
'We no go remain silent, Justice must prevail' - Support for Comfort Bob inside Ibom Air incident increase as NBA chook mouth
Di NBA President Afam Osigwe, SAN, wey make dis demand for one statement e issue on Tuesday 12 August, tok say di decision to impose lifetime ban on Ms Emmanson without fair opportunity to hear her own side of di tori dey illegal.
"Ibom Air so far don only present dia own version of events without giving her di chance to respond. Dis one-sided process, wey add to di ban by di AON, go against di fundamental principle of fair hearing and e render di decision legally and morally indefensible."
Di president for di NBA for di statement tok say di power to suspend or restrict any passenger right to fly rest wit di appropriate statutory regulator, no be private associations or airline operators wey dey act alone.
Di NBA reaction dey come afta one video show how airport securities take comot Ms Emmanson from one Ibom Airline flight on Sunday, 10 August after dem accuse her of unruly behaviour for di flight and for di airport.
Di video show as dem take drag her out of di airplane for way, wey di NBA and some Nigerians find offensive and against her human right.
Ibom Air and di Airline Operators of Nigeria (AON) bin impose life time ban on her. Police also charge her to court on five count charges wey include assault.
Currently, she dey remanded for Kirikiri maximum correctional centre for Lagos state as she dey seek to perfect her bail..
NBA wey strongly condemn di way di airline authorities take treat Ms Emmanson plus di sanctions wey dem sama her say make di airline issue public apology to her and cooperate fully wit impartial investigation into di incident.
Dem add say dem ready to provide her wit pro bono legal support to ensure say her rights dey protected and she get redress for di violations she suffer.
"E dey deeply disturbing say dem forcefully remove Ms. Emmanson from di aircraft, dem strip her of her clothing for public, and subject her to humiliation wey dem feem and spread online."
Di statement add say no pesin regardless of di circumstances, suppose dey treated in such a dehumanising manner.
"We no go remain silent while di fundamental rights of any Nigerian dey trampled upon, whether by public authorities, private corporations, or individuals. Respect for human dignity and di rule of law must never be compromised, and for dis mata, justice must prevail." NBA tok for statement.
NBA highlights laws wey dem break for di incident
Ibom Air and di Airline Operators of Nigeria (AON) no get right to impose lifetime flight ban on Ms Emmerson, as di tori na one sided and dem neva hear from di passenger, and dat breach di fundamental principle of fair hearing and e render di decision legally and morally indefensible.
Sake of dat, di association say make appropriate authorities carry out independent and impartial investigation bifor dem take any disciplinary action against di passenger.
Also, di photographing, dissemination, and online circulation of indecent images of Ms. Emmanson na big invasion of privacy and na criminal act.
NBA argue say dem suppose blur or edit di videos wey expose her nudity to di public.
Dem say authorities must identify and prosecute those wey dey responsible for capturing and distributing di unedited footage.
"Such acts destroy public trust and undermine di rights of all citizens to be treated wit dignity and respect," NBA add.
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


BBC News
an hour ago
- BBC News
BBC defends Africa Eye documentary on Kenya's child-sex trade after 'hoax' claims
The BBC has defended its investigation into child sexual exploitation in Kenya, after the government described it as a "hoax".Speaking in parliament on Wednesday, Interior Mini, Kipchumba Murkomen, described the documentary as "fake because the people who were interviewed were not underage".Mr Murkomen added that the victims interviewed by BBC Africa Eye were "posing as children".The BBC says the documentary was clear that those interviewed were adults recounting "experiences of abuse that occurred when they were underage". The broadcaster added that the Africa Eye investigation was "an important piece of public interest journalism".Mr Murkomen also alleged that the BBC had promised "financial reward" to contributors. The statement from the broadcaster stressed that the victims were offered no financial incentive to share their story."For clarity, none of the contributors featured in this film were paid, offered payment or 'coached' in any way."The statement added that the BBC had handed over evidence from the investigation to Kenyan police in March this year. The BBC followed up on numerous occasions to ensure children at risk would be protected. Footage of two women exposed was shown to authorities in were told by the police that action would be taken, particularly to rescue Mr Murkomen's speech in parliament, he defended the Kenyan government's record on protecting children, saying it took cases of trafficking of minors "seriously".There was also criticism from the Speaker of the National Assembly Moses Wetang'ula, who said the aim of the documentary was to "besmirch" Kenya. The BBC investigation, which was published on 4 August and has so far received more than one million views on YouTube, details cases of underage girls as young as 13 who were being trafficked for sex in the transit town of Maai Mahiu in Kenya's Rift Valley. Two different women were shown admitting to knowingly and illegally trafficking underage girls for BBC's footage caught a woman, who calls herself Nyambura, laughing as she says: "They're still children, so it's easy to manipulate them by just handing them sweets."Prostitution is a cash crop in Maai Mahiu; the truckers basically fuel it. And that's how we benefit. It's been normalised in Maai Mahiu," the woman explained, adding that she had one girl as young as 13, who had already been "working" for six film identified the perpetrators of the crimes against children as well as victims who were in need of urgent the documentary, the Office of the Director of Public Prosecutions told the Directorate of Criminal Investigations to investigate the BBC noted with concern that the survivors of the abuse who contributed to the film were interviewed at length by investigators from the Kenya Directorate of Criminal Investigations without legal BBC confirmed that none of the survivors interviewed were involved in the undercover investigation two women exposed have not been apprehended. Mr Murkomen said they had not been found. More from BBC Africa Eye: Caught in the crossfire - the victims of Cape Town's gang warfare'They aimed to kill' - BBC identifies security forces who shot Kenya anti-tax protesters'Terrible things happened' - inside TB Joshua's church of horrors Go to for more news from the African us on Twitter @BBCAfrica, on Facebook at BBC Africa or on Instagram at bbcafrica


BBC News
3 hours ago
- BBC News
'How we handle helicopter crash and deadi body of victims' - Ghana Chief of defence staff tok ahead of State burial
As Ghana prepare to hold ogbonge state funeral for di eight victims of di 6 August military helicopter crash, di kontri chief of defence staff don dey speak for di first time since di tragic accident. Di funeral go happun on di morning of 15 August for di independence square for di capital Accra wia authorities dey expect thousands of mourners. Deputy chief of staff for di presidency Stanislav Dogboe tok for one presser say "make pipo join us mourn in solemnity; we neva want any chaos and unauthorized movement for di funeral grounds." "Na only accredited pipo go get access to di inner perimeter all di way to di military cemetery. Di police go dey on standby to assist to direct traffic for di independence square area." Since di deadly crash, foreign heads of state and oda dignitaries dey send condolence message to di pipo and President of Ghana. President of Sierra Leone and Ecowas chair Julius Maada Bio and di president of Sao Tomè Carlos Vila Nova already don visit di kontri to mourn wit President John Mahama, wey dem lay wreaths for di fallen eight. Heads of di missions for di kontri, state institutions, political party leaders and members of di public don also pay floral tribute to di victims, when di president declare three days of national mourning. Di military helicopter bin dey carry ogbonge govment officials to launch one event against illegal mining for Obuasi for di Ashanti region, crash into one forest wey all di occupants burn beyond recognition. Di eight victims include two cabinet ministers - di defence minister Dr Edward Omane Boamah, di environment minister - Dr Ibrahim Murtala Mohammed as well as di deputy national security coordinator Dr Muniru Limuna. Di oda victims na Dr Samuel Sarpong wey be di first vice chairman of di govment party di National Democratic congress (NDC) and Samuel Aboagye wey be di deputy national disaster management organisation director (Nadmo). Three crew members on top di military helicopter also perish - Squadron leader Peter Bafemi Anala, Flying Officer Twum Ampadu and Sergeant Ernest Addo Mensah. Sake of di bodies of di victims bin burn beyond recognition for di crash site, govment bin carry dia samples to South Africa for forensic & DNA analysis to identify dem. Afta di kontri receive electronic results for two of di victims wey be Muslims (Dr Ibrahim Murtala and Alhaji Muniru Limuna), dem bin organize Islamic prayers wey dem bury dem for di military cemetery on 10 August 2025. Ahead of di state funeral for all di crash victims, sabi pipo bin bash di armed forces ova di way dem bin handle di whole accident. Some pipo also bin sama di local authorities wey don lead di search and rescue effort for dat day including how dem handle di bodies of di victims. Sabi pipo say di military bin respond late to di scene of di incident wey bin involve dia boss di defence minister and dia three oda service colleagues wey be di crew on top di Z-9 helicopter dat day. 'How we respond to di crash' - Chief of defence staff Many pipo also bin criticize di disaster scene officials say dem bin use jute sack to carry di bodies of di victims from di forest to di standby ambulance for di foot of di forest. But for one press conference di chief of defence staff, Lieutenant General William Agyapong explain wetin happun on dat day. Im tok say di military bin respond to di accident quickly contrary to wetin many pipo bin dey tok say di soldiers delay bifor dem arrive on di scene. "Dis na di fastest recovery exercise wey involve helicopter crash for dis kontri; di last time helicopter don crash for di Atiwa forest, we bin take three days to reach di accident scene." Im explain say "for dis latest case, when we bin suspect say sometin happun to di helicopter, e take us additional 30 minutes to apply di known protocols to find di aircraft." "If aircraft don lose communication, e neva mean say e don crash, e fit mean say e dey fly very low out of radar, or sake of poor weather or mechanical wahala." Lt. Gen. Agyapong explain say "we bin activate rescue effort afta we realize say we still no dey find di aircraft for di radar, we later change am from rescue to recovery efforts afta we bin gather information from di residents for di village." "Di closest military post at di time na di team wey bin go di helipad for Obuasi to receive di dignitaries wey bin dey go for di illegal mining event; na so we deploy dem to di scene, wey e don take time for dem to reach dia," di CDS add. Im further explained say "by di time soldiers bin reach dia, di locals for di scene already begin to interfere wit di crime scene. Our oda team from Kumasi bin reach di scene on time - wey be about 800ft above sea level." "For di site, our personnel don do whatever dem fit do dat day, wey we bin do di recovery wit di available material at di time for dat thick forest." Di CDS confam say di officers on ground togeda wit health workers and local authorities bin carry body bags to di crash site for di victims. "Even though we carry some body bags, di remains of di victims bin dey hot as some still dey burn; so e neva dey fit to put dem inside di rubber body bags. Lt. Gen. William Agyapong conclude say "di accident site na thick forest, night begin to dey fall, na so we make decision to use di jute sacks from di local farmers to carry di bodies from di forest. We gat di option to leave di bodies for dia and return di next day, but we sabi wetin fit happun to dis bodies if we leave dem dia." "Na so di team on top di mountain inside di forest decide to use di available material to start to descend di hill wit di bodies wey dem meet di medical team for di foot of di hill." Di head of di military tok journalists say afta dem move di bodies from di forest, dem now put dem inside body bags wey dem transport dem inside three standby ambulances. "We now transfer di bodies to Kumasi wey we put dem inside caskets; we bin drape dis caskets wit di Ghana flags to befit dia status as patriots of di kontri, wey we move dem to Accra." Di CDS admit say "some mistakes fit happun for dis process but our men bin respond fast fast to di situation. From di crash to Accra, e dey possible say some tins happun wey no gree wit our culture but I gat to tok am say di pipo on di ground bin access di situation wey dem do dia best wit wetin dey available at di time." Investigations on di crash don start President John Mahama confam say di investigation board of inquiry bin dey chook eye into di mata. Im assure say "we don find flight data and oda information wey go assist di investigations." Di Chief of Defence staff also tok am say di armed forces almost finish wit preliminary investigation into di case. "At dis moment, we don dey keep di anti-crash recorder wey we don dey wait for di manufacturers to decode am." "If e don dey necessary to update una wit any further information, we go share am wit di public." Wetin happun since di tragedy President Mahama don hint say govment go create fund for di families for di gallant citizens wey don die for dis crash. Some of dem bin get young children na so dis fund go cater for dem from now till dem finish education. Sabi pipo also tok say dis na di time di govment gat to take serious action against illegal mining wey be di mata we don carry di eight pipo go dia death. Di office of di presidential envoy for interfaith and ecumenical relations also don ask pastors and men of God to submit dia prophesies about top govment officials and di presidency, to di office for action. Dis na afta viral videos don comot on top social media say some prophets and men of God bin prophesy about di plan crash. Oga Elvis Afriyie Ankrah explain say "many of di prophets and pastors bin complain say dem neva dey get access to ogbonge govment officials wey dem dey get prophesies about dem." "Sake of di lack of access, sometimes dem neva fit dey connect to dis pipo to share di prophesies and give dem direction to prevent disaster," oga Afriyie Ankrah explain. Na so im release statement to invite pastors and prophets to submit any prophesies about govment officials and di presidency to im office. "We don dey inform all prophets and spiritual leaders say make una relay your prophesies or spiritual insight of national nature to di office for di presidential envoy for urgent review and appropriate escalation." Di statement add say "dis prophesies and insights na those wey get implications for high profile govment officials and political leaders, national security and public stability." Di govment explain say "dis na in di spirit of responsibility, discernment and stewardship ova di destiny of di kontri." Since di crash, di armed forces bin organize vigil for di Takoradi air force base and di Ghana armed forces camp for Accra to honour di fallen heroes. Pipo bin tok say make govment create monument to honour dem, odas also bin tok say di greatest tribute for dem na to stop illegal mining (galamsey) once and for all. Di Friday state funeral go attract pipo from across di kontri wey di planning committee, di police and di military bin tok say na solemn event, so dem neva want any controversy and drama. Di president dey expected to make some ogbonge announcements for di funeral; e dey likely asy dem go promote di service crew members wey die for dis crash as dem bin die in line of duty.


BBC News
7 hours ago
- BBC News
Video wey show wetin pastor dey do small children draw police attention
Police don arrest one pastor for Rivers state, Southern Nigeria in top allegations say e dehumanise minors. Dem also rescue small pikin dem wey dey endure beating for one Church for Eneka area of di State. Dis arrest dey come afta one distressing online video wey spread online on Wednesday. Di video show di pastor hold palm fronds, den use am dey wipe di naked children. Wit three oda adults for di video, di children be like dem dey sing or chant sometin as di pastor dey waka around dem. E no clear wen di incident happun but police say na spiritual mata bin dey go on from dia investigation. Di accused pastor or di church neva comment on di arrest of dia leader. For statement by Police tok tok pesin, SP Grace Iringe-Koko say preliminary investigations reveal say di 41 year old Pastor allegedly organize three-day program for children for im church for "spiritual cleansing," wey e claim say bin dey inspired by di Holy Spirit. "Upon receiving dis information, operatives from di Rivers State Police Command through coordinated intelligence, arrest di pastor and several Church members for di scene." Di children bin kneel down naked while di pastor dey flog dem and even dey throw some of di smaller toddlers to anoda church members afta e flog dem for di "cleaning". Na neighbours for a nearby building wey video how di incident dey take place for several days raise alert of wetin dey happun inside di church compound. Di police say a thorough investigation currently dey go on to reveal wetin really lead to dat incident. Commissioner of Police, Rivers State, CP Olugbenga Adepoju say dem dey committed to ensure di safety and well-being of all citizens, particularly vulnerable populations such as small children.