
Regrets, executions, coups and a love story: Four takeaways from former Nigerian military ruler IBB book
Di book - A Journey In Service dey make Nigerians tok and reflect on wetin for happun if tins turn out differently - especially di controversial decision to annul di 1993 elections, and di execution of im childhood friend.
Babangida get mixed record. While some praise am for di infrastructural development Nigeria wey im do, odas say massive corruption bin dey during im time.
Dis na four takeaways from di book:
Di 1993 elections annulment
Dis na di biggest talking-point as e touch one topic wey many believe say change Nigeria history. Some say di kontri still neva really recover from di annulment of di 1993 presidential elections.
For di book, Babangida, now 83, for di first time express deep regret for cancelling dat election.
Di poll bin suppose bring an end to military rule afta 10 years and di cancellation of di outcome throw di kontri into katakata.
Di date of di vote na – 12 June - now e dey remembered for Nigeria as Democracy Day.
E force Gen Babangida to resign.
Moshood Abiola, wey many pipo believe say na im win di election, later go prison and dem assassinate im wife.
Nigeria current President, Bola Tinubu, say Gen Babangida book launch show courage to admit wetin bin happun .
"Dat accident of history na di most regrettable. Di nation dey entitled to expect my expression of regret," Babangida write.
Gen Babangida, popularly known as IBB, acknowledge say Abiola, wey die for 1998, bin win di election.
However, for 1993 as dem bin dem gada di results, di military goment stop di process – dat action cause widespread protests and political crisis.
At dat time, dem bin cite di issue of vote-buying, as well as di need to protect di kontri judiciary as reasons for di annulment.
Abiola son Jamiu say di acknowledgment by Gen Babangida say im father bin win di election come as welcome surprise to am and some of im family members.
"Perhaps General Babangida dey look for peace," im tell BBC Focus on Africa podcast.
Eventually dem restore civilian rule for 1999, 11 months afta di death of anoda military ruler Sani Abacha.
Execution of a childhood friend
General Mamman Vatsa and Babangida bin grow up togeda, dem bin dey di same class for school and dem rise alongside each oda for military. Im execution for 1986 afta im chop conviction of one coup plot na anoda major talking-point of Babangida presidency.
"We be very close friends," Babangida recall.
"We bin grow up togeda for Minna and we be classmates for Bida. We do several tins together as peers. My wife remember say we bin dey share a room as bachelors. We go reach out for whatever shirt bin dey available, irrespective of who get am, and just wear am and go out! We bin dey very close."
However, im say na now im realise say Vatsa bin dey jealous am since wey dem be teenagers.
"Wit di benefit of hindsight now, I remember one constant part of our relationship as teenagers and young men na a continuous peer jealousy on im part towards me. Im bin always dey envious of my achievements, especially wen I tink say I dey progress pass am, either for school or our military career path."
Dem execute Vatsa and nine odas for March 1986. Sake of planned coup, wey according to Babangida go put di kontri into darkness.
"I bin get to choose between saving a friend life and di nation future," im write.
Nigeria first coup
Anoda serious issue na di1966 coup wey overthrew Nigeria first goment afta independence from UK. Dem kill Prime Minister Abubakar Tafawa Balewa, along wit oda high-ranking national and regional leaders.
Di fact say most of di coup plotters bin come from south-eastern Nigeria mean say di coup come dey known as an "Igbo coup" - na label wey Babangida reject.
Im highlight di role of Major John Obienu, an ethnic Igbo officer, wey play a key role in ending di coup, e reveal say many senior Igbo officers also die for di mutiny.
Di book also shed light on the involvement of members of oda ethnic groups, notably Yorubas, many of whom im say bin participate for di military takeover.
Di former leader confam di original intention of di coup plotters na to release politician Obafemi Awolowo from detention and install am as president.
Babangida write: "Na one terrible time for di Nigerian military. As I don tok am bifor, as a young officer wey see all of dis from a distance, probably, ethnic sentiments no drive di original objective of di coup plotters.
"For instance, di head of di plotters, Major Kaduna Nzeogwu, na only 'Igbo' dey im name. Dem born and raise am for Kaduna, im immigrant parents bin come from Okpanam wey today many know as Delta State, wey, for 1966, na di old mid-western region. Nzeogwu bin speak Hausa well-well and dey like any 'Hausa' pesin! im and im original team bin probably think, even if naively, say dem fit turn tins around to make di kontri better.
Di association of Igbos wit di coup bin lead to attacks on members of dat community around di kontri and ultimately to di civil war wia Igbo leaders bin try to secede from Nigeria in 1967. At least one million pipo die in for wetin go become di Biafran war.
Di love story wit Maryam Babangida
Many Nigerians see Babangida wife Maryam as di kontri most iconic and influential First Lady. From 1985 to wen im leave office for 1993, dia love story totori a lot of pipo. She die for 2009 and di ex-head of state no remarry.
"She bin fine well-well. Her ebony beauty, her set off enchanting eyes, and her dazzling smile dey show her lovely set of teeth; wen she smile – and wen she smile – her face go come out well-well, and her eyes dey dance," Im write.
"Two of us see see our marriage as our freedom and we agree to sort tins out ourselves if we quarrel. We bin dey very compatible; I fit only remember two occasions wey we quarrel, and neither of us bin dey afraid to apologise to each other. In all our years of marriage, e no ever dey necessary for anyone to mediate between us over a misunderstanding becos of diat original meeting of minds."
"I never imagine say Maryam go die bifor me, but di gift of life dey Allah hands, no be for human being. I dey grateful for Maryam life and di fruit of our union. Coping without her no dey easy, but e dey much less demanding by di memories of our life togeda and di length of her shadow," Babangida tok.
Im describe Maryam as a devoted wife, mother, homemaker, and passionate advocate for rural women. Above all, im see her as a true partner.

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


BBC News
3 days ago
- BBC News
Candidates react afta WAEC reopen portal for WASCCE 2025 results
Di West African Examinations Council (WAEC) don announce say di results portal for di 2025 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) results wey dem withdraw sake of technical glitch don dey open again. According to WAEC candidates fit recheck dia results to see wetin dem get. Di exam body bin announce say dem dey investigate technical issues inside di recently released 2025 WASSCE results. So dem bin temporarily deny access for candidates to check di 2025 result for dia portal. However, WAEC don tok sorry for dia action and beg Nigerians for di mistake wey dem do for di results mata. "Di result portal don dey open again, candidates fit access am now, check and recheck dia results for di WASSCE (SC), 2025." "Once again, we truly dey sorry for di wahala and appreciate your understanding and support," WAEC tok for dia post for Friday night on X. Wetin don change? Afta di announcement of WAEC say dem don reopen di result portal, candidates don begin dey login to check wetin don change for dia results. Some of di candidates say dia results still dey show dia former grade score, while some say dia own result score don change, afta WAEC do di review. One candidate post wit screenshot say e own result dashboard dey show 'error' message. For di screenshot wey e post, di 'error' message say "results no dey available for dis candidate for di specified year and exams diet". Anoda candidate wey reply to WAEC post for X, say im own 'error' message dey show say e don use im result checker card pass di normal time. E post im error message wey read, "di card usage don pass di maximum wey dey allowed. Abeg buy anoda card". Several oda candidates also comment say dia result checker card dey show say dem don reach limit wen be say na only one time dem don use am. Meanwhile, some oda candidates wey chook mouth inside di result review mata say some of dia results don change. One candidate lament say her English Language result neva change wia she add say na dat result dey hold her back from admission. She say she no fit go for admission screening sake of di 'D7' wey she get for her English Language, and upon dat, her card don expire join. "Noting don dey rectified, my English still dey D7, my card don expire too. Please dem don invite me for screening to study nursing now my English na di only tin wey dey hold me back. I no fit go for di screening wit dis D7," she write for X. While dis problem no be one sided issue, WAEC expect make dia candidate dey 'check and recheck' dia result portal to see di review wey dem do ontop di results. Also, some Nigerians don sama knock give WAEC say dat kain issue no suppose hapun as dem get enough time to work on di results. Why WAEC review 2025 WASSCE results Di national examination body for one statement on dia X account tok say during one internal review, one internal post result release procedure reveal some technical bugs for di results. Waec bin say sake of di review, dem don decide to urgently review and correct di technical glitches wey lead to di situation, as a result, access to di WASSCE (SC) 2025 results don dey temporarily denied on di result checker portal. Dem say make pipo wey don check dia result before, make dem go back afta 24 hours to re-check. Di council say as part of efforts to check examination malpractice, dem bin embark on one innovation (paper serialization) wey di national examination body bin already deploy. Dem carry out di paper serialization in Mathematics, English Language, Biology and Economics, but one internal post result release procedure bin reveal some technical bugs for di results. Di national examination body say sake of dat, dem bin get to shut down di result checker portal and try resolve di mata wit "transparency and urgency" within di next 24 hours. How WAEC candidates perform for WASSCE 2025 Na on Monday, 4 August, Waec release di results of di 2025 West African Senior School Certificate Examination. But in comparison to previous results, dis na di worst results in five years. Di Head of Nigeria's Office (HNO) of Waec, Amos Dangut, bin tok say dis year result record 33.8 per cent decrease in performance compared to 72.12 per cent wey dem record for 2024. "Out of di total number of candidates wey sit for di examination for Nigeria, 1,517,517 candidates, wey represent 77.06 per cent, get dia results fully processed and released while 451,796 candidates, wey represent 22.94 per cent, get one or more of dia subjects still under processing sake of some issues to dey resolved," e tok. Amos Dangut say Waec don withhold results of 192,089 candidates sake of different reported cases of examination mago-mago. Dis number represent 9.75 per cent of di total number of candidates wey sit for di examination. According to Dangut, di figure represent 2.17 per cent decline if you compare wit di 11.92 per cent wey dem bin record for di 2024 edition of di same examination.


BBC News
25-07-2025
- BBC News
Goment perfect plans to bring back Nigerians wey dey trapped on forced labour for CAR
Di Nigeria goment don begin moves to bring back a group of Nigerians wey dey stranded for Central African Republic (CAR) afta dia SOS video bin go viral on social media. A statement by di tok-tok pesin of di Nigerians in Diaspora Commission (NidCom) Abdur-Rahman Balogun, on Thursday say dem don contact di Nigeria Embassy for CAR to take up di issue. For di viral video, di men claim say na one Chinese company bin recruit dem wit promise say work dey for dem for CAR, but wen dem arrive di kontri, dem first chop arrest and detention for four months bifor security pipo later release dem. "Now, we don work here for six months, dem no pay us anytin. We arrive hia September last year, and delay us for four months for di capital city, dem arrest us, and wen we later come out dem bring us hia for dis bush," di man wey be like di tok-tok pesin for di group tok for di video. E say wia dem dey na one village wey di name na Senye, for di Bambari region of CAR. Bambari na di second largest city for CAR afta di capital Bangui, and for years armed groups bin dey control di area until just about a year ago wen troops from di United Nations Multidimensional Integrated Stabilization Mission in di Central African Republic (MINUSCA) declare di region free of militias. MINUSCA still dey do peacekeeping work for CAR till date as di kontri still dey struggle wit armed conflicts, especially for mining communities. Di men for di viral video tok say na mining work dem dey for dat village of Senye wia dem dey, but di Nigerian agent for di Chinese company wey carry dem come CAR, don abandon dem run bak to Nigeria. Anoda man wey be citizen of CAR don seize all dia passports so dem no go fit go back. "Even some of us dey ready to transport diasef back to Nigeria, but without our passports, security pipo go arrest us and na straight to prison," dem tok. 'We don secure dia passport bak' - Nigeria goment For di statement wey e release late Thursday, di Nidcom oga Abdur-Rahman Balogun say di commission don establish contact wit di Nigerian men and also retrieve dia passports. "Plans dey on to send a bus wey go carry dem to di embassy for Bangui wey be at least eight hour drive. Di agent in question don also dey identified," di statement tok. Nidcom also thank di Nigeria embassy for CAR for dia "swift action" for di matter. Dis no be di first time dis kind SOS video dey go viral from Nigerians wey dey trapped for forced labour and even prostitution for kontris around di world including African kontris. In July 2024, Nidcom facilitate di return of about 58 young girls wey dia video bin go viral say dem dey trapped for Ghana wia dia captors force dem to dey do prostitution. Dem later return eight more girls from Ghana for September and anoda 13 girls for November of 2024. For April dis year, Nidcom oga kpatakpata Abike Dabiri-Erewa, tok say di commission don recover more dan 200 victims of trafficking for 2025 alone, according to di News Agency of Nigeria (NAN). More dan 50 million pipo for di world dey live for modern day slavery, according to di Global Commission on Modern Slavery and Human Trafficking, one international initiative wey di head na former British Prime Minister Theresa May. Wit more dan 1.6 million of Nigeria citizens as victims of modern day slavery and human trafficking, di kontri na di fifth African kontri wit di highest number, according to di commission latest report. Di top five kontris for Africa wit di highest vulnerability to modern slavery for Africa Eritrea, Mauritania, South Sudan, di DRC and Nigeria. Modern day slavery na di removal of somebody freedom to accept or refuse a job, dia freedom to leave one employer for anoda, or dia freedom to decide if, wen, and who to marry, in order to exploit dem for personal or financial gain, according to Walk Free, one international human rights group wey dey fight against modern day slavery. E include forced labour, forced marriage, debt bondage, forced commercial sexual exploitation, human trafficking, slavery-like practices, and di sale and exploitation of children.


BBC News
21-07-2025
- BBC News
Fake documents, oda tins wey fit lead to life ban from di United States
Di United States Mission for Nigeria don drop anoda update for Nigerians and oda pipo wey dey try enta dia kontri or already dey dia. Dem say dia interagency efforts dey combat fraud and go end illegal immigration. For one statement for dia social media handle, U.S. tok say dem go ban anybody wey commit visa fraud from di United States for life. Dis statement na di latest development for di United States clamp down on illegal migration. "A nation without borders no be nation", di U.S. further tok. Wit promise say dem go pursue criminal charges against those wey engage in visa fraud and those wey dey bring in and harbour illegal aliens. Exactly one week ago, di United States bin send one strong reminder give foreigners wey dey plan or already dey di kontri say make dem no overstay dia visa or di time wey immigration give dem to stay. U.S. Embassy tok say anybodi wey stay pass di allowed time wey dem give am for America fit face serious wahala. Recently, di United States Mission for Nigeria bin don announce say dem go sweep changes to dia non-immigrant visa policy for Nigeria, wey reduce di duration and conditions under which most Nigerian travellers go fit enta America. Documents wey fit count as fake for U.S. visa application To commit Fraud or lie fit cause serious wahala for U.S. immigration matter wey include visa denials, deportation, and lifetime bans from entering di U.S. Immigration officials dey take lies seriously, and even small misstatements fit lead to serious penalties. Dis na list of tins wey fit attract legal consequences for immigration proccess. Under U.S. immigration law, fraud and misrepresentation na wen pesin provide false informate or withhold important details so e go fit get immigration benefit. One section of di U.S. immigration policy tok say any foreign national wey "by fraud or willfully misrepresent a material fact seeks to procure (or dey try to procure or don procure) visa, oda documentation, or admission into di United States or oda benefit" dey permanently inadmissible. Anoda section tok say anypesin wey make false claim to be U.S. citizen for any immigration benefit or oda purposes fit also lead to permanent ban. Examples According to di U.S. mission Nigeria statement, dis kain tins wey we list above fit cause key penalties wey include: Permanent Ban: Wetin dis one mean be say pesin wey di U.S. sama permanent ban no fit obtain visa, green card, or enta di U.S. unless America grant am waiver. Visa and Green Card Denials: U.S. Citizenship and Immigration Services (USCIS) and di Department of State (DOS) dey review applications for fraud. If dem detect any kind fraud, di application go dey denied. Removal (Deportation) Any pesin U.S. and is found to have committed fraud or misrepresentation, fit dey placed for deportation proceedings. Criminal Charges For some cases, immigration fraud fit lead to criminal prosecution wey cover fraudulent immigration documents. Convictions fit result in fines and imprisonment.