Monday, August 4, 2025," Waec write for X. How many candidates sit for di exam and wetin be di performance? Na 1,973,365 candidates bin register for di examination from 23,554 recognised secondary schools for Nigeria, but na 1,969,313 candidates bin sit for am, according to Waec. Out of dis number, na 976,787 candidates be males, while 992,526 be females. Male candidates represent 49.60 per cent while female candidates represent 50.40 per cent. Candidates wey obtain credit and above for minimum of five subjects including English Language and Maths na 754,545, and dis one representing 38.32 per cent. Di Head of Nigeria's Office (HNO) of WAEC, Amos Dangut, tok say dis year results record 33.8 per cent decrease in performance compared to 72.12 per cent recorded wey dey for 2024. E yarn dis one wen im announce di release of di results for one media briefing wey happun for Waec headquarters for Lagos. Issue of malpractice Amos Dangut say Waec don withhold results of 192,089 candidates sake of different reported cases of examination mago-mago. Dis number represent 9.75 per cent of di total number of candidates wey sit for di examination. According to Dangut, di figure represent a 2.17 per cent decline if you compare am to di 11.92 per cent wey dem bin record for di 2024 edition of di same examination. Candidates performance from five years ago According to Daily Trust, for 2020, na 1,003,668 candidates, representing 65.24 per cent out of 1,601,047 wey sit for di exams, obtain credits and above for minimum of five subjects, including English Language and Mathematics, according to Waec. Improvement dey for 2021 as di examination board record improvement of 81.7 per cent pass rate, wey translate to translating to 16 per cent. E reduce to 76.36 per cent for 2022, and dis one represent more dan 5 per cent decline in performance. For 2023, di examination body bin record 79.81 per cent pass rate including dose wey make English and Mathematics papers. Di pass rate bin reduce to 72.12 for 2024. Wetin be di cause of dis performance? Nigerian educationist Harmony Mark-Ewa wey follow BBC News Pidgin tok say according to her research, di reason na say di partnership between di home and di school low. "Very low communication gap dey between di home and di school towards di attainment of di child education," Mark-Ewa tell BBC. She say parents fit no dey follow up wit di discipline wey teachers dey give students for school, and e fit also be di oda way round. We dey update dis tori

How El Salvador's crackdown on crime - from gangs to petty offences - and mega prisons transformed the country... and prompted US to declare it safer than Britain
How El Salvador's crackdown on crime - from gangs to petty offences - and mega prisons transformed the country... and prompted US to declare it safer than Britain

Daily Mail​

time9 hours ago

  • Daily Mail​

How El Salvador's crackdown on crime - from gangs to petty offences - and mega prisons transformed the country... and prompted US to declare it safer than Britain

El Salvador was once one of the most dangerous countries in the world, but today its murder rate has dropped by 98 per cent in a decade, and the US now considers it safer to visit than Britain or France. In 2015, there were 6,656 murders in the small Central American country, which has a population of just 6.4 million. But in 2024, there were only 114 killings. The dramatic change came after President Nayib Bukele, who brands himself as the 'world's coolest dictator', launched an aggressive crackdown on crime. In 2022, he declared a state of emergency, which remains in place. It gave security forces the power to arrest people without a warrant. At one point, around 1,000 people a day were being detained on suspicion of gang involvement. A year later, El Salvador opened a new prison called the Terrorism Confinement Centre - Cecot - to hold the growing number of detainees. It was built in a remote area and is now one of the most extreme prisons in the world. Inmates are banned from all contact with the outside world, and up to 100 men share a single cell. They sleep on bare concrete slabs with no mattresses, and food is limited. There are no visitors, and prisoners are often transferred in chains, surrounded by armed guards. Inmates are confined to their cells and are only allowed out for exercise in the prison's corridors or video link hearings. El Salvador now has the highest prison population per capita in the world, with nearly three per cent of all men in the country behind bars. US president Donald Trump has hailed Bukele's policies, and the two have become close allies. Before the crackdown, the country was dominated by two main gangs, MS-13 and Mara 18, which formed in California during the 1980s. Many members were deported back to El Salvador in the 1990s and took control of large parts of the country. Gangs extorted money from businesses, controlled entire neighbourhoods, and carried out brutal killings. But that has changed since the leader's rise. He campaigned on the promise to make the country safe, and his supporters say he has delivered. Criminal gangs are not the only ones in his crosshairs. He introduced tougher penalties for petty crimes - anyone caught drink driving, even with a trace of alcohol, can be jailed for 15 days before facing a fast-track trial and up to five years in prison. He has also surrounded entire towns with soldiers, doubled the size of the military, and expanded surveillance powers. Checkpoints with troops carrying rifles have been set up, and cops go door to door in search of suspected criminals. The tactic, which Bukele calls a 'security fence,' has been used in dozens of operations since 2022. Bukele has also pushed legal reforms allowing judges to try dozens of suspects at once. Evidence can include anonymous tips or online posts. In February 2025, Bukele signed a law which ordered children held for organised crimes to be sent to adult prisons. According to Human Rights Watch, over 3,000 minors have been detained with little or no evidence. The government has also introduced a national informant hotline, offering cash rewards to citizens who report suspected gang members. Posters and text messages encourage neighbours and even relatives to turn people in. Critics say this has led to false accusations and revenge reports. However, Bukele says the crackdown is 'an example for other countries … that we can live in peace'. Aside from his war on crime, he has launched policies like making his country the first nation to declare Bitcoin legal tender and has improved the country's infrastructure. Last year, he was re-elected with 85 per cent of the vote in a controversial election. His main opposition got less than 7 per cent. In a recent move, Congress abolished the limit on presidential terms, allowing him to stay in power for life if re-elected. Opposition congresswoman Marcela Villatoro said, 'Democracy died today,' after the reforms were passed by 57 votes to three. Bukele's supporters argue that the results speak for themselves and say locals and tourists now walk the streets safely at night, even in areas that were once no-go zones. But his huge transformations have not come at a cost. He has been heavily criticised by human rights advocates who say he has committed many atrocities, especially when it comes to detainees. In 2022, Amnesty International said: 'Under the current state of emergency, the Salvadoran authorities have committed massive human rights violations, including thousands of arbitrary detentions and violations of due process, as well as torture and ill-treatment.'

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store